Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 73 p. 172-p. 173 par. 2
  • John Preach Sey the Messiah Dey Come

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • John Preach Sey the Messiah Dey Come
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • John the Baptist Prepare the Way
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Jesus Come Be Messiah
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • John Want Hear From Jesus
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Jesus Work Dey Increase as John Own Dey Reduce
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 73 p. 172-p. 173 par. 2
John the Baptist dey teach people near river Jordan

LESSON 73

John Preach Sey the Messiah Dey Come

John wey be Zechariah and Elizabeth pikin, come be prophet when e don grow. Jehovah use John teach people sey the Messiah dey come. But instead of John to dey teach people for town or where dem dey worship, e go preach for desert. People dey come from Jerusalem and everywhere for Judea to come learn from am. E teach dem sey if dem want make God happy, dem go stop to dey do bad things. After the people listen to John finish, many of dem come repent. E come baptize dem for river Jordan.

John live simple life. Dem make the cloth wey e dey wear with camel hair. Na grasshopper and honey wey dey bush e dey chop. Many people want know John. Even Pharisee and Sadducee people wey dey carry shoulder, come meet am. John tell dem sey: ‘Make una change the way una dey live una life and repent. Make una no think sey una be special people because una sey una be Abraham pikin. That one no mean sey una be God pikin.’

Many people come ask John sey: ‘Wetin we go do to make God happy?’ John answer dem sey: ‘If una get two coat, make una give one to person wey need am.’ You know why e talk like that? E want make people wey dey listen to am know sey, if dem want make God happy, dem must love other people.

John tell people wey dey collect tax sey: ‘Make una dey talk true and make una no play anybody wayo.’ E tell the soldiers sey: ‘Make una no dey take bribe or talk lie.’

People wey be priest and Levite still ask John sey: ‘Who you be? Everybody want know.’ John answer dem sey: ‘Na me dey talk from desert to help people come serve Jehovah, as Isaiah don talk.’

People like wetin John dey teach dem well well. Many people come dey think whether na John be the Messiah. But John tell dem sey: ‘Person wey pass me dey come. I no even reach person wey go loose im sandal. I dey baptize people with water, but e go baptize people with holy spirit.’

This man come tell people wetin e know about the light, so that different different people fit believe because of am.’​—John 1:7

Question: Wetin make Jehovah send John go meet the people? How people feel when e preach to dem?

Matthew 3:1-11; Mark 1:1-8; Luke 3:1-18; John 1:19-28; Isaiah 40:3

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share