SONG 10
Make We Sing to Our God!
(Psalm 145:12)
1. Make we sing! Make we praise our God!
Make we praise im name, sing to God!
Make we go, make we tell people
Sey Jehovah want change everywhere.
E don set im time, that time don dey near,
Tell people sey make dem come hear.
Na Jesus be King, e go rule this earth,
Na better things we go enjoy!
(CHORUS)
Make we sing! Make we praise our God!
Na better thing to do, make we sing!
2. Make we sing! I go praise my God,
I go sing for am. All my life
Na im own, I go do im work,
I go preach and teach people im Word.
Anytime I pray, my God dey hear me,
E dey give me wetin I need.
E no forget me, e don make me free,
Na my God wey dey answer me.
(CHORUS)
Make we sing! Make we praise our God!
Na better thing to do, make we sing!
(Still check Ps. 89:27; 105:1; Jer. 33:11.)