Jehovah Dey Arrange Im People as Bible Talk
‘Jehovah use sense make the earth. E make heaven well with deep sense.’—PROV. 3:19.
SONG: 105, 107
1, 2. (a) Wetin some people dey talk when dem hear sey God get organization? (b) Wetin we go talk about for this topic?
GOD get organization? Some people fit talk sey, “You no need any organization to direct you. Wetin you need na to be God friend.” Wetin dem talk correct? Wetin we fit learn from the truth about this matter?
2 For this topic, we go talk about wetin show sey Jehovah, wey be the God of order dey arrange things pass anybody. We go still talk about wetin we go do if Jehovah organization sey make we do something. (1 Cor. 14:33, 40) From the apostle time come reach our time, God Word don help Jehovah organization for this earth to dey preach the good news for everywhere. Because we dey do wetin Bible talk and obey everything wey Jehovah organization sey make we do, we dey make all the congregation clean, get peace and one mind.
JEHOVAH NA GOD WEY DEY ARRANGE THINGS
3. Why you believe sey nobody fit arrange things like Jehovah?
3 Everything wey God make show sey nobody fit arrange things like am. Bible talk sey; ‘Jehovah use sense make the earth. E make heaven well with deep sense.’ (Prov. 3:19) Na only ‘small for wetin e dey do’ we know, and ‘na only small we don hear about am.’ (Job 26:14) But, the small thing wey we know about planet, star, and galaxies (different different group of star wey dey together) dey make us talk sey dem arrange am well. (Ps. 8:3, 4) All this plenty star no dey jam each other as dem dey move. Even self, the way the different different planet dey go round the sun be like when motor dey obey traffic law. True true, the way Jehovah arrange everything wey e make, help us see sey we suppose dey praise, worship and hold am tight because e make heaven and earth well.—Ps. 136:1, 5-9.
4. Why e be sey science never fit answer many question?
4 Science people don learn many things about wetin God make. And dem don use am make life better for us. But science never fit answer many question wey dey worry people for mind. For example, people wey dey study things wey dey outside this earth, no go fit tell us how things take come or why we and other things wey get life dey this earth. And many people no go fit explain why e be sey everybody want enjoy life wey no get end. (Eccl. 3:11) Why people never fit find answer to all this many better question? One thing be sey science and other people dey make people think sey God no dey and sey life come by imself. But for Bible, Jehovah answer many question wey dey worry people for mind.
5. Wetin show sey we need to follow wetin Jehovah don arrange?
5 Jehovah get how e take arrange everything wey e make and how e take arrange dem no dey change. Doctor wey dey do operation, electrician, plumber, engineer and pilot dey follow wetin Jehovah don arrange when dem dey do their work. For example, doctor wey dey do operation dey fit do im work well because the way human being body be no dey change. This one mean sey the doctor no go come dey find where the person heart dey for im body. And all of us dey follow how God take arrange things. For example, we no go try jump from high place because we know sey we go fall and we fit die.
NA GOD ARRANGE AM
6. Wetin show sey Jehovah want make im people dey do things well?
6 The way heaven and earth be, show sey Jehovah dey arrange things well. That one mean sey e want make people wey dey worship am dey do things well. Na that one even make Jehovah give us Bible to help us. We for no dey happy and we for tire for our life if to sey God organization no dey direct us.
7. Wetin show sey dem arrange Bible well?
7 Bible no be book wey join two story wey no connect about Jew people and Christian. But na book wey holy spirit help people write and dem arrange am well. The different different book for Bible connect to each other. Genesis to Revelation talk about one main topic. The topic be sey: Na Jehovah get right to rule and sey e go use im Kingdom wey Jesus go be King take make all the things wey e don promise happen.—Read Genesis 3:15; Matthew 6:10; Revelation 11:15.
