Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 December pp. 18-22
  • Papa And Mama—Help Your Children Get Life

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Papa And Mama—Help Your Children Get Life
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • “YOU DON KNOW ABOUT THE HOLY THINGS WEY DEM WRITE”
  • “YOU COME REALLY BELIEVE AM”
  • “SENSE WEY GO SAVE YOU”
  • WHEN PIKIN WEY DON BAPTIZE NO TOO DEY BELIEVE BIBLE
  • Papa and Mama, Help Your Children Become Jesus Disciple!
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
  • Young People—“Dey Do Things Wey Go Save Una”
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 December pp. 18-22
Papa dey use Bible dey help im daughter understand something

Papa and Mama​—Help Your Children Get Life

“From small pikin you don know about the holy things wey dem write. This things fit give you sense wey go save you.”​—2 TIM. 3:15.

SONG: 141, 134

WETIN E MEAN . . .

  • for person to know the holy things wey dem write?

  • for person to really believe wetin dem teach am?

  • for person to get sense wey go save am?

1, 2. Why some people mind no dey settle when their children want baptize?

TODAY, plenty people wey don promise to use their life serve Jehovah dey baptize. Many of dem na young people wey dem born for inside Jehovah organization. Dem don see sey na to serve Jehovah better pass. (Ps. 1:1-3) And if you be papa and mama wey dey serve Jehovah, you fit dey wait for the time wey your pikin go baptize.​—Check 3 John 4.

2 Some children wey don baptize fit later talk sey dem no sure sey na to follow wetin Jehovah talk better pass. Some of dem don even comot for Jehovah organization. You fit don see children like that and this one fit make your mind no settle. You fit dey fear sey your pikin fit be like some brothers and sisters for Ephesus wey Jesus talk about. Jesus talk sey dem “forget the love wey [dem] first get.” (Rev. 2:4) So how you fit help your pikin continue to get strong love for Jehovah, and get the sense wey go give am life? (1 Pet. 2:2) Timothy example go help us know the answer.

“YOU DON KNOW ABOUT THE HOLY THINGS WEY DEM WRITE”

3. (a) How Timothy take become Christian, and wetin e do? (b) Wetin be the three things wey we take from wetin Paul tell Timothy?

3 The first time wey apostle Paul visit the place wey dem dey call Lystra na 47 C.E. E be like sey na that time Timothy hear about the things wey Jesus teach. Timothy fit dey around 20 years that time. E follow the things wey dem teach am. And after two years, e come dey follow Paul travel. Around 16 years later, Paul come write letter give Timothy. E tell am sey: “Make you no stop to dey follow the things wey dem teach you. You come really believe am because you know who teach you. From small pikin you don know about the holy things wey dem write [for the part of Bible wey dem use Hebrew write]. This things fit give you sense wey go save you because of the faith wey you get for Jesus Christ.” (2 Tim. 3:14, 15) You see some of the things wey Paul tell am? (1) E sey Timothy know the holy things wey dem write, (2) e come really believe sey the things wey dem teach am na true, and (3) e sey this things fit give am the sense wey go save am, because of the faith wey e get for Jesus Christ.

4. Wetin you dey use teach your children? (Go check the first picture.)

4 Since you dey serve Jehovah, you go want make your pikin know the things wey dey Bible. Even small children fit sabi the story and the people wey Bible talk about. Jehovah organization don give papa and mama different things wey dem go take dey teach their pikin. You get some of dem for your language? Remember sey na wetin your children learn from Bible go help dem near Jehovah and be im friend.

“YOU COME REALLY BELIEVE AM”

5. (a) Wetin e mean for person to “come really believe” something? (b) Wetin make Timothy believe the truth about Jesus Christ?

5 Na better thing for your children to know wetin Bible talk, but no be there e end. No be only the story wey dey Bible and the people wey Bible talk about dem need to know. Bible talk sey Timothy “come really believe” wetin e learn. The Greek word wey Paul use for here mean sey person “dey sure of” something, or e “believe well well sey something na true.” Na from small pikin Timothy know the first part of the Bible wey dem use Hebrew write. But later, Timothy come see things wey make am believe sey na Jesus be the Messiah. So Timothy believe the truth well well because e come dey sure sey wetin e learn correct. Na this one make Timothy baptize and even join Paul dey travel go different different place go preach.

