BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | EZEKIEL 1-5
E Really Sweet Ezekiel to Preach God Message
For vision, Jehovah give Ezekiel one paper wey e write im word put, Jehovah come tell Ezekiel sey make e chop am. Wetin e make am do?
2:9–3:2
Ezekiel need to allow God message enter im body well well like foam wey soak water. If e dey think about wetin dey that paper, e go touch am for mind, and make am go tell other people
3:3
The paper sweet for Ezekiel mouth because e like the work wey Jehovah give am