BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | ISAIAH 58-62
‘Preach About the Year of Jehovah Favor’
‘The year of Jehovah favor’ no be ordinary year
61:1, 2
Na the time wey Jehovah give people chance to choose whether dem go serve am or dem no go serve am
For apostle time, the year of Jehovah favor start when Jesus begin dey preach for 29 C.E and e end for 70 C.E when dem destroy Jerusalem
For our time, the year of Jehovah favor start for 1914, when Jehovah make Jesus King for heaven and e go end for great tribulation
Jehovah bless im people with “big trees of righteousness”
61:3, 4
Tall tall tree dey grow together for inside bush and dem dey support each other
Their plenty root go enter ground well well, tie each other so that heavy breez no go fit fall dem
Big big tree dey protect the small small ones wey dey grow dey come, and all the leave wey fall from the big big tree, dey turn to manure for the small small ones
The “big trees of righteousness” for this our time na the anointed. Dem dey support and protect Jehovah organization and everybody wey dey the organization, dey gain well well from dem