Wetin Jehovah Get for Mind Go Happen!
‘I don talk am, and I go do am. Na wetin I get for mind to do, and I go still do am.’—ISA. 46:11.
1, 2. (a) Wetin Jehovah don tell us about wetin e get for mind? (b) Wetin Isaiah 46:10, 11 and 55:11 make us dey sure of?
THE first verse for Bible talk sey: ‘From beginning, God make heaven and earth.’ Wetin dey that verse simple but e carry weight. (Gen. 1:1) The truth be sey, we never really understand many things wey God make, like heaven and earth, day and night, and light. And we no even know how the heaven wey e make big reach. (Eccl. 3:11) But, Jehovah don tell us wetin dey im mind when e make earth and human being. E make earth for human being to stay and enjoy am. And e make dem to fit copy im character. (Gen. 1:26) Dem go be im children and e go be their Papa.
2 But Genesis chapter three come tell us sey something happen wey want block wetin Jehovah get for mind. (Gen. 3:1-7) But, nothing and nobody fit block wetin Jehovah want do. (Isa. 46:10, 11; 55:11) So, we fit dey sure sey wetin Jehovah get for mind from beginning go happen when the time reach!
3. (a) Which things we first learn wey help us understand wetin dey Bible? (b) Why we want talk about dem now? (c) Which three question we go talk about?
3 Many of us know wetin Bible talk about wetin God get for mind for this earth and for human being. We still know how Jehovah go use Jesus do wetin e get for mind. This things make us understand wetin dey Bible and dem dey among the first things wey we learn when we start to study Bible. So, e good make we still help other people learn this truth dem. As we want talk about this topic, make we remember people wey we dey invite come Memorial. (Luke 22:19, 20) Dem go learn many things about wetin Jehovah get for mind. Make we use the small time wey remain before Memorial day take dey think about the kind question wey we fit use, wey go touch our Bible student and other people to follow us do this Memorial. For this topic, we go talk about this three question: From beginning, wetin God get for mind for this earth and human being? Which bad thing come happen? And how Jesus death take be like key wey open door so that wetin God get for mind go happen?
WETIN GOD GET FOR MIND FROM BEGINNING?
4. How the things wey Jehovah make take show sey e sabi the work?
4 The things wey Jehovah make show sey e really sabi the work. All the things wey e make fine finish, comma no dey. (Gen. 1:31; Jer. 10:12) When we see how the things wey e make fine and how e take arrange dem, wetin that one teach us? E teach us sey e get why God make everything. E no dey surprise you as pikin take dey form for belle, how one small seed dey turn to big tree wey dey produce plenty fruit or how star take dey make the sky fine for night? Because Jehovah don make us to fit like wetin fine, na im make better things dey sweet us.—Read Psalm 19:1; 104:24.
5. Wetin Jehovah do so that everything fit dey work together well?
5 We dey see Jehovah love for everything wey e make because of how e take arrange dem. E give human being law wey go direct dem. Other things wey e make still get law wey dey make dem work well together. (Ps. 19:7-9) Na im make everything get where dem suppose dey and how dem suppose work as God want. Na im arrange how everything go dey work together. For example, Jehovah make one strong force wey dem dey call gravity. Na gravity dey hold everything wey dey sky and earth for where dem dey. Na im dey control how water for river take dey flow. True true, the way everything take dey work well show sey e get why God make this earth and human being. When we dey preach, e good make we tell people about the Person wey arrange all this things well.—Rev. 4:11.
6, 7. Wetin be some things wey Jehovah give Adam and Eve?
6 Wetin dey God mind from beginning na for human being to stay for this earth forever. (Gen. 1:28; Ps. 37:29) God no tight hand at all! E give Adam and Eve many things so that dem fit enjoy life. (Read James 1:17.) Jehovah make dem to fit choose wetin dem want do, to fit enjoy each other love, and to fit dey think well. God talk to Adam and e tell am how e go take do wetin e want. Adam still learn how to take care of imself, the animals, and the garden. (Gen. 2:15-17, 19, 20) Jehovah still give dem tongue to taste, hand to feel, eye to see, ear to hear, and nose to smell. This one go make dem fit really enjoy the Paradise and the many better things for there. Yes, Adam and Eve fit continue to enjoy their work and learn many new things.
