You Know Jehovah Like Noah, Daniel, and Job?
“Bad people no fit know wetin e mean to do wetin correct. But people wey dey serve Jehovah go fit understand everything.”—PROV. 28:5.
1-3. (a) Wetin go help us hold Jehovah tight for this wicked world? (b) Wetin we go learn for this topic?
FOR this last days wey go soon end, wicked people dey “grow like grass.” (Ps. 92:7) So e no dey surprise us sey plenty people no dey do wetin God want. Bible sey make we be like small pikin for bad thing, but make we dey think like person wey don grow. How we go take do this one for this wicked world?—1 Cor. 14:20.
2 Proverbs 28:5 answer this question. Part of that verse talk sey: “People wey dey serve Jehovah go fit understand everything.” This one mean sey dem fit understand everything wey dem need to do to make God happy. (Prov. 28:5) Proverbs 2:7, 9 still talk sey Jehovah “dey give better sense to people wey dey do wetin good.” And na this one dey make dem ‘understand wetin good, wetin correct, and dem go know everything wey good.’
3 Wetin Noah, Daniel, and Job do show sey dem get the better sense wey God dey give. (Ezek. 14:14) People wey dey serve God today still get am. What of you? You “understand everything” wey you need to do to make God happy? The thing wey go help you na to know Jehovah well. So for this topic, we go see (1) how Noah, Daniel, and Job take know Jehovah, (2) how the things wey dem know about Jehovah take help dem, and (3) how we go take get the kind faith wey dem get.
NOAH DO WETIN GOD LIKE EVEN WHEN PEOPLE DEY DO BAD
4. How Noah take know Jehovah, and how that one take help am?
4 How Noah take know Jehovah? From the time when Adam and Eve start to dey born children, people learn about Jehovah from: (1) the things wey e make, (2) other people wey dey serve am, and (3) when dem see how Jehovah take bless dem because dem do wetin e talk. (Isa. 48:18) Noah settle down look the things wey God make. E go don see many things wey make am believe sey God dey, and wey help am know the kind person wey God be. For example, Noah fit don see sey God get power well well, and na only im be the true God. (Rom. 1:20) So Noah no just believe sey God dey, but im faith for God come dey strong.
5. How Noah take know wetin God get for mind for human being?
5 Bible tell us sey “faith dey come from wetin person hear.” (Rom. 10:17) So how Noah take hear about Jehovah? E be like sey na im family people tell am about Jehovah. For example, Lamech wey be im papa get faith for Jehovah. Dem born Lamech before Adam die. (Go check the first picture.) Another of Noah family person na Methuselah and Jared. Methuselah na Noah grandpapa and Jared na im great-great-grandpapa. Jared die 366 years after dem born Noah.a (Luke 3:36, 37) So e be like sey na this people and their wife tell Noah sey Jehovah make human being. Dem fit don tell am sey God want make only good people full the earth. Noah go don hear about the bad thing wey Adam and Eve do, and e see wetin come out from the bad thing wey dem do. (Gen. 1:28; 3:16-19, 24) Wetin Noah learn touch im heart, and this one make am serve Jehovah.—Gen. 6:9.
6, 7. How the hope wey Noah get take make im faith strong?
6 Hope dey make person faith strong. Noah name fit mean “Rest, or Consolation.” The meaning of the name fit make person mind come down and give am hope. How you think sey e do Noah for body when e know the meaning of im name? (Gen. 5:29, ftn.) God spirit make Lamech talk sey: ‘Because Jehovah curse the ground, we dey do hard work sotey our hand dey pain us. But Noah go make our mind come down.’ Noah get hope sey God go make things better. Noah be like Abel and Enoch wey believe sey the “pikin” wey Bible talk about go scatter Devil head.—Gen. 3:15.
7 Noah fit no understand everything wey Genesis 3:15 talk sey go happen. But e know sey wetin that place talk show sey hope dey for front. Enoch still preach something like that when e talk sey God go destroy bad people. (Jude 14, 15) This thing wey Enoch talk go don make Noah get hope and make im faith strong well well. Wetin Enoch talk happen for im time, and e go still happen for Armageddon.
