CHAPTER ELEVEN
Why People Dey Suffer?
1, 2. When bad thing happen, wetin be the question wey many people dey ask?
EVERYDAY, we dey hear many bad bad story about the things wey dey happen for this world. For example, water flow enter one village and destroy the village. One man carry gun enter church begin shoot, some people die, some injure. One bad sickness wey dem dey call cancer kill one woman wey get five children.
2 When this kind thing happen, many people dey ask, “Why?” Dem dey always ask why suffer suffer full this world. You don ever ask yourself this question before?
3, 4. (a) Which question Habakkuk ask? (b) How Jehovah take answer am?
3 For Bible, we learn sey even people wey get strong faith still ask this kind question. For example, prophet Habakkuk ask Jehovah sey: ‘Why you dey let bad things dey happen for my front? And why you dey keep quiet when dem dey suffer people? And why quarrel and fight full everywhere?’—Habakkuk 1:3.
4 Jehovah answer the question wey prophet Habakkuk ask. The answer dey Habakkuk 2:2, 3. For there, Jehovah still tell am wetin e go do to correct the matter. Jehovah love people well well. Bible talk sey e dey care for us. (1 Peter 5:7) As we no dey happy to see all this bad bad things wey dey happen, na so God no still dey happy to see dem. (Isaiah 55:8, 9) Now, make we come answer the question, why suffer suffer full this world?
WHY SUFFER SUFFER FULL THIS WORLD?
5. Wetin many religion dey teach people about why we dey suffer? But wetin Bible talk?
5 Pastors, priests, and some people wey dey teach about God dey talk sey God want make we dey suffer. Some people dey talk sey God don sign everything wey go happen for people life, even the bad ones and sey we no go ever fit understand why. Some still talk sey because God want people wey go dey with am for heaven, na im make people and even children dey die. But that one na big lie. Jehovah no dey make bad things happen. Bible talk sey: ‘E no go ever fit come God mind to do wicked things, or sey make the Almighty do wetin bad!’—Job 34:10.
6. Why many people dey blame God for the suffer suffer wey dey this world?
6 Many people dey blame God for all the bad things wey dey happen for this world because dem think sey na God dey rule this world. But for Chapter 3, we learn sey na Satan dey rule this world.
7, 8. Why suffer suffer full this world?
7 Bible talk sey ‘na the wicked person dey control the whole world.’ (1 John 5:19) Satan wey be the person wey dey rule this world wicked finish. E like to dey kill and e ‘dey deceive the whole world.’ (Revelation 12:9) Many people dey even do like am. Na im make people for this world dey lie, hate other people and dem wicked well well.
8 Other reason still dey wey make suffer suffer full this world. All of us don get sin from Adam and Eve. Because of this sin, some people dey make other people suffer. Dem dey always want make dem better pass other people. Dem dey fight, dey go war, and dey make other people fear. (Ecclesiastes 4:1; 8:9) Sometimes things wey we no expect dey happen, and this one dey make people suffer. (Ecclesiastes 9:11) When person dey somewhere for the wrong time, bad thing wey e no expect fit happen to am.
9. Why we dey sure sey Jehovah get better reason why e never comot suffer suffer from this world?
9 Jehovah no dey ever cause wahala for people. So we no suppose dey blame am for all the war, and problem wey we dey see for this world. No be God dey cause bad things like earthquake and heavy rain wey dey destroy things. But you fit ask sey, ‘If na true sey na Jehovah get power pass for heaven and earth, why e never comot suffer suffer from this world?’ We know sey Jehovah dey care for us well well, so we dey sure sey Jehovah get better reason why e never comot am.—1 John 4:8.
WHY GOD NEVER COMOT SUFFER
10. Wetin Satan do for the garden of Eden?
10 Devil deceive Adam and Eve for the garden of Eden. Satan talk sey God no dey try, sey the way e take dey rule no good. E talk sey God dey hide better thing from Adam and Eve. Satan want make dem believe sey im better pass Jehovah, and sey Adam and Eve no need Jehovah.—Genesis 3:2-5; check Endnote 27.
11. Which question we need to answer?
11 Adam and Eve do wetin Jehovah sey make dem no do. Dem think sey dem fit choose wetin dem want do by theirself. How Jehovah take show sey dem no correct and how Jehovah take show sey na im know wetin better pass for us?
12, 13. (a) Why Jehovah no kill Satan, Adam and Eve at once? (b) Why Jehovah leave human being make dem dey rule theirself?