7 Wetin again dey God mind? Jehovah make Adam and Eve to fit born children wey no get sin for body. E still want make their children born children until people full this earth. E want make papa and mama love their children as e take love Adam and Eve. This earth and everything wey dey inside for be their own forever.—Ps. 115:16.
WHICH BAD THING COME HAPPEN?
8. Why Jehovah give Adam and Eve the law wey dey Genesis 2:16, 17?
8 Wetin God get for mind no happen the time wey e want. Why? Jehovah give Adam and Eve one simple law wey go show whether dem know where dem suppose do reach. God talk sey: ‘You fit chop belleful from the fruit of any tree wey dey the garden. But make you no chop from the tree wey dey make person sabi wetin good and wetin bad, because the day wey you chop am, you must die.’ (Gen. 2:16, 17) E no hard for Adam and Eve to understand and do wetin Jehovah talk. Na so because different different kind of food dey the garden wey dem fit chop.
9, 10. (a) Which lie Satan talk about Jehovah? (b) Wetin Adam and Eve come choose? (Go check the first picture.)
9 Satan use snake deceive Eve make e no do wetin Jehovah, im Papa talk. (Read Genesis 3:1-5; Rev. 12:9) Satan want make dem feel sey God no want make dem enjoy theirself. E just be like sey Satan dey tell am: ‘You mean sey you no fit do wetin you want?’ E come still lie sey: ‘Una no go die.’ E still no want make Eve listen to wetin God talk. So, e sey: ‘God know sey the day wey una chop am, una eye go open.’ Wetin Satan talk mean sey, Jehovah no want make Adam and Eve chop the fruit because if dem chop am, dem go get sense pass as dem get. And Satan come promise wetin e no fit do: ‘Una go be like God, come sabi wetin good and wetin bad.’
10 Adam and Eve need to choose wetin dem go do now. Na wetin Jehovah talk dem go do, or na wetin Satan talk? Dem come choose sey dem no go do wetin Jehovah talk. Wetin dem do show sey na Satan dem want follow. Dem leave their Papa, Jehovah, and dem no come dey follow im law wey dey protect dem; na their own dem come dey do.—Gen. 3:6-13.
11. Why Jehovah no leave wetin happen for Eden?
11 Because Adam and Eve no follow wetin Jehovah talk, dem no be as Jehovah make dem again; dem come get sin for body. Another thing be sey, dem come be Jehovah enemy because im ‘eye too clean to dey look bad thing.’ So, e ‘no fit leave wicked thing to continue.’ (Hab. 1:13) If to sey Jehovah leave wetin happen, nobody for heaven or earth go get hope sey wahala go end one day. And e fit come make angels and human being no trust Jehovah again. But Jehovah get law wey im dey follow, and e dey follow am finish. (Ps. 119:142) Adam and Eve suppose still follow Jehovah law even though sey dem get freedom to choose wetin dem want do. Because dem no do wetin Jehovah talk, dem die and dem turn to sand sand wey Jehovah take make dem.—Gen. 3:19.
12. Wetin happen to Adam children?
12 When Adam and Eve chop the fruit, dem no come be part of Jehovah family again. God pursue dem comot from the garden, and dem no fit go back. (Gen. 3:23, 24) Wetin Jehovah do dem, na wetin dem suppose get from the bad thing wey dem do. (Read Deuteronomy 32:4, 5.) Because dem don sin, dem no fit copy Jehovah character well again. Adam no only trowey the better life wey God give am, but e still carry sin and death give im children. (Rom. 5:12) E make im children no fit live life wey no go end. Another thing be sey, Adam and Eve and their children no fit born pikin wey no get sin for body. Satan still dey deceive people today, even after e don make Adam and Eve leave God.—John 8:44.
