Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • yc lesson 7 pp. 16-17
  • You Don Ever Feel Sey Na Only You Dey and You Come Dey Fear?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • You Don Ever Feel Sey Na Only You Dey and You Come Dey Fear?
  • Teach Your Pikin
  • Similar Material
  • Jehovah Give Elijah Power
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Jehovah Show Sey Na Im Be the True God
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Teach Your Pikin
yc lesson 7 pp. 16-17
One small boy dey feel sey na only im dey and e dey fear

LESSON 7

You Don Ever Feel Sey Na Only You Dey and You Come Dey Fear?

See this small pikin for the picture. E be like sey e dey fear and e dey feel sey na only im dey, no be so? E don ever happen to you before?— E dey happen to people like dat sometimes. Bible tell us about some of Jehovah friend wey feel sey na only dem dey and dem come dey fear. One of dem na Elijah. Make we learn about am.

Queen Jezebel dey shout and e dey vex

Jezebel want kill Elijah

Before dem born Jesus for this world, Elijah don dey stay for Israel for many many years. Ahab wey be the king for Israel that time no dey serve Jehovah. Ahab and im wife, Jezebel, dey serve one juju wey dem dey call Baal. Many people self for Israel come dey serve Baal. Jezebel wicked well well. E want kill all the people wey dey serve Jehovah, even Elijah! You know wetin Elijah do?—

Elijah run go one far place wey be desert. Desert na place wey water no dey. E come go hide for big hole wey dey inside rock. Why you think sey e run go hide?— Na because e dey fear. But Elijah no suppose dey fear because e know sey Jehovah go help am. Before that time, Jehovah don show Elijah sey e get power. E get one time, Jehovah answer Elijah prayer when e send fire from heaven. So Jehovah fit help Elijah now

Jehovah answer Elijah prayer when e send fire from heaven; Elijah dey for hole wey dey inside rock; Elijah dey happy after e hear wetin Jehovah tell am

How Jehovah take help Elijah?

When Elijah dey for the hole, Jehovah talk to am, e ask am sey: ‘Wetin you dey do for here?’ Elijah come answer Jehovah sey: ‘Na only me remain wey dey serve you. Na only me dey and I dey fear sey dem go kill me.’ Elijah think sey dem don kill all the other people wey dey serve Jehovah. But Jehovah tell Elijah sey: ‘No o, no be true. E still get 7,000 people wey dey serve me. No fear. I still get other work wey you go do!’ You think sey Elijah happy to hear that kind thing?—

Wetin you learn from the thing wey happen to Elijah?— Make you no dey feel sey na only you dey and make you no fear. You get many friend wey love Jehovah and wey love you. Make you know sey Jehovah get power well well, and e go help you! You happy to know sey no be only you dey?—

READ AM FOR YOUR BIBLE

  • 1 Kings 19:3-18

  • Psalm 145:18

  • 1 Peter 5:9

QUESTION:

  • Na many people for Israel dey serve Jehovah for Elijah time? Who dem dey serve?

  • Why Elijah run comot go hide for hole wey dey rock?

  • Wetin Jehovah tell Elijah?

  • Wetin you learn from the thing wey happen to Elijah?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share