SONG 6
Jehovah Work Dey Praise Am
(Psalm 19)
1. Jehovah God, the things you make dey praise you.
As sun and moon dey shine,
e make us dey see sey
You get deep sense,
na your power big pass.
Even the stars dey show us sey you love us ev’ry day.
2. We love your Word, the Bible wey you give us.
E fit give us advice,
no matter who we be.
And ev’rything wey you talk no dey fail.
Na im make we dey trust your Word.
E fit make us dey free.
3. E good make we obey our God Jehovah.
The advice e dey give
show sey na good Papa.
Dey honor am and no ever leave am.
We go happy and for the end,
we fit live forever.
(Still check Ps. 111:9; 145:5; Rev. 4:11.)