8. As Noah know God well, how that one take help am?
8 Noah know God well and that one help am. Because Noah learn about Jehovah, e come get faith and the sense wey God dey give. This one make am no do anything wey Jehovah no like. Bible tell us sey: “Noah follow the true God waka.” E no waka with people wey dey do bad. E no let those angel wey change to human being deceive am. The power wey those demons get go don surprise many people, and dem fit even don try to worship dem. (Gen. 6:1-4, 9) Noah still know sey na human being God tell to born children full this earth. (Gen. 1:27, 28) So na bad thing those angel do as dem marry women and start to born children. And as this children dey grow, dem come dey big and strong pass other children. This one go don help Noah really see sey wetin dem do no good at all. Later, God come tell Noah sey e want use water destroy all the bad people. Noah know sey God go do wetin e talk, na this one make am build the ark wey save im and im family.—Heb. 11:7.
9, 10. How we go take get the kind faith wey Noah get?
9 How we go take get the kind faith wey Noah get? E good make we dey settle down study Bible, and make we like wetin we dey learn. And we still need to allow am change our life so that we go fit choose wetin Jehovah want. (1 Pet. 1:13-15) If we do this one, we go get faith and the sense wey God dey give. This one go help us no fall for Satan trap and we no go copy the bad things wey people for this world dey do. (2 Cor. 2:11) Many people for this world like fight, dem like to put hand for sex matter wey no clean for God eye, and dem like to do the things wey their body want. (1 John 2:15, 16) This kind people no believe sey God go soon destroy bad people. And if our faith no strong, we fit start to think like dem. Jesus talk sey our time go be like Noah time. But e no talk sey na fight or sex matter go make am be like that. Instead, e talk sey people go allow other things comot their mind from God matter.—Read Matthew 24:36-39.
10 Ask yourself: ‘The way I dey live my life dey show sey I really know Jehovah? My faith dey make me do wetin Jehovah like and tell people about am?’ Your answer to this question go help you know if you dey follow God waka like Noah.
DANIEL NO STOP TO DEY WORSHIP JEHOVAH FOR BABYLON
11. (a) How the love wey Daniel get for Jehovah take help us know the kind people wey im papa and mama be? (b) Wetin be some of the character wey Daniel get wey you go like to copy?
11 How Daniel take know Jehovah? Daniel papa and mama go don teach am to love Jehovah and im Word. And Daniel no stop to do this things wey im papa and mama teach am. Even when Daniel don old, Bible tell us sey e still dey study God Word well well. (Dan. 9:1, 2) One time wey Daniel dey pray, e carry body down and e tell God wetin dey im mind. The prayer dey Daniel 9:3-19. Wetin Daniel talk for this prayer show sey e know Jehovah well, and e know wetin Jehovah don do for Israel people. E go make sense if you find time read that place for Bible, and think about wetin you read. Then ask yourself sey: ‘Which kind person this prayer show sey Daniel be?’
12-14. (a) How Daniel take show sey e get the sense wey God dey give? (b) How Jehovah take help Daniel?
12 Daniel know God well and that one help am. Daniel na Jew person wey dey serve Jehovah well. So e no easy for am to stay Babylon because the people for there no dey serve God. Jehovah tell Jew people sey: “Find wetin go bring peace for the city wey I send una go.” (Jer. 29:7) But God still want make dem dey use all their heart serve am. (Ex. 34:14) Wetin help Daniel do this two things wey God talk? Daniel get the sense wey God dey give. So e know sey na Jehovah e go first obey before e obey the people wey dey rule. Jesus later tell people this kind thing when e come this earth.—Luke 20:25.
13 Make we talk about wetin Daniel do when the government for im time make one kind law. Dem sey for 30 days, make everybody dey pray to the king, make dem no pray to any god or any other person. (Read Daniel 6:7-10.) Daniel no talk sey, ‘Na only thirty days dem sey make I no pray to God!’ Instead, e continue to worship Jehovah. E no allow wetin dem talk make am stop to pray. If Daniel want hide pray make nobody see am, e for hide. But e know sey people know how e take dey pray everyday. So e no want make people think sey e no dey worship God again. Daniel know sey dem fit kill am if dem catch am dey pray, but e no let that one stop am.
14 Wetin Daniel do show sey e really get mind, and e stand well for God side. Na this one make Jehovah save am when dem throw am put for where lion dey. The news about wetin happen to Daniel reach everywhere for Medo-Persia, and this one come make plenty people know Jehovah!—Dan. 6:25-27.
15. Wetin go help us get the kind faith wey Daniel get?
15 How we go take get the kind faith wey Daniel get? If we want get strong faith, we no go only read Bible, but we go make sure sey we “understand am.” (Matt. 13:23) If we want know how Jehovah dey think, and how e dey see something, we need to think about wetin we don read. Another thing wey go help us na prayer. When we dey pray, e good make we dey tell Jehovah wetin dey our mind, especially when we dey face problem. If we get faith for Jehovah and beg am to give us sense and power, Jehovah ready to give us pass wetin we need.—Jas. 1:5.
