SONG 24
Come Jehovah Mountain
(Isaiah 2:2-4)
1. This na where we go stay
To serve Jehovah our God.
Give am your full support,
Dey work for God ev’ryday.
Try dey do all your best
To go tell people this word:
Come now, ‘come make we go
Jehovah mountain’ today.
Na im house better pass,
E go teach us the truth from Bible,
Make we go, we go gain
If we do all the things wey e talk.
Plenty people dey come,
E show sey God dey bless us.
Make we no ever leave
Jehovah side any day.
2. Jesus sey make we preach,
Make we help people serve God.
Tell dem about the Kingdom
Wey go bring better life.
Jesus Christ na the King,
Better king wey we fit trust.
People wey get better mind
Want do wetin God talk.
I get work, you get work,
Na to go tell people about God.
E dey make us happy,
As new people dey join ev’ryday.
No stop to do this work.
No let anything stop you.
Stay for Jehovah mountain,
No comot any day.
(Still check Ps. 43:3; 99:9; Isa. 60:22; Acts 16:5.)