8. Why we fit talk sey God arrange Israel people well?
8 Israel people na better example of people wey God arrange well. For example, for the Law wey God give Moses, e get some ‘women wey dem arrange to work for front of the tent of meeting.’ (Ex. 38:8) Dem still get Law wey help dem to arrange the tabernacle and their camp well as dem dey waka from place to place. Later, King David arrange the Levite and priest for different different group to do their work well. (1 Chron. 23:1-6; 24:1-3) And when Israel people obey Jehovah, e bless dem. E arrange dem well, give dem peace, and one mind.—Deut. 11:26, 27; 28:1-14.
9. Wetin show sey God arrange the congregation for the apostle time well?
9 God arrange the congregation for the apostle time well, and dem gain from everything wey the governing body sey make dem do. Na only the apostles first be the governing body. (Acts 6:1-6) Later, other brothers join dem. (Acts 15:6) The governing body and other brothers wey dey work with dem still send letter wey dem write to all the congregation, to tell dem wetin dem go dey do. (1 Tim. 3:1-13; Titus 1:5-9) Wetin all the congregation gain, when dem do wetin the governing body talk?
10. Wetin happen when congregation for the apostle time do wetin the governing body talk? (Go check the first picture.)
10 Read Acts 16:4, 5. Brothers wey the governing body dey send go congregation dey tell the congregation to follow, the ‘law wey the apostle dem and the elders for Jerusalem don agree sey make dem follow.’ As all the congregation dey do wetin the governing body talk, dem ‘continue to dey strong for faith and dem come dey plenty every day.’ Wetin we fit learn from their example wey go help us for Jehovah organization today?
YOU DEY DO WETIN JEHOVAH ORGANIZATION TALK?
11. If Jehovah organization tell brothers wey dey lead sey make dem do something, wetin dem suppose do?
11 If Jehovah organization tell Branch Committee or Country Committee, circuit overseer, and congregation elders sey make dem do something, wetin dem go do? God Word tell all of us sey make we dey obey. (Deut. 30:16; Heb. 13:7, 17) People wey dey Jehovah organization no suppose dey complain or do stubborn head, because that kind character fit spoil the love, peace and one mind wey dey all our congregation. The truth be sey, no better Christian want be like Diotrephes wey no get respect and wey no dey support Jehovah organization. (Read 3 John 9, 10.) E good make we ask ourself: ‘I dey do wetin go make people wey dey around me serve Jehovah well? I dey quick obey and support brothers wey dey lead us?’
12. Which new way dem take dey choose elder or ministerial servant now?
12 Think about one new thing wey the Governing Body don talk. For the topic “Question From People Wey Dey Read Our Book” for November 15, 2014 Watchtower (for English), dem tell us the new way to choose person as elder or ministerial servant. For that topic, we see sey the governing body for the apostle time give people wey be circuit overseer that time, the power to choose elders and ministerial servant. Na im make, since September 1, 2014, na circuit overseer dey choose elders and ministerial servant. The circuit overseer go try know the brothers wey elders don see sey dem reach to be elder or ministerial servant, and e fit work with dem for preaching. E go still look whether the brother family dey do well. (1 Tim. 3:4, 5) The elders and the circuit overseer go take time check whether the brother dey do wetin Bible talk sey make people wey want be elders and ministerial servant dey do.—1 Tim. 3:1-10, 12, 13; 1 Pet. 5:1-3.
13. How we fit show sey we dey follow elders advice?
13 We need to dey do wetin elders dey tell us from Bible. Na ‘the correct thing’ wey dey God Word dey direct the elders wey dey Jehovah organization. (1 Tim. 6:3; ftn.) Remember wetin Paul talk about people for congregation wey no dey do wetin Bible talk. Some of dem no dey support for congregation at all, but dem dey put mouth for wetin no concern dem. Elders go don advice dem, but dem no gree take the advice. Which kind eye the congregation go take dey look that kind person? Paul talk sey: ‘Mark the person and stop to dey do things with am.’ That one no mean sey we go take the person as enemy. (2 Thess. 3:11-15) For example, if one brother or sister dey friend person wey no be Jehovah witness and elders don warn am but e no hear, elders fit use talk warn the congregation about the person bad character wey dey spoil the congregation name. (1 Cor. 7:39) How you go behave if elders give that kind talk? If you and that person dey do things together before, you go continue to dey do things with am? If you follow wetin Bible talk, e fit help the person change.[1]
