Jesus Sacrifice Na Gift From Jehovah
‘Every gift wey good and every gift wey complete na from the Father.’—JAS. 1:17.
1. Which better things we fit enjoy because of Jesus sacrifice?
WE FIT enjoy many better things because Jesus die for us. Because of am, everybody wey dey do wetin God want fit come be part of God family. We fit still enjoy life wey no go end. Jesus sacrifice no go only make our tomorrow better. But e use am settle matter wey concern heaven and earth because e use im mind come die, and e no stop to do wetin God want.—Heb. 1:8, 9.
2. (a) Which matter wey concern heaven and earth dey for Jesus prayer? (Check the first picture.) (b) Wetin we go learn for this topic?
2 Around two years before Jesus die, e teach im disciples to pray sey: ‘Our Father wey dey heaven, make your name dey holy. Make your Kingdom come. Make wetin you get for mind happen for heaven and this earth.’ (Matt. 6:9, 10) Make we come learn how Jesus death make God name dey holy, how e go make people fit rule for God Kingdom and enter paradise, and how e go make God do wetin e get for mind. This one go help us see more more sey, na big thing God and im Son do for us.
‘MAKE YOUR NAME DEY HOLY’
3. Wetin Jehovah name show, and how Satan take spoil that holy name?
3 The first thing wey Jesus talk for im prayer na make God name dey holy. Jehovah name dey show the kind Person wey e be. Na im be the King wey get power pass and wey holy pass. For another of Jesus prayer, e still call Jehovah ‘Holy Father.’ (John 17:11) Because Jehovah holy, im law and everything wey im dey talk dey holy. Even with this one, Satan use style talk for garden of Eden sey God no get right to give human being law. E use this lie spoil God holy name.—Gen. 3:1-5.
4. How Jesus take make God name clean when e dey this world?
4 But Jesus no be like Satan; e like Jehovah name well well. (John 17:25, 26) Wetin Jesus do when e dey this world, na part of wetin make God name clean. (Read Psalm 40:8-10.) When Jesus dey earth, e do everything wey Jehovah talk. The way e take live im life show sey, na better thing for Jehovah to give angels and human being law. Even when Satan make people suffer Jesus well well before dem kill am, Jesus still do wetin im Father want. Jesus example show sey person wey no get sin for body fit continue to do wetin Jehovah talk.
5. How we fit make God name dey holy?
5 How we go take show sey we like Jehovah name well well? Na our character. Jehovah want make our character holy. (Read 1 Peter 1:15, 16.) This one mean sey we go serve only Jehovah and nobody go force us do wetin e want. Even when dem dey suffer us, we go do everything wey we fit do to follow wetin Jehovah talk for Bible. Our good character go be like light wey dey shine, so that people go see am and dem go praise Jehovah holy name. (Matt. 5:14-16) As people wey dey serve Jehovah, make the way we dey live our life show sey Jehovah law good and wetin Satan talk na lie. E no get who no dey do mistake. But, when we do mistake, make we use all our mind repent and stop to do things wey dey spoil Jehovah name.—Ps. 79:9.
6. Even though we get sin for body, why Jehovah fit call us righteous people?
6 Because Jesus die for us, Jehovah dey forgive the sin of people wey show sey dem get faith for the sacrifice. E dey welcome people wey want use their life serve am come im organization. Jehovah talk sey the people wey e choose with im spirit dey righteous and dem be im children. And the ‘other sheep’ wey go stay for this earth dey righteous and dem be im friend. (John 10:16; Rom. 5:1, 2; Jas. 2:21-25) So even now, Jesus sacrifice fit make us dey righteous for God eye and we fit make God name dey holy.
