SONG 151
Dem Go Live Again
(Job 14:13-15)
1. Life no dey tey. We fit dey laugh today,
We fit dey cry tomorrow.
Wetin we get no fit give us our life.
Na this one make Bible sey,
If na person die, wey make us dey cry,
See the hope wey God give us:
(CHORUS)
Time dey come, e no go too tey.
Dem go come meet us again.
Na God go bring dem come back.
Na wetin e want be that.
Clean your tears, make you get strong faith.
Na Jehovah tell us sey,
This things wey e don tell us,
No go fail, time don dey reach.
2. God no dey fail. E no go fit forget
The people wey no leave am.
E tell us sey na sleep dem just dey sleep.
E talk sey e go wake dem.
We no go forget this hope wey we get.
This hope wey dey give us rest.
(CHORUS)
Time dey come, e no go too tey.
Dem go come meet us again.
Na God go bring dem come back.
Na wetin e want be that.
Clean your tears, make you get strong faith.
Na Jehovah tell us sey,
This things wey e don tell us,
No go fail, time don dey reach.
(Still check John 6:40; 11:11, 43; Jas. 4:14.)