JOB NO STOP TO DO WETIN GOD LIKE
16, 17. Wetin help Job know Jehovah well?
16 How Job take know Jehovah? Job no be Israel person. But we know sey e come from the family wey Abraham, Isaac, and Jacob come from. Jehovah help this people know who e be and wetin e get for mind to do for us. But Bible no tell us how Job take learn some of this things about Jehovah. (Job 23:12) Job tell Jehovah sey: “I don take my ear hear about you.” (Job 42:5) And Jehovah talk sey wetin Job dey tell people about am na true.—Job 42:7, 8.
We dey know the kind person wey God be from the things wey e make, and this one dey make our faith strong (Check paragraph 17)
17 Job see the things wey God make, and this one still help am know who Jehovah be. (Job 12:7-9, 13) Later, Elihu and Jehovah help Job see sey human being small well well for where God dey. And na the things wey Jehovah make dem use take help am know this one. (Job 37:14; 38:1-4) Wetin Jehovah tell Job really touch im heart, na this one make am talk sey: “Now I know sey you fit do everything. And I know sey e no get anything wey you get for mind wey you no fit do. . . . I sitdown for sand sand and ashes to show sey I regret wetin I talk.”—Job 42:2, 6.
18, 19. How Job take show sey e know Jehovah well?
18 Job know God well and that one help am. Job know wetin Jehovah want make e do. E really know Jehovah and this one make am do wetin God like. For example, Job know sey e no fit talk sey e love God if e no dey treat other people well. (Job 6:14) Job no think sey e better pass other people, e treat everybody like im brother, whether dem rich or dem poor. Job talk sey: “No be the same person wey make me for belle make dem?” (Job 31:13-22) When Job get money, e no carry shoulder up or think sey other people no reach am. Many people wey get money and high position today no dey behave like Job!
19 Job put Jehovah as the number one person for im life. E know sey if e allow another thing become the main thing for im life, that one mean sey e don reject God. (Read Job 31:24-28.) Job know sey na God arrange marriage so that husband and wife go dey together. E even tell imself sey e no go look any other woman wey no be im wife. (Job 31:1) Remember sey that time, God dey allow people marry pass one wife. So if Job like, e for marry another wife.b But e be like sey Job know sey na one wife God give Adam, and Job follow that example. (Gen. 2:18, 24) About 1,600 years after Job time, Jesus teach people this kind thing when e dey talk about marriage and sex matter.—Matt. 5:28; 19:4, 5.
20. If you know Jehovah well, how e go take help you choose better friend and wetin you go use enjoy yourself?
20 How we go take get the kind faith wey Job get? Na if we know Jehovah well and dey do wetin we learn. For example, David talk for Bible sey Jehovah “hate anybody wey like katakata.” And e still talk sey e no good make we waka with “people wey dey deceive other people.” (Read Psalm 11:5; 26:4.) How this two verse take help you see how Jehovah dey think? How e take affect wetin you dey see as the number one thing for your life? How e take affect how you dey use internet, and the kind friend wey you dey make? Or the things wey you take dey enjoy yourself, like wetin you dey watch or read? Your answer to this question go help you see how you know Jehovah reach. If we no want dey behave like people for this world, we need to ‘train our sense well’ to know wetin good and wetin bad. This one go still help us get the sense to choose well.—Heb. 5:14; Eph. 5:15.
21. Wetin go help us “understand everything” wey we suppose do to make Jehovah happy?
21 Noah, Daniel, and Job do wetin dem fit do to know Jehovah well, and Jehovah help dem. E help dem “understand everything” wey dem suppose do to make am happy. Three of dem na example of people wey do wetin God like, and their life really make sense. (Ps. 1:1-3) So ask yourself, ‘I know Jehovah well like Noah, Daniel, and Job?’ Today, we fit know Jehovah pass Noah, Daniel, and Job. Why we talk so? Na because Jehovah don tell us many other things about who e be. (Prov. 4:18) So dey study Bible well well. Think about wetin you dey read. And pray make Jehovah give you im holy spirit. If you do this one, you go near Jehovah more more. You go get sense wey God dey give, and you no go copy the people for this world.—Prov. 2:4-7.
a Enoch wey be Noah great-grandpapa do wetin God like. But e die about 69 years before dem born Noah.—Gen. 5:23, 24.
b Na one wife Noah still marry, even though sey people start to marry pass one wife after Adam and Eve sin.—Gen. 4:19.