Make Dem Praise Jehovah Because You Use Your Mind Support Im Work!
‘Praise Jehovah! Because the people use their mind support the work.’—JUDG. 5:2.
1, 2. (a) Wetin Eliphaz and Bildad talk about wetin we dey do for God work? (b) Wetin Jehovah do about the matter?
THE time wey Job for Bible dey suffer, three of im friend come visit am. Their name na Eliphaz, Bildad, and Zophar. Eliphaz wey be Temanite come ask Job sey: ‘Wetin God dey use human being do? Or wetin e dey gain from person wey get sense? E concern God if you dey do good, or you think sey e dey gain anything because your way straight?’ (Job 22:1-3) You don ever think about the answer to this question dem? When e ask Job this question, Eliphaz think sey the answer na no. Even Bildad wey be Shuhite talk sey e no get how human being want take good for God eye.—Read Job 25:4.
2 Eliphaz and Bildad talk sey no matter wetin we do to serve God, God no go ever happy with us. Dem still talk sey for God eye, we no better pass butterfly, maggot, or worm. (Job 4:19; 25:6) When person first think about wetin dem talk, e go be like sey e make sense. (Job 22:29) For example, if person stand ontop high mountain, or e dey aeroplane dey look ground, people go just small like ant. Even though sey na Jehovah high pass for the whole world, you think sey e dey look wetin we dey do for im work like that? No! Jehovah let us know wetin dey im mind when e vex for Eliphaz, Bildad, and Zophar. E talk sey wetin dem talk na lie. But e happy with Job and even call am im servant. (Job 42:7, 8) That one show sey true true person fit good for God eye.
‘WETIN YOU FIT GIVE GOD?’
3. Wetin Elihu talk about the things wey we dey do to fit serve Jehovah, and wetin e mean?
3 When Eliphaz, Bildad, and Zophar dey talk, another man wey im name na Elihu dey listen. Elihu come ask Job sey: ‘If you be better person, wetin you fit give God; wetin e fit gain from you?’ (Job 35:7) You think sey Elihu dey talk for here sey all the things wey we dey do to fit serve God na zero? No. Jehovah no correct Elihu because na different thing e dey talk. E dey talk sey whether we serve Jehovah or we no serve am, we no fit change who e be. We no fit do anything wey go make am rich or strong pass as e be. The truth be sey, na God give us power and better sense to fit dey do things, and the way we dey use wetin e give us concern am.
4. How Jehovah dey look the good thing wey we dey do for other people?
4 Jehovah dey look the good things wey we dey do for im servant, like sey na im we dey do am for. Proverbs 19:17 talk sey: ‘Anybody wey dey do good to poor person dey borrow Jehovah something, and E go pay am back for wetin e do.’ Bible talk for here sey Jehovah know about all the good things wey person do to help poor person. Since na Jehovah make everything, na true sey anytime wey we do good thing to person, Jehovah dey look wetin we do like sey e dey owe us something. And, na true sey e go use favor and blessing take pay us back. Even Jesus talk sey na true.—Read Luke 14:13, 14.
5. Which question dem we go talk about?
5 Jehovah send prophet Isaiah go tell Im people sey E dey like am when Im servant dey put hand for Im work. (Isa. 6:8-10) Isaiah go the message; na im make am talk sey, ‘I dey here! Send me!’ Today, many people dey do like Isaiah. Dem ready to do Jehovah work, no matter how the work be. But, person fit ask sey: ‘Even though sey I like the work wey Jehovah let me do for am, wetin I dey do to support the work really mean anything? Whether I join for the work or I no join, Jehovah no go still make sure sey dem do the work?’ Wetin happen for Deborah and Barak time for Bible, go help us answer this question dem. Make we talk about wetin happen.
DEM FEAR, BUT GOD GIVE DEM MIND
6. How Israel people and Jabin army take different?
6 Jabin, wey be king for Canaan, don too suffer Israel people for 20 years. Israel people come dey fear to come out from different different place wey dem hide. Person fit even think sey Israel people no go fit do Jabin army anything. Na so because dem no get better things to take fight, or to protect theirself. But King Jabin army carry 900 horse wey get iron.—Judg. 4:1-3, 13; 5:6-8.a
7, 8. (a) Wetin Jehovah command Barak to do? (b) How Israel people take win Jabin army? (Go check the first picture.)
