SONG 35
Dey Do Wetin Dey Important Pass
(Philippians 1:10)
1. E good make we dey use sense do wetin
we know sey we need to do.
Make we dey do the things wey go help us get faith.
Yes, strong faith for God.
(CHORUS)
Think for your mind, wetin God want?
How I go do all this things wey God
want make I dey do?
No take am play.
This things na im dey important pass.
2. To preach the good news about the Kingdom,
Na work wey we need to do.
Make we dey find people wey ready to serve God.
Yes, help dem serve God.
(CHORUS)
Think for your mind, wetin God want?
How I go do all this things wey God
want make I dey do?
No take am play.
This things na im dey important pass.
3. If we dey try dey do the things
wey matter pass, God go give us life.
Even for now, we go dey enjoy peace of mind,
And blessing from God.
(CHORUS)
Think for your mind, wetin God want?
How I go do all this things wey God
want make I dey do?
No take am play.
This things na im dey important pass.
(Still check Ps. 97:10; John 21:15-17; Phil. 4:7.)