JOIN HAND MAKE CONGREGATION CLEAN, GET PEACE AND ONE MIND
14. How we go take join hand to make the congregation clean?
14 We fit make the congregation clean for Jehovah eye if we dey follow Bible advice. Think about wetin happen for Corinth. Paul use all im power preach for that town, and e love other ‘holy people’ for there. (1 Cor. 1:1, 2) But how you think sey Paul go feel when e hear sey the congregation dey allow sex wey no clean for God eye! Paul tell the elders sey make dem give the person to Satan, this one mean sey dem go disfellowship am. To continue to make the congregation clean, elders need to comot that person. (1 Cor. 5:1, 5-7, 12) If elders disfellowship the person, and we support dem, we go join make the congregation clean and e fit make the person come back to Jehovah.
15. Wetin we go do so that peace go dey our congregation?
15 Another problem still dey the congregation for Corinth. Some brothers for the congregation dey drag theirself go court. The question wey Paul ask dem, make dem think. E ask dem sey why dem no let person do dem bad. (1 Cor. 6:1-8) That kind thing still dey happen today. Sometimes, brothers for congregation dey quarrel because when dem do business together and dem lose money, dem fit dey think sey the other brother play dem wayo. Some brothers don drag theirself go court. But Bible help us see sey instead make we spoil Jehovah name or scatter the peace wey dey our congregation, e better make we lose.[2] If we want solve serious problem, e good make we follow Jesus advice. (Read Matthew 5:23, 24; 18:15-17.) If we follow Jesus advice, we dey join hand to make the congregation get one mind.
16. Why Jehovah people get one mind?
16 Bible help us know why Jehovah people get one mind. One of the people wey write psalm, talk sey, ‘See! E good and e sweet for brothers to dey together as one!’ (Ps. 133:1) When Israel people obey Jehovah, dem dey live together and dey do things well. When God dey talk about wetin go happen to im people, e talk sey: ‘I go make dem one, like sheep wey dey one place.’ (Mic. 2:12) Jehovah still use prophet Zephaniah talk sey: ‘I go change the people language to pure language [about wetin dey Bible], so that all of dem fit call Jehovah name, to serve am as one [or, “worship am with one mind,” ftn.].’ (Zeph. 3:9) We dey thank Jehovah because e give us the chance to dey worship am together as one.
Elders dey do everything wey dem fit do to help person wey do bad thing (Check paragraph 17)
17. How elders go handle matter if dem want make the congregation clean and get one mind?
17 If elders want make congregation dey clean and get one mind, dem no go waste time to handle matter for congregation and dem go do am with love. Paul know sey even though sey God love us, e no dey trowey face when we dey do bad thing. (Prov. 15:3) So even if Paul love the brothers for the congregation wey dey Corinth, e still correct dem for im first letter. For the second letter wey e write after some months, e clear sey the brothers don dey try, because the elders follow wetin e talk. If anybody for congregation do bad thing, make elders sofri help am.—Gal. 6:1.
18. (a) How the advice wey dey Bible take help congregation for the apostle time? (b) Wetin we go talk about for the next topic?
18 E clear sey the advice wey dey Bible help Christians for Corinth and other place to continue to dey clean, get peace and one mind for congregation. (1 Cor. 1:10; Eph. 4:11-13, ftn.; 1 Pet. 3:8) Because of that one our brothers and sisters that time, come dey try well well for preaching. Na im make Paul fit talk sey, ‘dem don preach for the whole world.’ (Col. 1:23) Today, because people wey dey Jehovah organization get one mind, dem dey preach the goodnews for the whole earth. The next topic go help us see other things wey show sey Jehovah people value Bible well well and sey dem ready to worship Jehovah as their King.—Ps. 71:15, 16.
^ [1] (paragraph 13) Check Organized to Do Jehovah’s Will, pp. 134-136.
^ [2] (paragraph 15) If you want see wetin fit make Christian carry im brother for congregation go court, check “Keep Yourselves in God’s Love,” p. 223, ftn.