Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 47 p. 114-p. 115 par. 3
  • Jehovah Give Elijah Power

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jehovah Give Elijah Power
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • You Don Ever Feel Sey Na Only You Dey and You Come Dey Fear?
    Teach Your Pikin
  • Jehovah Show Sey Na Im Be the True God
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 47 p. 114-p. 115 par. 3
Elijah stand for front of the hole wey dey the mountian for Horeb, as e dey listen to God angel

LESSON 47

Jehovah Give Elijah Power

As Jezebel hear wetin happen to Baal prophet, e come dey vex well well. E come send people go tell Elijah sey: ‘Tomorrow, you go die like Baal prophet.’ As Elijah hear am, e start to dey fear. Na im e run go desert. E come pray sey: ‘Jehovah, I no fit again. Just kill me.’ E come start to dey sleep because e don tire well well.

One angel wake am up, come sofri tell am sey: ‘Get up make you chop.’ Elijah come see one round bread for top of stone. E still see jug of water. E come chop and drink and start to dey sleep again. The angel come wake am again and tell am sey: ‘Chop o! You need power for this waka.’ Elijah come chop again. E come travel for 40 days and 40 night until e reach the mountain wey dey Horeb. As e reach there, e enter one hole go sleep. Jehovah come tell am sey: ‘Elijah, wetin you dey do for here?’ E answer Jehovah sey: ‘Israel people no gree do wetin dem promise you. Dem don scatter your altar and kill your prophet. Now, dem dey try to kill me.’

Jehovah tell am sey: ‘Go stand for the mountain.’ One strong breeze first blow pass the hole. Ground come shake and fire come down. The last thing wey e hear na low voice. E come cover im face with im coat and stand for outside the hole. Jehovah come ask am wetin make am run comot. E talk sey: ‘Na only me remain.’ But Jehovah tell am sey: ‘No be only you dey. I still get 7,000 people for Israel wey worship me. Go make Elisha prophet, make e take over from you.’ Na once e go do wetin Jehovah tell am. You no think sey Jehovah go help you if you dey do wetin e want? Yes o! E go help you well well. Make we see something wey happen that time when rain no fall.

‘No dey worry about anything, but make you dey pray, dey beg God, and still dey thank am for everything, make you tell God that thing wey you want.’​—Philippians 4:6

Question: Wetin make Elijah run for im life? Wetin Jehovah tell Elijah?

1 Kings 19:1-18; Romans 11:2-4

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share