7 Even if e be like sey Jabin army strong pass Israel people, Jehovah use prophet Deborah take tell Barak sey: ‘Go carry 10,000 men from Naphtali and Zebulun family. Make una march go Mount Tabor. I go make Sisera wey be oga for Jabin army come meet you for Kishon river. E go come with im chariot and army dem, and I go make am lose the fight.’—Judg. 4:4-7.
8 People for Israel come hear sey dem need people wey go fight. Na so 10,000 people come gather for Mount Tabor. Barak no waste time carry dem go the war, as Jehovah command am. (Read Judges 4:14-16.) As dem dey fight for one place wey dem dey call Taanach, heavy rain start to fall; everywhere come full with water and potopoto. Barak pursue Sisera army go where dem dey call Harosheth wey far reach 15-mile (24 km). Because potopoto full everywhere, Sisera run leave im horse wey get iron. E come run go where dem dey call Zaanannim. For there, e hide for one woman house wey im name na Jael; e husband name na Heber wey be Kenite person. Jael welcome Sisera. After, sleep come carry Sisera because the fight make am weak. As e dey sleep, Jael come gather mind kill am. (Judg. 4:17-21) Jehovah don help Israel people win their enemy!b
SOME SUPPORT, SOME NO SUPPORT
9. Which other things dey Judges 5:20, 21 about the war wey Israel people fight with Sisera?
9 For Judges chapter 5, we go learn other things wey happen because wetin dey chapter 5 no dey chapter 4 wey we don dey talk about. For example, Judges 5:20, 21 tell us sey: ‘The star dem for heaven fight; dem fight Sisera from where dem dey. The water wey dey Kishon, that olden days river, carry dem comot.’ This one come mean sey Jehovah use angels help Israel people for the war? Or, e mean sey stone come dey fall from heaven like rain? Bible no tell us. But, we fit talk sey na Jehovah make that heavy rain fall for that place and the time wey dem fight the war, so that e go hard the 900 horse to move. Judges 4:14, 15 talk three times sey Jehovah help dem win. Nobody among the 10,000 men wey go the war fit talk sey na their power dem take win.
10, 11. Wetin be ‘Meroz,’ and why dem swear for am?
10 Make we come talk about something wey Deborah and Barak talk about for the song wey dem use praise Jehovah after the war. Dem sey: ‘Jehovah angel talk sey, “Swear for Meroz. Yes, swear for the people wey dey stay there because dem no come help Jehovah, dem no help Jehovah fight the strong people.”’—Judg. 5:23.
11 Wetin that Bible verse talk about Meroz happen. E be like sey na im make people no really know about Meroz. E fit be sey Meroz na one of the place wey no gree support the war wey Israel people fight with Sisera army, even though dem hear sey Israel need 10,000 men. E fit still be sey the people for Meroz get chance to take catch Sisera, but dem no do am. Think am for your mind sey dem see Sisera as e dey run pass their place make Israel army no catch am kill! Na fine chance be that wey dem for use take show sey dem dey Jehovah side; and Jehovah for bless dem. But, dem no do anything, even when dem for fit do something. If na wetin happen be that, then dem really dey different from Jael wey get mind!—Judg. 5:24-27.
12. For Judges 5:9, 10, wetin make people wey support the war different from people wey no support? Wetin this one suppose make us do today?
12 Judges 5:9, 10 help us see how people wey follow Barak go the war take different from people wey no go. Deborah and Barak praise ‘the people wey dey lead Israel, wey use their mind follow the people go.’ This people wey go the war really different from the people ‘wey dey ride fine horse,’ wey feel sey dem too big to join for the fight! Dem different from people wey ‘dey sitdown for fine carpet,’ wey dey use two hand chop life. Dem no be like people wey Bible sey ‘dey waka for road,’ wey no want suffer anything for life. But this people wey follow Barak go the war ready to fight for where dem dey call Tabor wey stone full, and where dem dey call Kishon wey water cover. Na the people wey no follow Barak Bible dey talk about when e sey, ‘Make una think am!’ Dem really need to think about the chance wey dem trowey, wey dem for use support Jehovah work. Today, e still good make we think about the things wey we dey do when other people dey support Jehovah work.
