Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 20 p. 54-p. 55 par. 8
  • Jesus Second Miracle for Cana

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Second Miracle for Cana
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Jesus Do Im First Miracle
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • The Messiah Do Wetin Bible Don Talk Tey Tey Sey E Go Do
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • Jesus Show Im Love for True Worship
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 20 p. 54-p. 55 par. 8
One man wey dey work for government wey pain full im heart dey beg Jesus make heal im pikin

CHAPTER 20

Jesus Second Miracle for Cana

MARK 1:14, 15 LUKE 4:14, 15 JOHN 4:43-54

  • JESUS PREACH SEY “THE KINGDOM OF GOD DON NEAR”

  • E HEAL ONE BOY WEY DEY FAR FROM AM

After Jesus stay two days for Samaria, e come go im hometown. Even though sey e don preach well well for Judea, e no dey go Galilee go rest. But e want go preach even more for the area where e grow. E fit be sey Jesus no dey expect sey dem go welcome am well, because Jesus imself talk am sey, “dem no dey respect prophet for im hometown.” (John 4:44) When dem reach Galilee, im disciples go back to their family and the work wey dem dey do before.

Wetin Jesus start to preach about? Na about the Kingdom, e sey: “the Kingdom of God don near. Repent, and get faith for the good news.” (Mark 1:15) Wetin the people come do? The truth be sey, many people for Galilee welcome Jesus well and dem respect am. No be because of the message wey e dey preach, but because some of dem dey the Passover wey dem do for Jerusalem and dem see the miracle wey Jesus do.—John 2:23.

Where for Galilee Jesus start this big preaching work? E clear sey na for Cana, where e turn water to wine for one marriage. As e come this second time, e hear sey one small boy dey sick and e go soon die. The boy papa dey work for King Herod Antipas wey later kill John the Baptist. As the boy papa hear sey Jesus don come Cana, e come travel from Capernaum where e dey live, go find Jesus for Cana. With the pain wey full im heart, e beg Jesus sey, “Oga, make you come before my pikin die.”—John 4:49.

Jesus talk wetin surprise the man, e sey: “Make you dey go, your son dey alive.” (John 4:50) The man believe Jesus and e come dey go house. For road e meet im slaves wey dey run come tell am the good news. True true, im pikin don well, and e dey alive! Na im e ask dem sey: ‘Which time e well?’ E dey ask so that e go know the exact time.

Dem tell am sey ‘na yesterday around 1 o’clock for afternoon.’—John 4:52.

The man slaves run come meet am as e dey come back to im pikin wey Jesus heal

The man come see am sey na the exact time wey Jesus tell am sey “your son dey alive.” As this one happen, this rich man wey get slaves and all im family come be Jesus disciples.

Na for Cana Jesus do two miracle. E first turn water to wine and from far place, e cure the small boy wey dey sick even though sey where the pikin dey far reach 26 km. No be only this miracles Jesus do. But the small boy own dey important because e show sey Jesus don come back to Galilee. Na true! Jesus na really prophet wey God anoint. But how dem go ‘respect this prophet reach for im hometown’?

We go know as Jesus dey go Nazareth. Wetin go happen to am for there?

  • When Jesus go back to Galilee, Wetin Jesus start to preach about, and wetin the people do?

  • Which miracle Jesus do again for Cana, and how e take affect the rich man family?

  • Wetin you learn from the way Jesus take cure the small boy wey dey Capernaum?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share