‘MAKE YOUR KINGDOM COME’
7. For God Kingdom, which better things Jesus death go bring?
7 The second thing wey Jesus tell God for the prayer na: ‘Make your Kingdom come.’ How Jesus death fit make people rule for God Kingdom and enter paradise? Na Jesus sacrifice go make 144,000 people fit be king and priest with Jesus for heaven. (Rev. 5:9, 10; 14:1) Jesus and the 144,000 people go form God Kingdom or government, and dem go rule for one thousand years. That time, dem go make people see the plenty better things wey Jesus sacrifice go bring for people wey follow God. This earth go turn to paradise. Everybody wey do wetin God talk no go get sin for body again. God family for heaven and earth go be one. (Rev. 5:13; 20:6) Jesus go destroy Satan and e go comot all the bad things wey Satan don cause.—Gen. 3:15.
8. (a) How Jesus take help im disciples see sey people need to learn about God Kingdom? (b) How we fit show sey we support God Kingdom today?
8 When Jesus dey this world, e make im disciples see sey people need to learn about God Kingdom. After e just baptize, Jesus start to preach ‘the good news about God Kingdom’ for place wey far and near. (Luke 4:43) Jesus command im disciples make dem tell people about am ‘go reach where far pass for this world.’ Na the last thing wey e tell dem before e go heaven be that. (Acts 1:6-8) Na the preaching work go make people for everywhere fit learn about Jesus sacrifice and how dem fit enter God Kingdom. We dey show sey we support God Kingdom today, when we dey follow people wey go join Jesus rule dey preach about God Kingdom for the whole world.—Matt. 24:14; 25:40.
‘MAKE WETIN YOU GET FOR MIND HAPPEN’
9. Why we dey sure sey Jehovah go do wetin e get for mind for us?
9 Wetin Jesus mean when e come talk sey: ‘Make wetin you get for mind happen’? Na Jehovah make everything. Anything wey Jehovah talk must happen. (Isa. 55:11) E no go let wetin Satan do change wetin E get for mind for us and the earth. From beginning, Jehovah want make Adam and Eve children wey no get sin full the whole world. (Gen. 1:28) If Adam and Eve no born pikin before dem die, wetin God get for mind about their children no go happen. Na im make, after Adam and Eve sin, Jehovah allow dem born children. Na Jesus sacrifice God go use take comot sin from people wey show sey dem get faith. Na im e go still use give dem life wey no go end. Jehovah love people wey dey do wetin e talk. E want make dem enjoy the kind life wey e get for mind from beginning.
10. Which good thing Jesus sacrifice go do for people wey don die?
10 What about many people wey no fit know Jehovah and wey no serve am before dem die? Jesus die for dem. So Jehovah, our Father wey get love, go bring dem come life again. E go allow dem learn about wetin e get for mind and how dem fit get life wey no go end. (Acts 24:15) Jehovah no want make people die but, e want make dem get life. Since na im dey give life, e go be the Father of everybody wey go resurrect. (Ps. 36:9) Na im make Jesus teach us make we pray to Jehovah as ‘our Father wey dey heaven.’ (Matt. 6:9) Jehovah don give Jesus Christ the work to bring people wey don die come life again. (John 6:40, 44) For Paradise, Jesus go do the work wey Jehovah don give am, to ‘resurrect and give life’ to people.—John 11:25.
11. Wetin God get for mind to do for the ‘great crowd’?
11 No be just some people Jehovah go select to enjoy the better things wey e get for mind to do. Wetin Jesus talk show sey that one na true. E sey: ‘Anybody wey dey do wetin God want, na im be my brother and sister and mama.’ (Mark 3:35) Jehovah want make people from all the country and language come serve am. Dem go be ‘great crowd’ wey nobody fit count. People wey show sey dem get faith for Jesus sacrifice and wey do wetin God want, go dey among the people wey go shout sey: ‘Our God wey sitdown for the throne, and the Lamb, na una save us.’—Rev. 7:9, 10.
