Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 23 p. 60-p. 61 par. 5
  • Jesus Do Many Miracle for Capernaum

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Do Many Miracle for Capernaum
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Jesus Preach Reach Many Place for Galilee
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 23 p. 60-p. 61 par. 5
Sick people gather for Peter house, and Jesus heal all of dem

CHAPTER 23

Jesus Do Many Miracle for Capernaum

MATTHEW 8:14-17 MARK 1:21-34 LUKE 4:31-41

  • JESUS PURSUE DEMON COMOT FROM PERSON BODY

  • JESUS HEAL PETER MOTHER-IN-LAW

Jesus don choose four disciples—Peter, Andrew, James and John—to come be fishers of men. For Sabbath day, all of dem go the synagogue wey dey Capernaum. The people still dey surprise for the way Jesus dey teach because e dey do am as person wey get authority, no be like the scribes.

One man wey demon dey im body, come that day. For inside the synagogue, the man come dey shout: “Which business we get with Jesus the Nazarene? Abi you come destroy us? I know exactly who you be, you be God Holy Person!” But Jesus tell the demon sey: “Shut up, and comot from im body!”—Mark 1:24, 25.

At once, the wicked spirit nack the man for ground and make am get convulsion, e come shout with loud voice. The demon comot from the man body, and “e no injure am.” (Luke 4:35) Everybody wey dey around am for the synagogue surprise, dem come dey ask sey: “Wetin be this? . . . E even get the power to talk to demons and dem go obey am.” (Mark 1:27) E no tey, everybody for Galilee hear about this better thing wey happen.

When dem comot from the synagogue, Jesus and im disciples go Simon or Peter house. For there, dem meet Peter mother-in-law wey dey sick. E get high fever, so dem come beg Jesus make e help am. So Jesus waka go meet am, hold im hand, come raise am up. At once, e come well, and e come begin serve Jesus and im disciples, e fit be sey na food e cook for dem.

For evening, people from different different place come dey carry people wey dey sick come Peter house. E no tey, e come be like sey the whole town gather for the door. Why? Because dem dey find cure. In fact, all the people wey their person dey sick carry dem come meet am. And e touch all the people, na so e take cure dem. (Luke 4:40) And no matter the kind sickness wey dem get, Jesus cure all of dem as God Word talk. (Isaiah 53:4) E even free people wey demons dey oppress. As the demons dey come out, dem go dey shout: “You be God Son!” (Luke 4:41) But Jesus stop dem and no let dem talk anything. Dem know sey na Jesus be the Christ and e no want make dem dey do like sey dem be Jehovah servant.

WHEN DEMON DEY PERSON BODY

When demon enter person body, e fit suffer the person well well. (Matthew 17:14-18) But when the demon comot from the person body, e go come normal. Many times, Jesus show sey e get power to pursue demon comot from person body. And na the holy spirit e dey use.—Luke 8:39; 11:20.

  • Wetin happen inside synagogue for Capernaum one Sabbath day?

  • Where Jesus go when e comot from the synagogue, and wetin e do for there?

  • Wetin the people for the city do because of the thing wey Jesus do?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share