BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 22-23
Obey the Two Commandment Wey High Pass
22:36-39
Use Matthew 22:36-39 arrange this three reason why we dey go meeting. Arrange how dem take dey important follow each other, start from the one wey dey important pass:
To encourage ourself
To encourage our brothers and sisters
To worship Jehovah and show sey we love am
Why e good make we dey try go meeting, even when we don tire, and we feel sey we no go too gain if we go?
Which other way we go take show sey we dey obey the two commandment wey high pass?