CHAPTER THREE
Wetin God Get For Mind for Us?
1. Wetin God get for mind for us?
NA BETTER thing God get for mind for us. E make the first man and woman, Adam and Eve, come put dem for one fine place wey dem dey call garden of Eden. Wetin e get for mind be sey make Adam and Eve born children, make dem make the whole earth paradise, and take care of all the animal.—Genesis 1:28; 2:8, 9, 15; check Endnote 6.
2. (a) How we take know sey God go do wetin e get for mind? (b) Wetin Bible talk about the people wey God go give this earth?
2 You think sey this earth go ever fit be paradise? Jehovah don tell us sey: ‘Na wetin dey my mind and e go happen.’ (Isaiah 46:9-11; 55:11) Na true, e go do wetin e get for mind and nothing fit stop am. Jehovah sey e get reason why e make this earth. E talk sey e ‘no make am for nothing.’ (Isaiah 45:18) E want make people dey live for everywhere for this earth. Which kind people God want for this earth and how many years e want make dem live? Bible talk sey: ‘Na people wey do wetin God want God go give this earth, and dem go stay there forever.’—Psalm 37:29; Revelation 21:3, 4.
3. As people dey sick and as people dey die, which question e fit make you ask?
3 But today people dey sick and people dey die. For many place, people dey fight and dey kill theirself. The truth be sey, no be wetin God get for mind for us be that. But wetin come happen, and why? Na only Bible fit tell us.
GOD ENEMY
4, 5. (a) Who use snake talk to Eve for the garden of Eden? (b) How better person fit take turn imself to thief?
4 Bible talk sey God get enemy. Im name ‘na Devil and Satan.’ Na Satan use snake talk to Eve inside the garden of Eden. (Revelation 12:9; Genesis 3:1) E do am like sey na the snake really dey talk.—Check Endnote 7.
5 Na God make Devil? No! Na im make imself be Devil. Na angel e be before for heaven. E dey there when God dey arrange this earth for Adam and Eve. (Job 38:4, 7) How that kind thing fit take happen? Better person fit turn imself to thief? Yes o! If the person get long throat for wetin no be im own sotey e want take am. E come dey think about am every time, e no gree comot am for mind. If e get chance to thief am, wetin e go do? E go thief am! E don make imself thief be that but im papa and mama no born am as thief.—Read James 1:13-15; check Endnote 8.
6. How one angel take turn imself to God enemy?
6 Na this kind thing happen to that angel. After God don make Adam and Eve, e tell dem sey make dem born pikin full the whole earth. (Genesis 1:27, 28) That angel fit don tell imself sey: ‘All this people fit dey worship me instead of Jehovah!’ As e dey think am everytime, na so e dey hungry am to get wetin no be im own. The angel want make dem dey worship am, na im make am deceive Eve. (Read Genesis 3:1-5.) Na this thing wey e do make am be Satan the Devil, God enemy.
7. (a) Why Adam and Eve die? (b) Why we dey old and dey die?
7 Adam and Eve do wetin God sey make dem no do. Dem chop the fruit wey God sey make dem no chop. (Genesis 2:17; 3:6) As Jehovah talk, dem come die because dem don sin. (Genesis 3:17-19) All the children wey Adam and Eve born dey die because dem still get sin. (Read Romans 5:12.) Make we use this example learn how all the children wey Adam and Eve born take get sin. Think about pan wey dem take dey do bread. If the pan get comma, any bread wey dem take am make go still get comma. Na so e still be with Adam children. Adam sin when e do wetin God sey make e no do. Because sey we be Adam children, all of us get “comma” or sin like Adam. And as we get sin, all of us dey old and we dey die.—Romans 3:23; check Endnote 9.
8, 9. (a) Wetin Satan want make Adam and Eve believe? (b) Why Jehovah no kill all of dem that day?
8 Satan start to dey make people do wetin Jehovah no like after e don deceive Adam and Eve. E want make dem believe sey Jehovah dey lie, sey Jehovah na bad King wey no want better thing for dem. Wetin Satan mean be sey, human being no need Jehovah to tell dem wetin dem go do, and sey make Adam and Eve dey choose by theirself wetin good and wetin bad. As e happen like that, wetin Jehovah go come do? Maybe e for kill all of dem throw. But if to sey God kill dem, you think sey that one for show sey Satan dey lie? No!
9 Jehovah no kill dem that day. But e give human being time make dem rule theirself. This one go show sey Satan na big liar and sey na Jehovah know wetin better pass for us. For Chapter 11 we go learn more about this matter. Wetin you think about wetin Adam and Eve do? You think sey na better thing dem do as dem leave wetin God tell dem come do Satan own? Na Jehovah give Adam and Eve everything wey dem get. E give dem better life wey wahala no dey, fine place wey dem dey stay, and better work wey dem dey enjoy. But Satan no do anything for dem. If na you, wetin you for do?
10. Wetin all of us need to choose?
10 Today, our condition be like Adam and Eve own, because we need to choose wetin we go take our life do. We fit choose Jehovah as our King and do wetin e tell us. This one go help us join hand dey show sey na Satan dey lie. Or we fit choose Satan as our king. (Psalm 73:28; read Proverbs 27:11.) The people wey dey do wetin God talk for this world no many. The truth be sey, no be God dey control this world. So if no be God, na who?
WHO DEY CONTROL THIS WORLD?
If to sey all this kingdom no be Satan own, e for talk sey e go dash Jesus all of dem?
11, 12. (a) Wetin we learn from wetin Satan promise Jesus? (b) Which Bible verse show sey na Satan dey control this world?
