SONG 110
The Joy Wey Jehovah Dey Give
(Nehemiah 8:10)
1. As we dey wait the Kingdom wey go soon come,
Wey we go get better future,
We dey happy, we know sey we go free from
All the wahala for the world!
(CHORUS)
The joy we dey feel na from Jehovah,
Na im dey make us dey happy.
We thank you our God, and we go praise your name,
We go help people see who you be.
The joy we dey feel na from Jehovah,
Na God wey get power e be.
Na im be the God wey we go serve as King,
Make we show am sey we dey happy.
2. We dey happy because Jehovah love us,
We no dey fear, na im we trust.
We love our God, na im make us dey praise am,
So make we sing with all our heart!
(CHORUS)
The joy we dey feel na from Jehovah,
Na im dey make us dey happy.
We thank you our God, and we go praise your name,
We go help people see who you be.
The joy we dey feel na from Jehovah,
Na God wey get power e be.
Na im be the God wey we go serve as King,
Make we show am sey we dey happy.
(Still check 1 Chron. 16:27; Ps. 112:4; Luke 21:28; John 8:32.)