12 Jehovah no kill Adam and Eve at once, but e leave dem make dem born children. Jehovah come allow their children choose who dem want make e dey rule dem. When Jehovah make this earth, e get am for mind sey perfect people go live for this earth. No matter wetin Satan do, e no fit stop Jehovah. Jehovah go still do wetin e get for mind.—Genesis 1:28; Isaiah 55:10, 11.
13 All the angel see am when Satan dey do all this things wey e do. (Job 38:7; Daniel 7:10) So Jehovah come give Satan chance to show if wetin e talk na true. E still give human being time make dem form their own government wey Satan go dey control. This one na to help us see whether human being go fit rule theirself without God.
14. As Jehovah give Satan and human being chance to rule theirself, wetin e don show?
14 E don tey well well since human being dey try rule theirself, but na so so fail dem dey fail. E dey clear now sey Satan na big liar. Human being really need God help! Jeremiah talk sey: ‘E no dey for person hand to direct im way. Person wey dey waka no fit direct imself.’ Wetin Jeremiah talk na really true.—Jeremiah 10:23.
WHY JEHOVAH STILL DEY WAIT SINCE THAT TIME?
15, 16. (a) Why Jehovah still dey wait since that time? (b) Why Jehovah no dey stop bad things if dem want happen?
15 Why Jehovah never still do something about all this suffer suffer? Why e no dey stop bad things if dem want happen? E take time to show sey Satan no go fit rule us well, and e dey clear sey Satan don fail. Human being don try different different type of government, but no one work. Even though sey science fit make life better, bad things still full everywhere. People dey do partial, many people poor, wahala and war dey bad pass before. If God no help us, our own don finish because we no go ever fit rule ourself well.
16 But Jehovah never comot the wahala wey Satan cause. If to sey e dey comot am, e go mean sey e dey support Satan. Jehovah no fit do that kind thing. And human being for believe sey dem fit rule theirself. That one na lie and Jehovah no dey support that kind thing. E no dey lie.—Hebrews 6:18.
17, 18. Wetin Jehovah go do about all the wahala wey Satan don cause?
17 Jehovah go fit comot all the wahala wey Satan and human being don cause? Yes o! Nothing dey hard God to do. Jehovah know when Satan cup go full. After that one, e go turn the earth to paradise, as God want make e be from the beginning. God go bring the ‘people wey dey inside grave’ come back to life. (John 5:28, 29) People no go sick or die again. Jesus go comot all the wahala wey Satan don cause. Jehovah go use Jesus ‘destroy all the work wey Devil do.’ (1 John 3:8) We happy well well sey Jehovah dey patient with us. This one don give the chance to know am and to choose sey we want make e dey rule us. (Read 2 Peter 3:9, 10.) Even though sey we dey suffer, e go help us make we fit bear am.—John 4:23; read 1 Corinthians 10:13.
18 Jehovah no dey force us make we choose am as our King. But e don give us chance to choose how we want live our life. Make we see how we go take use the chance wey Jehovah don give us.
HOW YOU GO USE THE FREEDOM WEY JEHOVAH DON GIVE YOU?
19. Wetin be the better thing wey Jehovah don give us? Why this one be better gift?
19 As Jehovah give us freedom to fit choose wetin we like, e make us different from animal. Animal no fit choose wetin dem want, na how dem see life dem dey live am. But we fit choose how we want make our life be, and whether we go serve Jehovah or we no go serve am. (Proverbs 30:24) And we no be like machine wey dem dey use remote control. E dey our hand to choose the kind person wey we want be, the kind friend wey we want, and wetin we want take our life do. Jehovah want make we enjoy our life.
20, 21. Wetin be the best thing wey you fit do now?
20 Jehovah want make we love am. (Matthew 22:37, 38) E be like papa wey dey happy anytime wey im pikin show am sey e love am with all im mind, no be when dem force am do wetin show sey e love im papa. Jehovah leave us make we choose by ourself whether we go serve am or we no go serve am. Satan, Adam, and Eve no gree serve Jehovah. What of you, you go serve Jehovah?
21 Make you choose well; serve Jehovah. Many people don choose sey dem no go serve Satan, na only Jehovah dem go serve. (Proverbs 27:11) Wetin you go do so that you go dey the paradise after God don comot all the suffer suffer wey dey this world? We go answer this question for the next chapter.