Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 23 p. 60-p. 61 par. 4
  • Israel People Promise Jehovah

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Israel People Promise Jehovah
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • Dem No Do Wetin Dem Promise
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • The Bush Wey Fire Dey
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 23 p. 60-p. 61 par. 4
Israel people stand for front of the mountain wey dey Sinai

LESSON 23

Israel People Promise Jehovah

Two month after Israel people comot from Egypt, dem reach the mountain wey dey Sinai and dem build small tent wey dem go stay. Jehovah call Moses go mountain come tell am sey: ‘Na me save Israel people. If dem obey my law, dem go be my special people.’ As e come down from the mountain, e tell Israel people all the things wey Jehovah talk. Wetin dem come talk? Dem sey: ‘We go do everything wey Jehovah tell us.’

Moses come go the mountain again. Jehovah tell am for there sey: ‘After three days, I go talk to you. Warn the people sey make dem no try am near the mountain.’ Moses come down come tell Israel people sey make dem ready to hear wetin God want talk.

Israel people see lightning and dem see as up dark finish for the mountain wey dey Sinai

When that three days reach, Israel people see lightning and up of the mountain dark finish. Dem still hear loud thunder and horn sound. Na im Jehovah come the mountain like fire. Israel people fear sotey dem come dey shake. The whole mountain come dey shake well well and smoke cover am. But the horn sound dey loud more more. Na that time God come sey: ‘I be Jehovah, make una no try am worship any other god.’

As Moses go the mountain again, Jehovah give am law about how the people go take dey worship am and how dem go dey do things. Moses write the law down and e read am for dem. Dem promise sey: ‘We go do everything wey Jehovah tell us.’ Na true sey dem promise God, but dem go do wetin dem promise?

‘Make you love Jehovah your God with all your heart, all your mind, and all your body.’​—Matthew 22:37

Question: Wetin happen for the mountain? Wetin Israel people promise Jehovah?

Exodus 19:1–20:21; 24:1-8; Deuteronomy 7:6-9; Nehemiah 9:13, 14

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share