Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 35 p. 84-p. 91 par. 4
  • Jesus Teach People for Mountain

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jesus Teach People for Mountain
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Small Topic Dem
  • WHICH PEOPLE REALLY DEY HAPPY?
  • JESUS SHOW IM DISCIPLES THE CORRECT WAY
  • PRAYER AND TO TRUST GOD
  • HOW TO GET LIFE
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 35 p. 84-p. 91 par. 4

CHAPTER 35

Jesus Teach People for Mountain

MATTHEW 5:1–7:29 LUKE 6:17-49

  • THE SERMON ON THE MOUNT

Jesus go don tire well well. E don use the whole night pray before e choose 12 people from all im disciples to be im apostles. Day don break, but e still get power and mind to help people. E come go one mountainside for Galilee. E be like sey this place no far from Capernaum, where e preach well well.

Many people from far place come meet am. Some come from south, from Jerusalem and many place for Judea. Other people come from Tyre and Sidon wey dey near river for the northwest side. Why dem come find Jesus? “Dem come make e teach dem and heal dem from their sickness.” Na wetin happen be that. Jesus heal all of dem. Just think am! E cure everybody wey dey sick. Jesus still cure people wey demons dey suffer.—Luke 6:17-19.

Jesus come sitdown for one place wey flat for the mountainside. Plenty people come gather round. E fit be sey na the 12 apostles near am pass. Everybody want hear wetin this teacher wey dey do miracle go talk. Jesus come give one talk or sermon, and people wey listen to am gain. Since that time, plenty people don still gain from this sermon. We go fit still gain because the sermon get many things wey fit help us near God more more. Jesus make am simple, and e dey clear. Jesus use story and things wey people know teach dem. Anybody wey want enjoy better life as God want am, go quick understand wetin Jesus talk, because e make am simple to understand. Wetin Jesus talk about, wey make this things wey e teach, dey important?

WHICH PEOPLE REALLY DEY HAPPY?

Everybody like to dey happy. Because Jesus know this one, e come first talk about things wey really dey make person happy. People go really like to listen to am well well. But some things go really surprise dem.

E sey: ‘People wey know sey dem need God for their life go happy, because dem go get the Kingdom wey dey heaven. People wey dey cry because person die, go happy because their mind go come down. . . . People wey dey hungry to do wetin God want, go happy because dem go belleful. . . . People wey dem don suffer because of God, go happy because the Kingdom wey dey heaven na their own. You go happy when people dey curse you and dey suffer you . . . because of me. Happy and make belle sweet you well well.’—Matthew 5:3-12.

Wetin Jesus mean when e sey “happy”? E no dey talk about ordinary laugh or smile, like wetin person dey do when e dey enjoy imself. Real happiness pass that one. Person wey get real happiness dey let wetin e get reach am. And e know for im mind sey e dey live better life.

Jesus sey people wey really dey happy na people wey know sey dem need God for their life, people wey no like the sin wey dey their body, and people wey don know God and dey serve am. Even if people hate dem or suffer dem because dem do wetin God want, dem go happy because dem know sey dem dey make God happy, and e go give dem life wey no go end.

Many people think sey na plenty money and enjoyment dey make person happy. But how Jesus see am? E talk wetin go make many people think. E sey, ‘Una wey get money now go suffer because na only that one una go enjoy. Una wey get everything now go suffer, because una go hungry. Una wey dey laugh now go suffer because una go cry and una no go happy. Una go suffer anytime wey everybody dey praise una, because na so their papa-papa praise the fake prophets dem.’—Luke 6:24-26.

Why e be sey plenty money, enjoyment, and praise from people dey bring wahala? Na because when person get this things and value dem, e fit no remember to serve God well again. That one no go make am get real happiness. Jesus no dey talk sey poverty or hunger dey make person happy. But most times, na poor people dey obey wetin Jesus talk and na dem God dey bless with real happiness.

The next thing wey Jesus talk na for im disciples. E sey: “Na una be the salt for this earth.” (Matthew 5:13) Jesus disciples no be ordinary salt! Dem dey put salt for some things so that dem no go quick spoil. For God temple, dem dey keep plenty salt near the altar. And dem dey put am for sacrifice. For Bible, salt fit still mean sey something dey pure and e no spoil. (Leviticus 2:13; Ezekiel 43:23, 24) Jesus disciples na “salt for this earth” because dem dey help people get better character and be Jehovah friend. Their message fit save anybody wey listen to dem.

