May 22-28
JEREMIAH 44-48
Song 70 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“No Dey ‘Put Mind for Big Big Things’”: (10 min.)
Jer 45:2, 3—The big big things wey Baruch dey think about no make am happy for God work wey e dey do (jr 104-105 ¶4-6)
Jer 45:4, 5a—Jehovah use cool mind correct Baruch (jr 103 ¶2)
Jer 45:5b—Baruch stop to dey put mind for big big things, na im make Jehovah save am (w16.07 8 ¶6)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
Jer 48:13—Wetin make this Bible verse talk sey Moab people go dey shame for their god wey be Chemosh? (it-1 430)
Jer 48:42—Why e be sey wetin Jehovah talk for this Bible verse fit make our faith strong more more? (it-2 422 ¶2)
Wetin you learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Which other better thing you don see from the place wey we read for Bible this week?
Bible Reading: (No pass 4 min.) Jer 47:1-7
MAKE YOU DEY PREACH WELL
First Time: (No pass 2 min.) hf—Tell am wetin una go talk about when you come back.
Return Visit: (No pass 4 min.) hf—Tell am wetin una go talk about when you come next time.
Bible Study: (No pass 6 min.) lv 199 ¶9-10—Use small time show your Bible student how e go take do research wey concern the problem wey e dey face.
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Young People—Make Una No Dey Put Mind for Big Big Things: (15 min.) Play this video: Question Wey Dey Worry Young People for Mind—Wetin I Go Use My Life Do?—My Former Life. After, make una talk am together.
Congregation Bible Study: (30 min.) kr “Section 4—Kingdom Conquests—Legally Establishing the Good News,” chap. 13 ¶1-10
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 17 and Prayer