Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb18 February p. 5
  • Jesus Use Im Small Group of Disciple Give Plenty People Food

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Use Im Small Group of Disciple Give Plenty People Food
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2018
  • Similar Material
  • Who Be the Faithful and Discreet Slave?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
  • Jesus Give Many People Food Chop
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2018
mwb18 February p. 5
Jesus disciples give plenty people food

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 14-15

Jesus Use Im Small Group of Disciple Give Plenty People Food

Before the Passover for 32 C.E., Jesus do one miracle. Matthew, Mark, Luke, and John talk about this miracle for the Bible book wey dem write.

For this miracle, Jesus use im disciples give plenty people food, and na wetin e still dey do today.

14:16-21

  • Jesus tell im disciples make dem give the plenty people food, even though sey na only five bread and two fish dem get

  • Jesus collect the bread and the fish and after e pray, e divide am give im disciples. The disciples come share am give the people

  • The miracle wey Jesus do make the food plenty sotey dem no fit chop am finish. Jesus use im small group of disciple give plenty people food

    Jesus dey share the bread give im disciples; Watchtower
  • Jesus talk sey for the last days, e go choose people wey go give people “food for the correct time.”​—Mt 24:45

  • For 1919, Jesus choose “the slave wey get sense and wey dem fit trust.” This na the small group wey Jesus choose from the people wey go rule with am for heaven. Jesus put “im whole house” for their hand. This “im whole house” na the people wey dem go give food

  • As Jesus use im disciples give plenty people food that time, na so e still dey use this small group give people food today

How I fit show sey I know and dey respect this group wey Jesus choose?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share