Jesus still tell im disciple sey: ‘Na una be the light for this world.” Person no dey use basket cover lamp, e dey put the light where e go shine. So Jesus sey: “Make una light shine for where people dey, so that dem go see una fine work and praise the Father wey dey heaven.’—Matthew 5:14-16.

JESUS SHOW IM DISCIPLES THE CORRECT WAY

E never tey wey leaders for Jew people religion plan to kill Jesus because dem see am as person wey no dey obey God law. Na im make Jesus talk sey: ‘No think sey I come destroy the Law or the Prophets. I no come destroy am, but I come do wetin e talk.’—Matthew 5:17.

The truth be sey, na Jesus respect God law pass, and e tell people sey make dem dey respect am. E even talk sey: ‘If anybody no obey any of the commandment wey small pass, and e come dey teach other people to do like am, na im go small pass for the Kingdom wey dey heaven.’ Wetin Jesus mean be sey, that kind person no go near God Kingdom at all. Jesus still sey: ‘But if anybody obey the commandment and still teach people to obey am, e go be big person for the Kingdom wey dey heaven.’—Matthew 5:19.

Jesus even talk sey e bad for person to get character wey fit make am no obey God law. After Jesus don quote the law wey sey make we no ever kill, e talk sey: ‘Anybody wey continue to dey vex for im brother, go face judgement for court.’ (Matthew 5:21, 22) Na really serious matter if person no stop to dey vex for another person. E fit even make am kill the person. Na im make Jesus talk sey we must try to make sure sey peace dey. E sey: “If as you want come give something for altar, and for there you come remember sey your brother dey vex for you, leave wetin you want give for the front of altar, make you first go settle with am, before you go come give God the thing.”—Matthew 5:23, 24.

Another commandment for the Law show sey e bad for person to sleep with who no be im husband or wife. Jesus talk sey: “Una hear this thing wey dem talk sey: ‘Make you no sleep with person wey no be your wife or husband.’ But I dey tell una sey: Any man wey dey look woman sotey e want sleep with am, that man don already sleep with am for im heart.” (Matthew 5:27, 28) Jesus no dey talk about bad thing wey just pass person mind. But, e dey talk sey na serious matter if person no stop to “dey look.” If person too dey look another person, e fit start to dey like the person. And if e see chance, e fit go sleep with am. Wetin person go do make this kind thing no happen? Wetin e need to do really dey serious. Jesus sey: ‘If your right eye dey make you fall, pull am comot and trowey am. . . . If your right hand dey make you fall, cut am comot and trowey am.”—Matthew 5:29, 30.

Some people get sickness wey affect their hand or leg, and dem cut am comot to save their life. So e make sense when Jesus sey e dey important for person to “trowey” anything, even if na something wey get value like eye or hand, so that e no go think bad thing and do am. Jesus sey: ‘E better make you lose one part of your body, than for dem to trowey you inside Gehenna’ (where dem dey burn dirty outside Jerusalem). This one mean sey dem go destroy the person.

Jesus still give advice about people wey dey cause wahala. E sey: “No do wicked person back, if anybody slap you for one side of your face, turn the other side give am.” (Matthew 5:39) That one no mean sey person no go protect imself or im family when people attack dem. Na slap Jesus talk about. Slap no dey kill or injure person. E only mean sey person no respect you. So Jesus mean sey, person fit slap you or curse so that you go follow am fight or quarrel, but make you no do am back.

This advice follow wetin God law talk when e sey make we love our neighbor. Na im make Jesus advice people wey dey listen to am, sey: ‘Continue to dey love you enemy and pray for people wey dey suffer you.’ Jesus still give dem one better reason why dem suppose follow this advice. E sey: ‘So that you go fit show sey you be the pikin of your Father wey dey heaven, because e dey make im sun shine for wicked people and good people, and e dey make im rain fall for righteous people and bad people.’—Matthew 5:44, 45.

Jesus talk the main point for this teaching when e sey, ‘Una must dey perfect the way una Father for heaven dey perfect.’ (Matthew 5:48) Jesus no dey talk sey people go fit really dey perfect. Wetin e mean be sey, we fit copy God example, and love people even our enemies. So wetin Jesus dey talk be sey, make we “continue to dey pity for people, just the way una Father dey pity for people.”—Luke 6:36.

PRAYER AND TO TRUST GOD

As Jesus continue to teach the people, e tell dem sey: “Make una sofri, so that una no go dey do good things for people front because una want make dem see una.” Jesus no like am when people dey form holy-holy, na im make e sey: “When you want give gifts of mercy, make you no begin blow horn as you dey go. Na wetin pretenders dey do” be that. (Matthew 6:1, 2) E better to do your contribution make people no know.

