SONG 115
We Thank God Sey E Dey Wait
(2 Peter 3:15)
1. Jehovah God, the God wey dey wait.
You don dey try show us the way.
Bad things plenty, e full the world.
People dey ask sey, ‘Wey their God?’
You no dey waste time as some dey talk.
Time don dey near as Bible don talk.
(CHORUS)
We get strong hope na you we trust,
We thank you sey you dey care for us.
2. One thousand years go hard us to count.
But na like one day for your eye.
Time don dey near, this world go end.
And you go save only your friends.
You dey happy when bad people change.
You go forgive dem if dem fit change.
(CHORUS)
We get strong hope na you we trust,
We thank you sey you dey care for us.
(Still check Neh. 9:30; Luke 15:7; 2 Pet. 3:8, 9.)