12. How Jesus prayer take make us know wetin Jehovah get for mind for people wey obey am?
12 Jesus prayer make us know wetin Jehovah get for mind for people wey obey am. Make we do everything wey we fit do to make Jehovah name holy, as Jesus talk for the prayer. (Isa. 8:13) Wetin Jesus name mean na, “Jehovah Dey Save.” Jehovah go use Jesus sacrifice take save us so that im name go dey holy. God go use im Kingdom take make people get the better things wey Jesus sacrifice go do for dem. True true, Jesus prayer make us dey sure sey nothing fit make Jehovah no do wetin e get for mind.—Ps. 135:6; Isa. 46:9, 10.
SHOW SEY YOU LIKE WETIN JEHOVAH AND JESUS DO
13. Wetin our baptism dey show?
13 One way wey we take dey show sey we value Jesus sacrifice, na when we tell Jehovah for prayer sey we don ready to use our life serve am. After that one, we go come baptize. Our baptism go show sey ‘we be Jehovah own.’ (Rom. 14:8) When we baptize we dey tell Jehovah to give us clean mind. (1 Pet. 3:21) Jehovah go use Jesus blood take do wetin we tell am. We dey sure sey e go give us everything wey e promise.—Rom. 8:32.
How we go take show sey we like wetin Jesus do? (Check paragraph 13, 14)
14. Wetin make God command us to love our neighbor?
14 Which other way we fit show sey we like wetin Jesus do? Na love dey make Jehovah do everything. So, e want make everybody wey dey serve am get love as their main character. (1 John 4:8-11) We dey show sey we want be children of our Papa for heaven when we dey show our neighbor love. (Matt. 5:43-48) Bible command us make we love our neighbor but, the first command na to love Jehovah. (Matt. 22:37-40) To preach the good news about God Kingdom to our neighbor, na one way to show sey we love dem. We dey do like God when we dey show love, as e command us make we do. The truth be sey, we fit really show sey we love God when we love people, especially our brothers.—1 John 4:12, 20.
JESUS SACRIFICE BRING ‘FREEDOM’ FROM JEHOVAH
15. (a) Which better things Jehovah dey use Jesus sacrifice do for us now? (b) Which better things dey for front for us?
15 Jehovah go forgive us finish when we show sey we get faith for Jesus sacrifice. Bible make us dey sure sey our ‘sin fit clean comot.’ (Read Acts 3:19-21.) We don learn before sey, because of Jesus sacrifice, Jehovah take people wey go rule with Jesus as im children. (Rom. 8:15-17) For people wey be ‘other sheep,’ Jehovah don agree to take dem as im children. After sin don comot from their body finish, and dem don pass the final test, na that time dem go come be Jehovah children. Dem go stay this earth and Jehovah go show sey e love dem. (Rom. 8:20, 21; Rev. 20:7-9) Jehovah no go stop to love dem. The better things wey Jesus sacrifice go bring no go end. (Heb. 9:12) This sacrifice wey be gift from Jehovah, no go ever fade. Nobody fit collect am from us.
16. How Jesus sacrifice take make us get freedom?
16 Everybody wey repent with all their mind go join Jehovah family. Satan no fit do anything to stop dem. Jesus come this world come die ‘once and for all.’ So, Jesus sacrifice don free us kpatakpata. (Heb. 9:24-26) Nobody go ever die again because of Adam sin. Our belle sweet us sey this world wey Satan dey control no dey control us again, and we no dey fear to die. Why? Because Jesus die for us!—Heb. 2:14, 15.
17. How Jehovah go take show you love?
17 Jehovah go always do wetin e promise. All the other things wey Jehovah make still dey work together well because of im law wey dey control dem. So we dey sure sey Jehovah go always do wetin e get for mind for us. E no dey change. (Mal. 3:6) Apart from the life wey Jehovah give us, e dey show us sey e love us. ‘We don come sabi the love wey God get for us and we trust that love. God na love.’ (1 John 4:16) Everywhere for this world go turn to paradise and na only enjoyment go dey. Everybody for this earth go dey show love like God. Make we follow all Jehovah servant for heaven talk sey: ‘Make we praise, thank and respect our God wey get the glory, sense, and power, forever and ever. Amen.’—Rev. 7:12.