The next thing wey Jesus talk about na prayer, e sey: ‘When you dey pray, no dey do like pretenders, because dem like to dey stand and pray for synagogue and corners of main street, so that people go see dem.’ E still talk sey: “When you dey pray, enter your room and, after you don close your door, pray to your Father wey you no fit see.” (Matthew 6:5, 6) Jesus no dey talk sey make we no pray for where people dey at all, because im don pray for where people dey before. For here, Jesus dey condemn the kind prayer wey people dey pray so that other people go dey praise dem.

Jesus advice the people sey: “When you dey pray, no dey talk the same thing again and again, the way people for this world dey do.” (Matthew 6:7) Jesus no dey talk sey e bad to continue to pray for something. But, e dey talk sey e no good to dey cram prayer and dey repeat am. E come give example of how we suppose pray. E talk seven things wey person fit pray about. The first three things na about God right to rule, and things wey God get for mind. E sey make God name dey holy, make e kingdom come and make wetin e want happen. Na those things we go first tell God. After that one, we fit tell am the things wey we need, like food, to forgive our sin, make we no see problem wey we no go fit bear, and make e save us from Satan hand.

How you value your property reach? Jesus tell the people sey: “Make una stop to dey gather things for unaself for this earth, where insect and rust fit spoil am and where thief fit enter come thief am.” Wetin Jesus talk, really correct! Property wey we get fit spoil, and sey we get dem no mean sey God go like us. Jesus come sey: “Keep better thing for yourself for heaven.” We fit do this one if God na number one for our life. Nobody fit spoil our friendship with God, and nobody fit collect the life wey God don promise us. So na true Jesus talk when e sey: “Where your property dey, na there your mind go still dey.”—Matthew 6:19-21.

Jesus use one example to make dem understand this matter. E sey: “Na the eye be the lamp for the whole body, so if you put eye straight for one thing, your whole body go bright. But if your eye dey for plenty things, your whole body go dark.” (Matthew 6:22, 23) Eye wey dey work well be like light wey dey make our body shine. For am to be like that, we must put eye for one thing. If not, we no go see things for this life the way we suppose see am again. If we put mind for property pass God, our “whole body go dark.” This one mean sey we fit start to dey play wayo or do bad things.

Jesus give one better example: ‘Nobody fit be slave for two oga. E go either hate one and love the other one, or e go hold one tight and leave the other one. Una no fit be slave to God and to money.’—Matthew 6:24.

Some people wey dey listen to Jesus fit want know the correct thing to do about things wey dem need for life. So Jesus promise dem sey, if na God be number one for their life, dem no need to worry. E talk sey: ‘Make una look the bird wey dey fly for up, dem no dey plant seed and dem no dey harvest put for inside store, but una Father wey dey heaven still dey give dem food.’—Matthew 6:26.

What of the fine fine flower wey dey grow for the mountain? Jesus talk sey, Even as Solomon get honor reach, im cloth no dey fine reach any of this flower. Wetin this one mean? “Flower wey dey today, tomorrow dem go throw am for oven, but God make am fine. You no think sey God go still take care of you?” (Matthew 6:29, 30) Jesus come give dem one better advice: “Make una no dey worry and sey, ‘Wetin we go chop?’ or ‘Wetin we go drink?’ or ‘Wetin we go wear?‘ . . . Your Father wey dey heaven know sey you need all this things. So, make una continue to dey find the Kingdom and im righteousness first, and e go add all this other things join for una.”—Matthew 6:31-33.

HOW TO GET LIFE

The apostles and other people wey get good heart want live the kind life wey go make God happy, but somethings dey make am hard for dem. For example, many Pharisee dey find fault and dey use wicked mind judge people. Jesus advice people wey dey listen to am sey: “Stop to dey judge people, so that dem no go judge una; because na the way una judge people dem go judge una.”—Matthew 7:1, 2.

Jesus show sey na bad thing to dey copy the way Pharisee people dey condemn people, e talk sey: “Blind person go fit show another blind person road? The two of dem no go fall inside pit?” So how the people wey dey listen to Jesus suppose dey look other people? No be to find fault, because that one na big sin. E ask dem sey: “How you go tell your brother sey, ‘My brother, make I comot the grass wey dey your eye,’ you no dey see the plank wey dey your own eye? Pretender! First comot the plank wey dey your eye, so that you go see well and fit comot the grass wey dey your brother eye.”—Luke 6:39-42.

