Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • sjj song 96
  • Bible Na Better Book From God

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Bible Na Better Book From God
  • “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Similar Material
  • Turn to Jehovah, E Go Save You
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Bless Our Meeting
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Put Mind for Things Wey Get Value
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Jehovah Kingdom Don Dey Rule for Heaven
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
See More
“Use All Your Heart Sing” to Jehovah
sjj song 96

SONG 96

Bible Na Better Book From God

(Proverbs 2:1)

  1. 1. E get one book wey God dey take dey guide us,

    To give us hope and peace of mind today.

    This book go fit help people get better life,

    E fit help people change if dem obey.

    The name of this book na the Holy Bible.

    Jehovah use good people write the book.

    Wetin dem write show sey dem love Jehovah

    Wey use im spirit help dem write this book.

  2. 2. This book dey help us learn about Jehovah,

    And how e take make heaven and the earth.

    This book still show how life for Paradise be,

    And wetin come make this world be like this.

    Na Bible tell us how wahala take start,

    When Satan come talk sey our God dey lie.

    Na this challenge cause trouble and this suffer,

    But Bible talk sey na small time remain.

  3. 3. The time don reach to sing and praise Jehovah,

    For heaven Jesus don dey rule as king.

    So make we preach and teach about the Kingdom,

    And all the blessing Paradise go bring.

    Plenty things dey wey we go gain from Bible,

    Na this better things wey we really need.

    Things wey go fit help us dey serve Jehovah.

    Bible na better book wey we go read.

(Still check 2 Tim. 3:16; 2 Pet. 1:21.)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share