6. How you fit help your children believe wetin dem dey learn from Bible?

6 How you fit help your pikin believe wetin e learn like Timothy? You need to dey patient. You no go fit make dem believe wetin Bible talk once. And no think sey your pikin go believe wetin Bible talk because you believe am. Na the pikin go use im sense take believe wetin Bible talk. (Read Romans 12:1.) E get things wey you fit do to help your children, especially when dem ask you question. Make we see one example.

7, 8. (a) How Thomas take show sey e dey patient when e dey teach im pikin? (b) How you don take show sey you dey patient with your pikin?

7 E get one brother wey im name na Thomas. E get one daughter wey dey 11 years. The brother sey: “My pikin fit ask me sey, ‘You no sure sey Jehovah just let everything for this earth come by theirself?’ or ‘Why we no dey put hand for things like election, to make our country better?’ Sometimes I dey control myself, so that I no go just tell am wetin I believe. After all, if I tell am everything once, no be im go make am believe me. Na small small I go tell am things wey go make am believe.”

8 Thomas know sey e need to dey patient to fit teach im pikin. The truth be sey, all of us wey dey serve Jehovah suppose dey patient. (Col. 3:12) To fit help im pikin, Thomas dey talk with am many times. E go use Bible talk with am so that im pikin go come believe wetin e dey learn. Thomas talk sey: “Especially if na matter wey serious, me and my wife dey want make sure sey our pikin really believe wetin e dey learn, and make the things make sense to am. We dey like am if e ask us question. The truth be sey, my mind no go settle if e agree with wetin we tell am, and e no ask question.”

9. Wetin you fit do to help your pikin believe wetin Bible talk?

9 When papa and mama dey patient with their pikin, small small, the pikin go dey sabi the truth wey dey Bible. (Eph. 3:18) When you dey teach dem, dey look their age and how dem fit learn reach. As dem dey believe wetin dem dey learn, dem go fit dey preach to people, like their classmate, about wetin dem believe. (1 Pet. 3:15) For example, your children fit use Bible explain wetin dey happen to person wey don die? Wetin Bible talk about this matter make sense to dem?a Na true sey, e no easy to take time teach your pikin Bible. But no be waste of time. After all, soup wey sweet, na better money kill am.​—Deut. 6:6, 7.

10. Which other better way you fit help your children believe wetin Bible talk?

10 Your example na another thing wey go help your children believe wetin Bible talk. E get one sister wey im name na Stephanie. The sister get three children, and all of dem na girls. The sister talk sey: “Na since when my children small, I dey ask myself sey, ‘I dey tell my children wetin make me believe sey Jehovah dey and sey e love us? I dey help dem see sey everything wey Jehovah dey do correct? My children dey see am for my body sey I really love Jehovah?’ I no go fit help my children believe wetin Bible talk if me no believe am.”

“SENSE WEY GO SAVE YOU”

11, 12. Wetin e mean for person to get sense, and why we fit talk sey no be only age dem take dey know person wey don mature?

11 We talk before sey Timothy know wetin Bible talk and e really believe am. But wetin Paul mean when e sey the holy things wey dem write go make Timothy get “sense wey go save” am?

12 One of our book wey be Insight on the Scriptures, Volume 2, explain wetin e mean for person to get sense as Bible talk am. E sey “person wey get sense dey fit use wetin e know and wetin e understand take handle problem well. E go fit still help am comot im head from wahala, do wetin e get for mind to do, or advice other people to do am. Person wey no get sense no fit do all this things.” Bible talk sey: ‘E dey pikin mind to do things wey no make sense.’ (Prov. 22:15, ftn.) So if person get sense, e dey show sey the person no be small pikin again. But no be just by age dem take dey know person wey don mature. If person dey fear Jehovah and ready to do wetin e talk, Jehovah dey look this kind person as mature person.​—Read Psalm 111:10.

13. How young people go take show sey dem get the kind sense wey go save dem?

13 Young people wey stand well for Jehovah side dey show sey dem mature. Dem no dey allow their mate to control dem, and dem no still dey allow their body to control dem. (Eph. 4:14) This one show sey, dem get sense wey dey “help dem know the difference between good and bad.” (Heb. 5:14) This kind young people go fit choose well, even when their papa and mama or other big people no dey with dem. (Phil. 2:12) Young people need this kind sense to get life. (Read Proverbs 24:14.) But how you go take help your pikin get this kind sense? The first thing na to make sure sey your pikin understand wetin you believe from Bible. And make wetin you dey talk and wetin you dey do show dem sey you dey follow wetin Bible talk.​—Rom. 2:21-23.