This one no mean sey the disciples no go judge matter at all. Jesus talk sey: “No give wetin dey holy to dog and no throw pearls give pig.” (Matthew 7:6) Truth wey dey God Word dey precious like pearls. If people dey do like animal and no show sey dem like Bible truth, the disciples go leave dem and find other people wey go value am.

Jesus come back to prayer matter, and e talk why e good make we no stop to dey pray. E sey: “Continue to dey ask, and dem go give una.” To let the people know sey God really ready to answer prayer, Jesus ask dem sey: ‘Which one of una for here go give im pikin stone if e beg am bread? . . . So, if una wey wicked sabi give better gift to una children, una Father wey dey heaven go do pass that one, e dey give good things to people wey dey beg am!’—Matthew 7:7-11.

The next thing wey Jesus talk about na how to treat people. E sey: ‘Everything wey una want make people do una, make una do am to dem.’ This na better advice wey we suppose remember when we dey do things with other people. But e fit no easy to do am. Na im make Jesus talk sey: ‘Make una enter from the narrow gate. Because the wide gate and the road wey get space well well dey lead to destruction, and na many people dey follow the road. But the narrow gate and the road wey tight dey lead to life, and people wey dey follow the road no plenty.’—Matthew 7:12-14.

Some people go try to comot the disciples mind from the road wey lead to life. Na im make Jesus warn dem sey: ‘Make una sofri because fake prophet go use sheep body cover theirself come meet una, but for inside dem be dangerous wolves.’ (Matthew 7:15) Jesus talk sey na fruit dem take dey know good tree and bad tree. Na so e still be with people. Na wetin dem dey teach and wetin dem dey do, we go use take know fake prophets. Jesus talk sey no be only wetin person talk go show sey e be Jesus disciple, wetin e dey do go still show am. Many people talk sey Jesus na their Lord, but dem no dey do wetin God want. Jesus talk sey: ‘I go tell dem sey: “I no know una! Make una comot for my front, una wey dey do rubbish”’ —Matthew 7:23.

To end im sermon, Jesus sey: ‘So, everybody wey hear all this things wey I dey talk so, and e come do dem, go be like wise man wey build im house ontop rock. When heavy rain fall, flood come, and heavy breeze blow the house, but e no fall because na on top rock e dey.’ (Matthew 7:24, 25) Wetin make the house no fall? Na because the man make the foundation of the house deep and e build am ontop rock. (Luke 6:48) So we no go only hear wetin Jesus teach. Instead, we must use all our mind “do am.”

What of person wey dey hear the things Jesus talk but e no dey do dem? E go be like “foolish man wey build im house ontop sand.” (Matthew 7:26) Rain, flood, and breeze go scatter that kind house fall.

The people surprise for the way Jesus take teach the sermon. E no teach dem the way the leaders for Jew religion dey do. But, e teach dem like person wey get authority. E be like sey many of the people wey listen to am become im disciples.

JESUS REPEAT THINGS WEY E TEACH

Sometimes, Jesus dey repeat important things when e dey teach. For example, for the Sermon on the Mount, e teach people how to pray, and e let dem know the correct mind for money and property.—Matthew 6:9-13, 25-34.

About one year and six months later, Jesus talk this things again. (Luke 11:1-4; 12:22-31) Some people fit no dey when Jesus talk am the first time, so this one na better chance for dem to gain from wetin Jesus dey teach. And e still make am easy for im disciples to remember the important things.

  • Where Jesus for give im sermon wey people know well well, and who dey there?

  • Why the things wey Jesus teach for Mountain really enter people mind?

  • Which kind people really dey happy, and why?

  • Which people Jesus say go suffer, and why?

  • How Jesus disciples take be “salt for this earth” and “the light for this world”?

  • Jesus respect God Law? Explain.

  • How Jesus take help us know wetin we go do so that we no go kill or sleep with person wey no be our husband or wife?

  • Wetin Jesus mean when e sey make we turn the other side of our face?

  • How we fit dey perfect like God?

  • Wetin Jesus teach about prayer?

  • Why the things wey we dey keep for heaven better pass, and how we go take get dem?

  • Why Jesus disciples no need to dey worry?

  • Wetin Jesus talk about to de judge people, but sometimes, why we need to judge?

  • Which other things Jesus talk about prayer, and how e sey make we treat people?

  • How Jesus take show sey e no easy to be im disciple, and we dey danger if dem deceive us?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share