Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 May pp. 13-17
  • How You Dey Choose Wetin You Go Do?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • How You Dey Choose Wetin You Go Do?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • WETIN WE CHOOSE FIT AFFECT US AND OTHER PEOPLE
  • KNOW WETIN JEHOVAH WANT
  • HOW YOU GO TAKE KNOW WETIN JEHOVAH THINK?
  • MAKE THE WAY JEHOVAH DEY THINK HELP YOU
  • Your Faith Go Help You Choose Wetin Good
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 May pp. 13-17
One woman dey read Bible and e dey think about the road wey e go pass

How You Dey Choose Wetin You Go Do?

‘Always dey try know wetin Jehovah want.’​—EPH. 5:17.

SONG: 69, 57

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • How e be sey wetin we choose fit affect us and other people?

  • How we go take know wetin Jehovah want make we do for matter wey Bible law no dey?

  • Wetin go help us know how Jehovah dey think?

1. Wetin be some of the law wey dey Bible, and wetin we don gain as we dey do dem?

FOR Bible, Jehovah don give us different different law wey dey tell us wetin Jehovah want make we do. For example, Jehovah don tell us sey make we no serve juju, thief, or dey drink too much. E no want make we sleep with anybody wey no be our husband or wife. (1 Cor. 6:9, 10) Apart from that one, Jesus Christ wey be God Pikin give im disciple dem one better work wey no easy. E sey: ‘Make una go make people my disciple for the whole world. Take the Father, Son and holy spirit, name dey baptize dem, dey teach dem to do everything wey I don command una. And see! I dey with una everytime go reach when the world go end.’ (Matt. 28:19, 20) Jehovah law good for our body! As we dey do all this things, e don make us better people, we no dey carry sickness because of bad life and e dey add join wetin dey make our family happy. The one wey better pass be sey, as we dey do wetin Jehovah tell us and as we dey preach, e don bless us and we don be im friend.

2, 3. (a) Wetin make Bible no give us law for some kind matter? (b) Which question we go answer for this topic? (Check the first picture.)

2 But no be for everything Bible give us law. For example, Bible no tell us the style wey we go sew or the kind material wey we go use sew am. This one show sey Jehovah really get sense. How? One thing be sey all the different different people for this world, get how dem dey dress. Even self, different different style dey come out every day. If to sey Bible tell us the style wey we go sew or how we go dress, by now that one for don be old school. Na this one still make God no tell us the kind work wey we go do; the kind film wey we go watch; or even the medicine wey person go take if e dey sick. So na we go choose wetin we go do for this matter, and if na for family na papa go choose.

3 You think sey this one mean sey we fit do anything wey we like or sey wetin we do no concern Jehovah? Even if Bible no condemn wetin we want do, Jehovah go happy if we do am? How we go know sey the thing wey we want do good for Jehovah eye?

WETIN WE CHOOSE FIT AFFECT US AND OTHER PEOPLE

4, 5. How e be sey wetin we choose fit affect us and other people?

4 Some people think sey wetin dem choose no go affect anybody. But if we want choose the kind thing wey go make Jehovah happy, make we check wetin Bible talk about the matter and do am. For example, if we want be Jehovah friend, we must do wetin e talk about blood. (Gen. 9:4; Acts 15:28, 29) E good make we pray make Jehovah help us fit do wetin Bible talk.

5 Anything wey we choose fit affect us. If we choose well, e go make us fit near Jehovah well well but if we no choose well, e go make us be Jehovah enemy. Another thing be sey, the bad thing wey we choose fit make other people stop to serve Jehovah and e fit even cause wahala for inside congregation. Na im make e good make we think about any matter well before we choose wetin we go do.—Read Romans 14:19; Galatians 6:7.

6. Wetin we go get for mind if we want choose wetin we go do?

6 If we want do something and no law for Bible tell us how we go do am, wetin we go do? When e be like that, na our hand e dey to think the matter well well before we choose wetin we go do. Make we no just do wetin we like, but make we do the kind thing wey go make Jehovah happy and wey go make am bless us.—Read Psalm 37:5.

KNOW WETIN JEHOVAH WANT

7. For matter wey Bible law no dey, how we go take know wetin Jehovah want?

7 You fit dey think sey, ‘How we go take know wetin go make Jehovah happy for matter wey Bible law no dey?’ Ephesians 5:17 talk sey: ‘Always dey try know wetin Jehovah want.’ How we go take know the kind thing wey God want? Na if we dey pray to am and we let im holy spirit direct us.

