SONG 23
Jehovah Kingdom Don Dey Rule for Heaven
(Revelation 11:15)
1. God Kingdom dey for heaven.
Na Jesus Christ go rule us.
Which other King fit better pass Jesus?
We go enjoy better life!
This wicked world go soon pass.
Praise God and sing,
because Jehovah don bless us.
(CHORUS)
How life go be? E go just dey sweet.
When e go end? E no go end.
How things go be? Trouble no go dey.
Where we go dey? Na Paradise.
Praise Jehovah for im Kingdom,
And im love wey no dey fail.
2. Now Jesus don dey rule us.
E don ready to save us.
This world wey Satan dey rule go soon end.
Come make we go tell people.
Preach sey na small time remain.
Yes, help dem stand well,
Tell dem life go sweet for front.
(CHORUS)
How life go be? E go just dey sweet.
When e go end? E no go end.
How things go be? Trouble no go dey.
Where we go dey? Na Paradise.
Praise Jehovah for im Kingdom,
And im love wey no dey fail.
3. We like as Jesus dey rule.
As God don give am power.
We go support am, na im be our King.
Make we no leave Jehovah.
Pray make e help you stand well.
Time don dey near,
Better life go soon come reach us.
(CHORUS)
How life go be? E go just dey sweet.
When e go end? E no go end.
How things go be? Trouble no go dey.
Where we go dey? Na Paradise.
Praise Jehovah for im Kingdom,
And im love wey no dey fail.
(Still check 2 Sam. 7:22; Dan. 2:44; Rev. 7:15.)