NA JESUS SACRIFICE SETTLE THE MATTER
13. Wetin Jehovah get for mind for human being?
13 But, God still love human being. Even with the bad thing wey Adam and Eve do, God still want make their children be im friend. E no want make anybody die. (2 Pet. 3:9) Na im make as dem sin, God no waste time arrange wetin go make people fit be im friend again. And wetin e do no change the kind person wey e be. How Jehovah take arrange things?
14. (a) How John 3:16 take show the kind thing wey God do for human being? (b) Which question we fit talk about with people wey come Memorial?
14 Read John 3:16. Many people wey we invite come Memorial sabi this verse well well. But the question na, How Jesus sacrifice go make us get life wey no go end? We suppose help people know the answer to this question. Which time we go help dem? Na when we dey invite dem come Memorial, the Memorial day and when we visit dem after Memorial. When dem understand the answer, e go make dem see the kind love and sense wey Jehovah get as e send Jesus come die for us. Wetin we go tell dem?
15. How Jesus take different from Adam?
15 Jehovah give us person wey sin no dey im body, wey im life match the one wey Adam trowey. This person go make sure sey e no leave Jehovah and e go ready to die for everybody. (Rom. 5:17-19) For everything wey Jehovah make, na Jesus be the first. Jehovah come make Jesus comot for heaven come live for earth. (John 1:14) Na im make Jesus no get sin for body, just as Adam be when God first make am. But Jesus no leave Jehovah like Adam. Jesus do only the things wey person wey no get sin for body suppose do, as Jehovah want am. Even when Jesus suffer well well, e no sin.
16. Why e be sey Jesus sacrifice na better thing?
16 Jesus no get sin for body, na im make am fit die for everybody and comot dem from sin. The kind person wey Adam suppose be, na im Jesus be. E no get sin for body, e no leave Jehovah at all and e do everything wey Jehovah talk. (1 Tim. 2:6) So, God let Jesus die for us so that ‘many people’ fit enter paradise. Among the ‘many people’ na men, women, and children. (Matt. 20:28) True true, Jesus sacrifice be like key wey dem use open door so that God go do wetin e get for mind for human being. (2 Cor. 1:19, 20) Everybody wey do wetin Jehovah like go get life wey no go end because of Jesus sacrifice.
JEHOVAH GIVE US CHANCE TO COME BACK
17. Wetin Jesus sacrifice do?
17 E no easy for Jehovah to let Jesus come die for us. (1 Pet. 1:19) But, e let am come because e love us well well. (1 John 4:9, 10) And because of wetin Jesus sacrifice do for us, Jesus come be our papa instead of Adam. (1 Cor. 15:45) This one no go only give us life but we go still get chance to be part of God family again. Yes, Jehovah still follow im law when e let Jesus die for us so that we fit be part of im family. You don ever think how things go be when sin don comot from the body of everybody wey dey do wetin God like? Jehovah family for heaven and earth go be one family. Na that time all of us go really be God children.—Rom. 8:21.
18. Which time Jehovah go take be ‘everything to everybody’?
18 Wetin Satan do no make Jehovah stop to love us. And e no fit make us stop to follow Jehovah even though sin dey our body. Jehovah go use Jesus sacrifice take help all im children dey righteous. Life go really sweet when everybody wey ‘know the Son and wey dey show sey dem get faith,’ go get life wey no go end. (John 6:40) God go use the love and sense wey e get take comot sin from human being body. Everybody go come be like Adam when God first make am. Our Father Jehovah go come be ‘everything to everybody.’—1 Cor. 15:28.
19. (a) If we like wetin Jehovah and Jesus do for us, wetin we go do? (Go check the box “Make We Continue to Find Person Wey Go Listen.”) (b) Wetin we go talk about for the next topic?
19 If we like wetin Jehovah and Jesus do for us, make we do everything wey we fit do to tell people about am. Make dem know how dem fit gain from this gift wey no get equal. Dem need to know sey, Jehovah use Jesus death give us life wey no go end because e love us. But, Jesus sacrifice do pass that one. The next topic go tell us how Jesus sacrifice take settle another matter wey Satan talk about for garden of Eden.