Wetin Dey Part 5
Two Months after Israel people cross the Red Sea, dem come reach the mountain wey dey Sinai. Na there Jehovah for make agreement with dem sey dem go be special people. Jehovah protect dem and e give dem everything wey dem need. E give dem manna chop, clothe wey no dey tear, and better place wey dem go stay. If you be papa or mama, help your pikin know why Jehovah give Israel people Law, the tabernacle, and people wey be priest. Help dem see sey e good well well to dey do wetin dem promise, dey bring their body down and continue to hold Jehovah tight.