One man no do wetin e suppose do to help im pikin, and the pikin no come dey follow wetin e learn for Bible; one man do wetin e suppose do and im pikin no come follow bad friend

Why e good make papa and mama dey always teach their pikin about Jehovah? (Check paragraph 14-18)

14, 15. (a) Wetin young person wey want baptize need to think about? (b) How you go take help your pikin see wetin e go gain if e follow wetin Jehovah talk?

14 But no be just to tell your pikin wetin e go do, and wetin e no go do. You still need to help am think about this kind question: ‘Why Bible sey make we no dey do things wey our body want? Wetin make me believe sey e go better for me if I dey always do wetin Bible talk?’​—Isa. 48:17, 18.

15 What if your pikin tell you sey e want baptize? Help am know wetin e mean for person to baptize, and tell am wetin person wey don baptize dey do. Try to see if e really ready. Help am think about wetin e go gain if e baptize, some of the wahala wey e go face and how the gain take better pass the wahala wey e go face. (Mark 10:29, 30) E good for am to think about this question because person wey don baptize go face some of this things. Help your pikin think about the better thing wey e go gain if e do wetin Jehovah talk, and the things wey go happen if e no do am. This one go make am believe sey na im go gain if e dey always do wetin Bible talk.​—Deut. 30:19, 20.

WHEN PIKIN WEY DON BAPTIZE NO TOO DEY BELIEVE BIBLE

16. Wetin papa and mama suppose do if their pikin no come too believe wetin Bible talk after e don baptize?

16 What if your pikin no come too believe wetin Bible talk after e baptize? For example, e fit start to like the things wey dey this world. Or e fit talk sey e no make sense to follow wetin Bible talk. (Ps. 73:1-3, 12, 13) Get am for mind sey wetin you do about the matter fit make your pikin continue to serve Jehovah, or make am stop. Try make you no turn the matter to quarrel, whether the pikin small or e don big. Let your pikin know sey you love am and you ready to help am.

17, 18. Wetin papa and mama fit do to help pikin wey no too dey believe wetin Bible talk again?

17 Na true sey your pikin don promise to use im life serve Jehovah before e baptize. E tell Jehovah sey e love am and e ready to put wetin Jehovah want as the number one thing for im life. (Read Mark 12:30.) Jehovah no dey joke with this kind promise at all, and e no want make person play with am. (Eccl. 5:4, 5) Look for better time to remind your pikin all this things. Jehovah organization don give papa and mama different different things wey talk about this matter. So make sure sey you check dem before you talk to your pikin about the matter. Sofri help your pikin see sey wetin e promise Jehovah serious well well. And help am see sey Jehovah go bless am well well if e do wetin e promise am.

18 For example, better advice dey the ending of the book wey dem dey call Questions Young People Ask​—Answers That Work, Volume 1. You go see this topic wey be “Questions Parents Ask” for there. The place sey: “No quick think sey your pikin don trowey the truth wey you teach am. Many times, na something dey cause am.” E fit be im mate dem, or e no get person to talk to. E fit even dey think sey other young people dey do well for congregation pass am. The book still talk sey this things no mean sey the pikin no believe wetin Bible talk again. E only show sey dem get problem wey dem dey face now. The ending of that book explain other things wey you fit do to help this kind pikin stand well for Jehovah side.

19. How papa and mama fit help their children get the sense wey go give dem life?

19 If you be papa or mama, Jehovah don bless you with big work. The work na to dey teach your children about Jehovah and dey correct dem well. (Eph. 6:4) And we don see sey no be only wetin Bible talk you go teach dem. You need to help dem believe wetin dem dey learn from Bible. This one go make dem ready to promise Jehovah sey dem go use all their mind serve am. Make Bible, God spirit, and everything wey you dey do, help your children get sense wey go give dem life.

a The book “What Does the Bible Really Teach?” get wetin dem dey call study guide wey fit help young people and people wey don grow. E go help dem understand wetin Bible talk and how dem go fit explain am to people. You fit see am for our jw.org website for many language. Check BIBLE TEACHINGS > BIBLE STUDY TOOLS (for English).

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share