Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 1 p. 10-p. 11 par. 8
  • Two Message From God

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Two Message From God
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Elizabeth Don Born Pikin
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Dem Don Born the Person Wey Go Prepare the Road
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Dem Respect Jesus Before Im Mama Born Am
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Angel Gabriel Visit Mary
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 1 p. 10-p. 11 par. 8
Gabriel appear to Zechariah; Elizabeth get belle

CHAPTER 1

Two Message From God

LUKE 1:5-33

  • ANGEL GABRIEL DEY TELL ZECHARIAH SEY ELIZABETH GO BORN JOHN THE BAPTIST

  • ANGEL GABRIEL DEY TELL MARY ABOUT THE PIKIN WEY E GO BORN—JESUS

We fit talk sey everything wey dey inside Bible na message from God. God give us Bible so that we go fit learn the things wey e want make we learn. Make we talk about two special message wey God send about 2,000 years ago. Na angel Gabriel, wey “dey stand for God front,” carry the message come. (Luke 1:19) How things be when the angel carry this two important message come?

Around the year 3 B.C.E, angel Gabriel carry message come, but where be the first place wey e go? Na one area for Judea wey get plenty hill. The place fit no far from Jerusalem. One priest wey im name na Zechariah dey live there, and na Jehovah servant. Im wife name na Elizabeth. Zechariah and im wife don old and dem no get pikin. Now, na Zechariah turn to go serve as priest for the temple wey dey Jerusalem. As e dey inside the temple, na im angel Gabriel just appear near the incense altar.

Fear catch Zechariah, but the angel come make im mind come down when e tell am sey: “Zechariah, make you no fear, because God don really hear your prayer. Your wife, Elizabeth go born boy, and you go name am John.” E still talk sey John “go be great person for Jehovah eye,” and sey e go help people, “so that dem go be people wey dem don arrange down for Jehovah.”—Luke 1:13-17

Zechariah dey use hand sign

E hard Zechariah to believe wetin the angel talk. Why? Because im and im wife, Elizabeth don old. Na im angel Gabriel tell am sey: “Because you no believe wetin I talk, word no go come out from your mouth, and you no go fit talk again until the day wey all this things go happen.”—Luke 1:20.

As all this one dey happen, people wey dey outside dey wonder why Zechariah never come out from the temple. When e come out, e no fit talk with im mouth again, e come dey use hand sign. E clear sey Zechariah don see wetin pass am.

When Zechariah finish im work for temple, e go house. E no tey, Elizabeth come get belle! For five months, Elizabeth no go anywhere so that people no go see am.

Gabriel appear to Mary

The second time wey angel Gabriel come, e appear to one young woman wey never marry. The woman name na Mary. E dey live for Nazareth wey dey Galilee for the north side of Jerusalem. Wetin angel Gabriel tell am? E tell am sey: “God don favor you.” Gabriel still tell Mary sey: “See! you go get belle, and you go born boy, and make you name am Jesus. E go be great person, dem go call am Son of the Most High. E go be King wey go rule Jacob house forever, and im Kingdom no go get end.”—Luke 1:30-33.

E dey clear sey Gabriel happy to carry this two message wey God send am go give dem. As we dey learn more about John and Jesus, we go see why this two message from heaven dey important.

  • Who carry the two important message come from heaven?

  • Which people get the message?

  • Why you think sey the message from heaven hard to believe?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share