Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 3 p. 14-p. 15 par. 2
  • Dem Don Born the Person Wey Go Prepare the Road

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Dem Don Born the Person Wey Go Prepare the Road
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Elizabeth Don Born Pikin
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Two Message From God
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Dem Respect Jesus Before Im Mama Born Am
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Angel Gabriel Visit Mary
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 3 p. 14-p. 15 par. 2
Elizabeth dey show people im pikin

CHAPTER 3

Dem Don Born the Person Wey Go Prepare the Road

LUKE 1:57-79

  • WHEN DEM BORN JOHN THE BAPTIST AND WHEN DEM DEY GIVE AM NAME

  • ZECHARIAH DEY TALK THE WORK WEY JOHN GO DO FOR FRONT

Elizabeth go soon born. For three months now, Mary wey be im family member don dey with am. Now, time don reach make e go back. E go pass Judea area wey hill dey, before e reach im house for Nazareth. The journey far well well. Na six months remain for Mary self to born im own pikin.

E no tey wey Mary go house before Elizabeth born. Everybody happy as nothing do Elizabeth and the pikin wey e born. Mama and pikin dey strong! Im neighbors and family people happy well well when Elizabeth show dem the pikin.

For the Law wey God give Israel people, E tell dem sey when person born boy, e go circumcise am and give am name after eight days. (Leviticus 12:2, 3) Some people feel sey e go better for dem to give the boy im papa name wey be Zechariah. But Elizabeth no gree, e sey: “No! im name go be John.” (Luke 1:60) Remember, angel Gabriel don first talk sey make dem name am John.

Im neighbors and family people no gree, na im make dem talk sey: “Nobody for your family dey answer that name.” (Luke 1:61) Dem use hand ask Zechariah which name dem go give the boy. Zechariah come sey make dem bring something make e write the name put. E write sey: “Na John be im name.”—Luke 1:63.

Zechariah dey write on top something; Zechariah don start to dey talk again and e dey talk wetin go happen for front

As e write am finish, big miracle come happen, Zechariah start to talk again. Remember, when the angel tell am sey Elizabeth go born pikin, e no believe am. Na since that time e stop to talk. So as Zechariah start to talk again, im neighbors come dey wonder sey: “Which kind person this pikin go be?” (Luke 1:66) Wetin happen when dem dey name the pikin, show sey God dey with am.

As holy spirit enter Zechariah body, e come start to talk sey: “Praise Jehovah wey be Israel God, because e don turn im face to im people and e don save dem. From the house of im servant David, e don bring person wey get power well well wey go save us.” When e sey “person wey get power well well wey go save us,” e dey talk about the pikin wey Mary go soon born wey be Jesus. Zechariah still talk sey God go use am “save us from our enemy hand, we go get the strong mind to serve am well without fear. And we go hold am tight and dey clean for im eye everyday.”—Luke 1:74, 75.

Zechariah still talk about im pikin sey: “But as for you this pikin, dem go call you prophet of the Most High, because you go dey Jehovah front to prepare im road, to teach im people sey e go save dem when e don forgive their sin, because our God get soft mind. Because of this soft mind, morning light go visit us from heaven, to give light to people wey sitdown inside darkness and shadow of death. And to make our leg waka for where peace dey.” (Luke 1:76-79) Wetin Zechariah talk no sweet you for mind?

Now Mary don reach house. Everybody know sey e never marry. So wetin go happen to am when people see sey e get belle?

  • How many months John take senior Jesus?

  • Wetin happen when e reach eight days after dem born John?

  • Which work God go give John?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share