13. How tribe of Reuben, Dan, and Asher take different from Zebulun and Naphtali?
13 The people wey use their mind support the war see how Jehovah take show sey na im be the Ruler. Dem get wetin dem go talk about because dem use their eye see ‘the good things wey Jehovah do.’ (Judg. 5:11) But Judges 5:15-17 talk about Reuben, Dan, and Asher tribe sey, dem put mind for their property pass the way dem take put mind for Jehovah work. Their sheep, their boat, and where dem dey keep the boat na im dey their mind pass. But no be so people for Zebulun and Naphtali be; dem ‘risk their life even if dem go die’ so that dem fit support Deborah and Barak. (Judg. 5:18) We learn better thing from this example about people wey support Jehovah work and people wey no support.
‘PRAISE JEHOVAH!’
14. How we take dey show sey we dey support Jehovah work today?
14 We no dey fight war today to show sey we get mind. Instead, we dey use all our mind and power take dey preach. Today, Jehovah organization need people wey go support Jehovah work. Many brothers and sisters dey use all their mind do pioneer work, work for Bethel, Kingdom Hall construction work, and assembly and convention work. Even elders wey dey Hospital Liaison Committee and elders wey dey arrange convention dey do big work. Make una no forget sey Jehovah like the work wey una dey do and e no go forget am.—Heb. 6:10.
Before you choose wetin you go do, make you first think about wetin fit happen to your family and the congregation wey you dey (Check paragraph 15)
15. Wetin go help us fit know whether we no dey support Jehovah work as we suppose to?
15 E good make we check ourself whether we dey use our mind do Jehovah work. So make we ask ourself sey: ‘Na other people dey do all the work because I no want put body for the work? I dey allow money and property make me no support Jehovah work as I suppose to? I get faith and mind wey dey make me use everything wey I get to do wetin Jehovah want like Barak, Deborah, Jael, and the 10,000 men? If I dey plan to go another country go stay because I dey find better life, I dey think about wetin fit happen to my family and the congregation wey I dey? And, I dey pray about the matter?’c
16. Even though sey Jehovah get everything, wetin we fit still give am?
16 Jehovah love us na im make e dey give us chance to show sey we dey support am. Since Adam and Eve time, Satan want make people dey im side. But when we support Jehovah work, e dey show sey na Jehovah side we dey. The faith wey you get to do wetin good for Jehovah eye, na im go make you use your mind support Jehovah work so that Jehovah go happy. (Prov. 23:15, 16) The way we take support im work go make am know how to answer Satan lie lie. (Prov. 27:11) So, if you dey do wetin Jehovah want and you no leave am, you dey give Jehovah something wey e like, wey dey make belle sweet am.
17. How Judges 5:31 talk sey our tomorrow go be?
17 Small time, na people wey support only Jehovah as King go remain for this earth. Make that time quick come! We dey feel like Deborah and Barak wey sing for Bible sey: ‘Make your enemy dem die, O Jehovah. But make people wey love you shine like sun wey dey come out.’ (Judg. 5:31) Jehovah go do wetin dey this verse when e don destroy Satan and people wey support am. When Armageddon start, Jehovah no go need people wey go come join fight the war. That time, we no go ‘comot for where we stand,’ and we go ‘see how Jehovah go take save us.’ (2 Chron. 20:17) Until that time reach, we still get time and chance to use all our mind and power take support Jehovah work.
18. If we use all our mind support Jehovah work, wetin e go make other people do?
18 ‘Praise Jehovah! Because the people use their mind support the work.’ Na so Deborah and Barak take start to praise Jehovah for their song because e help dem win the war. Na Jehovah, the God wey high pass, dem praise, no be any human being. (Judg. 5:1, 2) Na so e still be today. If we use all our mind support Jehovah work, other people go praise am!
a The iron wey the horse get be like long, sharp knife. Some of dem bend, dem no straight. Dem dey put am for chariot tire, sometimes for center of tire. This one dey make am hard to fight this kind army.
b You fit still read about this sweet story well for August 1, 2015 Watchtower, pp. 12-15.
c Check this topic “Anxiety About Money” wey dey July 1, 2015, Watchtower.