CHAPTER 24
Jesus Preach Reach Many Place for Galilee
MATTHEW 4:23-25 MARK 1:35-39 LUKE 4:42, 43
JESUS AND IM FOUR DISCIPLES PREACH FOR MANY PLACE FOR GALILEE
EVERYBODY KNOW ABOUT IM MIRACLE AND PREACHING
Na since morning Jesus and im four disciples dey busy for Capernaum. When evening reach, the people still dey bring their people wey dey sick make Jesus heal dem. Jesus no come too get time to rest.
So for early morning the next day, Jesus come get up go outside when everywhere still dark. E find one quiet place where e go fit stay, pray to im Father. When dem see sey e don comot, “Simon and the people wey dey with am come go find am.” E be like sey na Peter dey front because na im house Jesus come.—Mark 1:36; Luke 4:38.
When dem see Jesus, Peter tell am sey: “Everybody dey find you.” (Mark 1:37) E clear sey people for Capernaum want make Jesus stay. Dem happy well well for wetin Jesus do for dem, and dem no want “make Jesus leave dem.” (Luke 4:42) But na only to do miracle and heal people make Jesus come this earth? And na for only this place e go do im work? Wetin Jesus talk for the matter?
Jesus answer im disciples sey: “Make we go another place, inside other town wey near so that I go still preach for there, because na im make me come.” Jesus even tell the people wey want make e stay with dem sey: “I must preach the good news about God Kingdom for other city, because na this one make me come.”—Mark 1:38; Luke 4:43.
Na true, the main reason why Jesus come this earth na to preach about God Kingdom. Na the Kingdom go make im Father name clean, and na im go comot all the wahala wey human being dey face. Jesus do those miracle to show sey na God send am. Na so Moses still do miracle to show people sey na God send am.—Exodus 4:1-9, 30, 31.
So Jesus comot from Capernaum go preach for other place and im four disciple follow am. The four disciples na Peter with im brother Andrew, and John with im brother James. One week don pass since Jesus call dem make dem come dey follow am preach.
Jesus and im four disciples really get better result for the preaching work wey dem do for Galilee. The truth be sey, people just dey hear about Jesus for everywhere. The news about Jesus reach everywhere for Syria, even go reach the ten city wey dem dey call Decapolis, and the other side of River Jordan. (Matthew 4:24, 25) Plenty people from that area and people from Judea come dey follow Jesus and im disciples. Many of dem bring sick people make e heal dem. And Jesus no fail dem—e heal all of dem and pursue the demons wey dey people body.