BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | JEREMIAH 44-48
No Dey ‘Put Mind for Big Big Things’
45:2-5
E fit be sey Baruch na person wey go school wey dey serve for king palace. Na true sey Baruch na Jehovah servant and e use all im mind help Jeremiah, but e get the time when e come dey put mind for ‘big big things.’ E fit be sey e want make dem put am for high position for the palace or maybe e come dey find how e go take get money well well. But Jehovah tell am sey make e stop to dey put mind for ‘big big things’ so that e no go die when dem destroy Jerusalem.