11 Jesus know the person wey dey control this world. E get the time wey Satan ‘show am all the kingdom wey dey this world and the fine fine things wey dem get.’ Satan come promise Jesus sey: ‘Na you I go give all this things if you bow down and show sey you worship me.’ (Matthew 4:8, 9; Luke 4:5, 6) Think about this question, ‘If to sey all the kingdom no be Satan own, e for talk sey e go dash Jesus all of dem?’ No! So all the government for this world na Satan own.
12 You fit dey ask yourself sey: ‘How Satan come take be the person wey dey control this world? No be Jehovah wey be Almighty God make everything for heaven and earth?’ (Revelation 4:11) Na true sey Jehovah make everything, but wetin Jesus talk show sey na Satan be ‘the person wey dey rule this world.’ (John 12:31; 14:30; 16:11) Apostle Paul sey na Satan be the ‘god of this world.’ (2 Corinthians 4:3, 4) Apostle John come talk for Bible sey ‘na the wicked person dey control the whole world.’—1 John 5:19.
HOW GOD GO TAKE REMOVE SATAN WORLD?
13. Why we need new world?
13 This world dey bad everyday pass before. Dem dey fight war, wayo full everywhere, people dey use God name do bad, people dey fight dey scatter things. No matter wetin human being do, dem no go ever fit comot all this wahala. E no go tey again, God go use Armageddon finish this wicked world, come bring the new world wey only better things and better people go dey.—Revelation 16:14-16; check Endnote 10.
14. Which person Jehovah choose to be King for Im Kingdom? Wetin Bible tell us about Jesus?
14 Jehovah don choose Jesus make e be King for Im Kingdom wey dey heaven. E don tey wey Bible talk sey Jesus go rule as ‘prince of peace’ and im Kingdom go dey forever. (Isaiah 9:6, 7) Jesus tell im disciple make dem pray for the Kingdom, e talk sey: ‘Make your Kingdom come. Make wetin you get for mind for this earth happen as e dey happen for heaven.’ (Matthew 6:10) For Chapter 8 we go learn how God Kingdom go take comot all the government wey dey this world. (Read Daniel 2:44.) God Kingdom go turn this earth to paradise.—Check Endnote 11.
THE NEW WORLD DON NEAR!
15. Wetin be the ‘new earth’?
15 God promise for Bible sey: ‘New heaven and new earth dey, wey we dey wait for’ and ‘na people wey dey do wetin God talk go dey there.’ (2 Peter 3:13; Isaiah 65:17) If Bible talk about ‘earth’ sometimes, na the people wey dey live for this earth e dey talk about. (Genesis 11:1) That one mean sey the ‘new earth’ na all the people wey God don bless because dem do wetin e talk.
16. Which better thing God sey e go give people wey go dey the new world, and wetin we go do if we want get am?
16 Jesus don promise sey people wey go dey the new world go get ‘life wey no go end.’ (Mark 10:30) Wetin we go do if we want dey that new world? Abeg read John 3:16 and 17:3 to get the answer. Now make we come talk about how life go be for paradise.
17, 18. How we take know sey peace go dey everywhere for this earth and sey we no go dey fear again?
17 Wickedness, war, fight fight and people wey no dey obey law no go dey again. Wicked people no go dey this earth again. (Psalm 37:10, 11) God go stop war for the whole world. (Psalm 46:9; Isaiah 2:4) Na people wey love God and people wey dey do wetin e want go full this earth. Peace go dey forever.—Psalm 72:7.
18 Jehovah people no go dey fear again. For Bible time, when Israel people do wetin God talk, dem no dey fear because God dey protect dem. (Leviticus 25:18, 19) For paradise, we no go fear anybody or anything again. God go continue to dey protect us.—Read Isaiah 32:18; Micah 4:4.
19. Why we dey sure sey food go plenty for God new world?
19 Food go plenty for everywhere. ‘Food go plenty for everywhere for this world, e go plenty sotey e go dey trowey for on top mountain.’ (Psalm 72:16) ‘Earth go produce well; Jehovah wey be our God go bless us.’—Psalm 67:6.
20. How you take know sey this earth go be paradise?
20 Everywhere for this earth go be paradise. People go get fine fine house and garden. (Read Isaiah 65:21-24; Revelation 11:18.) Everywhere for this earth go fine like garden of Eden. Jehovah go continue to dey give us wetin we need. Bible talk about God sey: ‘You open your hand, and you dey give everything wey dey alive wetin dem want.’—Psalm 145:16.
21. How we take know sey human being and animal go live together?
21 Human being and animal go dey live together. Animal no go cause wahala for human being again. Small small children no go dey fear all this animal wey we dey fear today.—Read Isaiah 11:6-9; 65:25.
22. Wetin Jesus go do for people wey dey sick?
22 Nobody go sick again. When Jesus dey this earth, e heal sick people. (Matthew 9:35; Mark 1:40-42; John 5:5-9) But as Jesus be King for God Kingdom, e go make sure sey nobody go sick again. Nobody go ever talk sey ‘I dey sick.’—Isaiah 33:24; 35:5, 6.
23. Wetin God go do for people wey don die?
23 People wey don die go come back to life. God don promise sey e go bring people wey don die come back to life. ‘People wey dey righteous and people wey no dey righteous, go come back to life.’—Read John 5:28, 29; Acts 24:15.
24. How you go feel if you dey paradise?
24 All of us free to choose wetin we want do. We fit choose sey we want learn about Jehovah and dey serve am, or we fit choose any other thing wey we like. If we choose sey na Jehovah we go serve, our tomorrow go better. When one man tell Jesus sey make e remember am after e die, Jesus come promise am sey: ‘You go dey with me for Paradise.’ (Luke 23:43) Make we learn more about Jesus and how e go take make wetin God promise happen.