Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 41 p. 102-p. 103 par. 5
  • Which Person Power Jesus Take Do Miracle?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Which Person Power Jesus Take Do Miracle?
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • E Do Many Miracle, But Im Town People Reject Am
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 41 p. 102-p. 103 par. 5

CHAPTER 41

Which Person Power Jesus Take Do Miracle?

MATTHEW 12:22-32 MARK 3:19-30 LUKE 8:1-3

  • JESUS START TO TRAVEL ROUND GO PREACH THE SECOND TIME

  • E DRIVE DEMON FROM PEOPLE BODY AND WARN PEOPLE ABOUT SIN WEY GOD NO GO FORGIVE

Small time after Jesus teach people for Simon house sey make dem dey forgive, e start to go preach round Galilee again. This na the second year of Jesus preaching, and e no dey waka alone. The 12 apostles dey with am. Some women wey e “cure their sickness and drive demon from their body” still follow am. (Luke 8:2) Some of dem na Mary Magdalene, Susanna and Joanna, wey im husband dey work for King Herod Antipas.

As more people dey hear about Jesus, the argument about the things wey e dey do come dey strong more more. Na so e happen when Jesus cure one man wey dem carry come for am. Demon dey the man body, e blind and e no fit dey talk. As e free the man from the demon, e start to dey see and talk. The people surprise and dem sey: “Una sure sey this no be David Son?”—Matthew 12:23.

Plenty people gather around the house where Jesus dey stay, sotey Jesus and im disciples no see chance to chop. But no be everybody believe sey Jesus na “David Son” wey God Word talk about. Some scribes and Pharisees even travel from Jerusalem come meet Jesus. But dem no come learn from am or support am. But, dem start to tell people sey: “E get Beelzebub,” and sey e dey work with “the king of demons.” (Mark 3:22) When Jesus family people hear about the confusion wey dey ground, dem come meet Jesus so that dem go catch am. But why?

Come reach this time, Jesus brothers no believe sey e be God Son. (John 7:5) The Jesus wey dey cause this confusion for everywhere really different from the Jesus wey dem know wey grow with dem for Nazareth. Dem come dey feel sey something dey worry Jesus for head. Dem talk sey: “E don dey craze.”—Mark 3:21.

But wetin the things wey Jesus do, show? Jesus just cure one man wey demon dey worry. The man start to dey see and talk. Nobody fit deny this one. So the scribes and the Pharisees come begin lie and talk bad about wetin Jesus dey do. Dem sey: “This man dey drive demons with Beelzebub power, wey be the king of demons.”—Matthew 12:24.

Because Jesus know wetin the scribes and Pharisees dey think, e come sey: “Any kingdom wey dey fight imself go scatter and any house wey dey fight imself go fall. Na so e still be, if Satan pursue Satan, e don dey fight imself; how im kingdom go take stand?”—Matthew 12:25, 26.

Wetin Jesus talk really make sense! The Pharisees know sey some Jew people dey pursue demons comot from people body. (Acts 19:13) So Jesus come ask dem sey: “If na Beelzebub power I take dey drive demons, which person power una sons take dey pursue demons?” Wetin Jesus dey talk be sey, the things wey dem dey talk about, still affect dem. Jesus come talk more for the matter. E sey: “But if na God spirit I dey take drive demons, una don really miss God Kingdom.”—Matthew 12:27, 28.

To show sey the power wey e dey take drive demons pass Satan own, Jesus talk sey: “How anybody go fit enter strong man house and collect im property if e no first tie the strong man? Na only that time e fit rob am. Anybody wey no dey my side dey against me, and anybody wey no gather with me go scatter.” (Matthew 12:29, 30) The scribes and Pharisees really dey against Jesus. This one show sey dem dey work for Satan. Dem dey drive people from the Person wey God don give power.

Jesus warn dem sey: “All the things wey people do, dem go forgive dem, no matter the kind sin wey dem commit and bad things wey dem talk. But dem no go ever forgive anybody wey talk bad thing about the holy spirit, because e don commit everlasting sin.” (Mark 3:28, 29) Just imagine wetin go happen to this people wey dey give Satan the praise wey be Jehovah own!

  • Which people dey with Jesus when e travel go Galilee for the second time?

  • Why Jesus family people want catch am?

  • Wetin the scribes and Pharisees do to spoil people mind about Jesus miracles, and how Jesus take answer dem?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share