Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 29 p. 72-p. 73 par. 8
  • Person Fit Do Good Thing On Sabbath Day?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Person Fit Do Good Thing On Sabbath Day?
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 29 p. 72-p. 73 par. 8
Jesus dey talk to one man wey dey sick for hear the pool of Bethzatha

CHAPTER 29

Person Fit Do Good Thing On Sabbath Day?

JOHN 5:1-16

  • JESUS PREACH FOR JUDEA

  • E CURE ONE MAN FOR ONE POOL

Jesus don preach well well for Galilee. But when e sey, “I must preach the good news about God Kingdom for other city,” e mean sey no be only Galilee e get for mind. “Na im e go, dey preach for all the synagogue wey dey Judea.” (Luke 4:43, 44) Na better thing because the festival for Jerusalem don dey near.

Dem no talk plenty things about Jesus preaching for Judea the way dem talk about im preaching for Galilee. Even though sey many people no gree listen to am for Judea, that one no stop am to dey preach and do better things for people anywhere e go.

E no tey, Jesus go Jerusalem wey be the main city for Judea, because of the Passover of 31 C.E. For one busy area wey near the Sheep Gate, e get one big pool wey dem dey call Bethzatha. People wey dey sick, wey blind and cripple dey come this pool. Why? Because dem believe sey e fit heal person if e enter the pool when the water dey shake.

For the Sabbath day, Jesus see one man wey don dey sick for 38 years. E come ask the man sey: “You want make you well?” The man come answer am sey: “Oga, I no get person wey go put me inside the water when e dey shake. Before I reach there, another person don first me enter.”—John 5:6, 7.

Jesus come talk something wey surprise the man and other people wey hear am. E sey: “Stand up, carry your mat, and waka.” (John 5:8) And na wetin the man do be that. At once, the man carry im mat, and start to dey waka!

Jew people dey talk to one man wey Jesus heal

For Jew people to dey happy for this better thing wey happen, dem come start to dey trouble the man. Dem tell am sey: “Today na Sabbath, and the law no support make you carry this mat.” The man come answer dem sey: “The person wey heal me tell me sey, ‘carry your mat, and waka.’” (John 5:10, 11) The Jews no like am as person dey heal people on Sabbath day.

Dem ask the man sey: “Who be the person wey tell you sey ‘carry am and waka’?” Why dem dey ask am? Because Jesus ‘don enter where plenty people dey.’ And the man no know Jesus name. (John 5:12, 13) But this man go still meet Jesus another time. Later, the man meet Jesus for the temple. Na there e know the name of the person wey heal am.

Later when the man see the Jew people, e tell dem sey na Jesus heal am. As dem hear am, dem go meet Jesus. No be to go know how Jesus take get power wey e take dey do miracle, but na to quarrel with am sey e heal person on Sabbath day. Dem come even start to give am problem!

  • Why Jesus go Judea, and wetin e still dey do?

  • Why people dey go the pool wey dem call Bethzatha?

  • Which miracle Jesus do for Bethzatha, and how some Jew people feel about am?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share