SONG 48
Dey Follow God Waka
(Micah 6:8)
1. We go stay near God Jehovah,
We go make sure sey we hold am well.
E be God wey love im children,
E go help us if we hold am well.
So make we try give Jehovah
All our life and do im work.
Pray to God sey you want serve am,
Make you do wetin God dey talk.
2. This world wey we dey go soon end.
Yes, this world wey Satan dey control.
E dey vex am sey we near God,
E dey give us problem ev’rytime.
But Jehovah go dey near us,
If we no leave am comot.
Make we serve our God forever,
No let anything make you stop.
3. God dey give people wey near am
Holy spirit, wey go make dem strong.
We get Bible, we get meeting,
We get prayer, we still get our song.
Make we try dey use all this things
Wey fit help us hold God tight.
And follow God waka well well,
Make we stay near am day and night.
(Still check Gen. 5:24; 6:9; 1 Ki. 2:3, 4.)