PART 5
When Heavy Rain Fall for Noah Time —Who Hear Wetin God Talk? Who No Hear?
Many people for Noah time no do wetin God talk. Genesis 6:5
Adam and Eve born pikin, na from their pikin, people take full this world. As time dey go, some angel come follow Satan dey do bad thing.
The bad angel dem come this world, come change their body like person own, because sey dem want marry fine fine woman. The pikin wey the women born, no be like other pikin. Dem get power no be small and dem wicked well well.
Na so so bad bad people come full the world that time. Na im make Bible talk sey: ‘Bad thing wey people dey do don too much and na only bad bad thing dem dey think everytime.’
Noah do wetin God talk, and e build the ark. Genesis 6:13, 14, 18, 19, 22
Noah na better person. Jehovah tell am sey e go use heavy rain kill all the bad people.
God still tell Noah sey make e make one big boat wey dem dey call ark, and make e carry all im family and different different animal enter inside.
Noah tell the people wetin God talk but dem no hear. Na so so laugh some dey laugh am, and some no even like wetin e dey preach at all.
As dem finish the ark, Noah come carry different different animal enter inside.