Wetin Dey Part 4
This part talk about Joseph, Job, Moses, and Israel people. All of dem bear the many wahala wey Satan give dem. Some of dem suffer for wetin dem no do, some go prison, some turn slave and some of their family people even die. But Jehovah protect dem no matter wetin happen. If you be papa or mama, help your pikin see how all this people wey serve Jehovah take continue to get strong faith even if dem suffer.
Jehovah punish Egypt people ten times to show sey e get power pass all their gods. Help your pikin see how Jehovah don take protect im people before, and how e take dey do am today.