8. How Jesus take show sey e know wetin Jehovah want make e do? Give example.

8 Make we see how Jesus take know wetin im Papa want make e do. Na two times Bible tell us sey before Jesus do miracle wey e take give plenty people food, e first pray. (Matt. 14:17-20; 15:34-37) But the time wey Devil come tell am sey make e change stone to bread when e dey hungry, e no gree. (Read Matthew 4:2-4.) Because e know how im Papa dey think, na im make e know sey e no suppose do am. E know sey the power wey im Papa give am no be to take am help imself. Wetin Jesus do show sey e want make Jehovah direct am and e get hope sey Jehovah go give am wetin e need.

9, 10. Wetin go help us do wetin good for any matter? Give example.

9 Like Jesus, we self go fit do wetin good if we let Jehovah direct us. E good make we follow wetin Bible talk when e sey: ‘Take all your mind trust Jehovah, no put mind for wetin you think sey you sabi. For everything wey you dey do, put Jehovah for mind and e go make your way smooth. No dey think for your mind sey you sabi everything. Make you fear Jehovah and comot hand for bad thing.’ (Prov. 3:5-7) We go know how Jehovah dey think if we dey study Bible. This one go help us know wetin we fit do for the matter wey we no see any law for Bible wey talk about am. The more we dey sabi how Jehovah dey think, the more we go know wetin e want make we do for any matter.—Ezek. 11:19, ftn.

10 For example: Think am sey one woman wey don marry go market. As e reach market, e come see one fine shoe wey e for like buy, but the shoe cost well well. So e come dey think for im mind sey, ‘How my husband go feel if I take this plenty money buy only one shoe?’ Even though sey im husband no dey there, e no go buy am. Why? As e don tey wey dem marry, e already know sey im husband no go want make e spend money like that. Na so e still be with us and Jehovah. The more we dey learn about Jehovah, the more we go know how e dey think and how e dey do things. Na this one dey make us fit know wetin our Papa for heaven want make we do for different different matter.

HOW YOU GO TAKE KNOW WETIN JEHOVAH THINK?

11. Which question we fit ask ourself when we dey read or study Bible? (Check the box “When You Dey Study Bible, Make You Ask Yourself.”)

11 To know wetin Jehovah think, we must do personal study. When we dey read or dey study Bible, e good make we ask ourself this kind question, ‘Wetin this place wey I read teach me about the kind person wey Jehovah be, how e dey do things and wetin e think?’ E good make we still get the kind mind wey David get when e tell Jehovah sey: ‘Jehovah, abeg o, help me make I fit sabi how you dey do things, show me your road. Carry me waka for that road wey your truth dey and make you teach me, because na you be the God wey dey save me. Na for your side I dey put mind every day.’ (Ps. 25:4, 5) When you dey think about where you read for Bible, you fit ask yourself: ‘How I fit do this thing for my family? Where I fit do am? Na for house? For work? For school? Or for preaching?’ If we know where we fit do am, e no go hard us to know how we go do am.

12. How our book dem and our meeting fit help us sabi how Jehovah dey think for any matter?

12 Another thing wey go help us know how Jehovah dey think na to put ear for the things wey im organization dey teach us from Bible. For example, we get this book wey be Watch Tower Publications Index and Research Guide for Jehovah’s Witnesses. This two book go help us know how Jehovah dey think about different different matter so that we fit know wetin we go do. Our meeting still dey help us if we dey put mind for all the things wey brothers and sisters dey talk for meeting and if we dey answer question. As we dey think about wetin we dey learn na so we go dey sabi how Jehovah dey think. As we dey use all this things wey Jehovah don give us, e go make us sabi more more how e dey do things. That one go make us fit choose the kind thing wey go make Jehovah bless us.

MAKE THE WAY JEHOVAH DEY THINK HELP YOU

13. Give one example wey show why e be sey if we know how Jehovah dey think, we go fit choose the correct thing.

13 The way Jehovah dey think fit help us do wetin go make am happy. How? For example: Maybe we want pioneer, na im we come start to arrange things for our life so that nothing go disturb us when we start. But we fit dey fear because we no know whether we go really happy as we want make our life simple. Na true sey Bible no talk sey we must pioneer; we fit still dey serve Jehovah as publisher. But make we no forget wetin Jesus talk, sey Jehovah go bless us well well for anything wey we leave to support im Kingdom. (Read Luke 18:29, 30.) Another thing be sey Bible still tell us sey Jehovah dey happy as we dey praise am and if we dey use all our mind work for am. (Ps. 119:108; 2 Cor. 9:7) If we pray about this matter and think am well before we choose, Jehovah go help us do wetin go make am bless us.

14. How you go take know wetin Jehovah want make you do about the kind clothe wey you dey like?

14 Make we see another example. Maybe e get one style of clothe wey you like, but you don see am sey some brothers and sisters for your congregation fit no like am. And e no get anywhere for Bible wey talk sey make person no sew that kind clothe. So how you go take know wetin Jehovah want make you do for this matter? Bible talk sey: ‘Make woman dey wear better clothe wey go show sey dem get sense and dem no dey overdo am, no be to dey plait different different hairstyle or to dey wear gold or clothe wey cost well well but make dem dey dress theirself with better character like woman wey dey fear God.’ (1 Tim. 2:9, 10) But this advice no be only for sisters. As people wey dey serve Jehovah, we suppose to dey think about how our dressing go make other people feel. If we get this one for mind plus the love wey we get for our brothers, e go make us no do wetin go disturb dem for mind or vex dem. (1 Cor. 10:23, 24; Phil. 3:17) If we dey think about wetin Bible talk, e go help us fit know wetin Jehovah want make we dey do and e go help us fit choose wetin e like.

15, 16. (a) How Jehovah dey feel if we dey think about how we go take sleep with person wey no be our husband or wife? (b) Wetin go fit help us know wetin go make Jehovah happy, for the kind book wey we dey like to read, video game wey we dey like to play, or film wey we dey like to watch? (c) Wetin we go do for matter wey hard us?

15 Bible show sey Jehovah no dey happy to see people wey like to do bad things and wey bad thing full their mind. (Read Genesis 6:5, 6.) This one help us know sey we fit enter big wahala if we dey think about how we go take sleep with person wey no be our husband or wife. Jehovah no want make we dey think about this kind thing. The disciple wey be James write for Bible sey: ‘The sense wey God dey give, first, e pure, e like peace, e get open mind, e ready to do wetin dem tell am, e dey pity person and sabi do good, e no dey do partial, e no dey play wayo.’ (Jas. 3:17) When we sabi this one, e go help us make we no dey watch the kind film wey go make us start to think bad thing. If we know how Jehovah dey think for any matter, that one go help us fit know the kind book, film or video game wey Jehovah no like. We no go wait make person tell us before we know sey Jehovah no like that kind thing. Because Bible tell us wetin Jehovah like and wetin e no like.

16 Different way dey wey we fit do things wey go make Jehovah happy. But if e get matter wey hard us to know wetin we go do, we fit meet elders for congregation make dem advice us or brothers and sisters wey don mature. (Titus 2:3-5; Jas. 5:13-15) This one no mean sey na dem go choose for us. So e good make we dey think about wetin Bible talk before we choose wetin we go do. (Heb. 5:14) E good make all of us do wetin Paul talk. E sey: ‘Everybody go carry im own load.’—Gal. 6:5, ftn.

17. Wetin we go gain if we choose wetin go make Jehovah happy?

17 If we sabi wetin Jehovah think and we use am choose wetin we go do, e go make us near am. (Jas. 4:8) This one go still make am bless us and our faith go dey strong. So make we dey let the things wey dey Bible help us fit choose the correct thing, because na from Bible we fit know wetin Jehovah dey think about any matter. True true, we no go fit learn everything about Jehovah finish. (Job 26:14) But if we put all our mind now to learn the kind thing wey Jehovah want, we go fit get good sense and deep sense to choose wetin go make am happy. (Prov. 2:1-5) As e be sey sin dey our body, the things wey we get for mind to do fit change. But Jehovah own no be like that. Bible talk sey: ‘The thing wey Jehovah get for mind to do no fit change; wetin e want do go dey forever.’ (Ps. 33:11) We don see am sey, we go really fit choose the thing wey good for us if we dey think the way Jehovah dey think.

WHEN YOU DEY STUDY BIBLE, MAKE YOU ASK YOURSELF:

One woman dey read Bible

Wetin this one dey teach me about how Jehovah dey do things? (Ps. 25:4)

How I fit use wetin I don learn . . .

  • for house?

  • for work?

  • for school?

  • for preaching?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share