Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w18 March pp. 28-32
  • “Listen to Correction Make You Get Sense”

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • “Listen to Correction Make You Get Sense”
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • PERSON WEY GET SENSE DEY CONTROL IMSELF
  • TRAIN YOUR CHILDREN FOR JEHOVAH WAY
  • FOR CONGREGATION
  • WETIN PAIN PASS ANY CORRECTION?
  • Na Love Dey Make God Correct Us
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
w18 March pp. 28-32
Instead of this boy to play ball, e dey pray and read Bible

“Listen to Correction Make You Get Sense”

‘My children, listen to correction make una get sense.’​—PROV. 8:32, 33.

SONG: 56, 89

HOW YOU GO TAKE ANSWER?

  • How Jehovah take dey sofri teach us how to correct ourself?

  • How papa and mama fit train their children to follow Jehovah way?

  • How we fit gain from any correction wey elders give us?

1. How we fit take get sense, and wetin we go gain?

NA Jehovah sense dey come from, and e like to give people sense. James 1:5 talk sey: “If anybody among una no get sense, make e dey ask God and e go give am, because God dey open hand give anybody wey ask am for something, and e no dey vex for am.” One way we take dey get sense from God na when we dey take im correction. This sense fit make us no put hand for bad thing, and e go help us hold Jehovah tight. (Prov. 2:10-12) And this one dey make us get hope to get life wey no go end.​—Jude 21.

2. Wetin fit help us to see the correction wey God dey give as better thing?

2 E get some things wey fit make am hard for us to take correction sometimes. E fit be the sin wey dey our body, the way dem take train us, and other things. We fit even no dey see correction like better thing. But when we see the better thing wey dey come from correction, e go make us value am, and e go make us know sey Jehovah really love us. Proverbs 3:11, 12 talk sey: “My pikin, no hate Jehovah correction, and no trowey am. Because na people wey Jehovah love e dey correct.” We know sey Jehovah want wetin good for us. (Read Hebrews 12:5-11.) Because God really know us, e dey correct us well, and e dey give us the kind correction wey we need. For this topic, we go talk four things about correction: (1) to correct yourself, or to control yourself, (2) correction wey papa and mama dey give pikin, (3) correction wey elders dey give, and (4) something wey dey pain pass any correction wey dem fit give person.

PERSON WEY GET SENSE DEY CONTROL IMSELF

3. Wetin go help pikin know how to control imself? Give example.

3 Person wey sabi control imself dey know how to correct the way e dey think and behave. Dem no dey born person with am, so person need to learn how to dey control imself. For example, when pikin dey learn how to ride bicycle, im papa or mama dey hold the bicycle make e no fall. But if dem see sey the pikin don dey learn how to balance imself, dem go dey comot hand from the bicycle sometimes. And if the pikin don sabi how to ride the bicycle well well, dem go leave am to ride am. Na so e still be when papa and mama dey train their children. Dem need to dey patient, dey always “use Jehovah way correct dem and dey teach dem.” This one go help their pikin know how to control imself and e go get sense.​—Eph. 6:4.

4, 5. (a) Why we need to learn how to control ourself as part of the “new character”? (b) Why e no good make we tire even if we make mistake?

4 Na so e still be for person wey don big before e learn about Jehovah. E fit know how to dey control imself for some kind matter, but e never mature as Christian. As e dey learn to get the “new character,” and dey copy Jesus example, e go dey help am dey mature as Christian. (Eph. 4:23, 24) If we learn how to dey correct ourself, e go help us follow wetin Titus 2:12 talk. That place sey make we ‘comot eye for things wey God no like, and things wey this world like. And make we dey live with sense, dey do good, and dey hold God tight even though sey we dey this world.’

5 All of us get sin for body. (Eccl. 7:20) So if we make mistake, e mean sey we no know how to control ourself well, or we no sabi control ourself at all? E fit no be like that. Proverbs 24:16 talk sey: “Good person fit fall seven times, but e go get up again.” Wetin go help us stand up again? Na God spirit go help us, no be our power. (Read Philippians 4:13.) Self-control na part of the character wey God spirit dey make person get. And person wey dey correct imself dey get this character.

Instead of this boy to play ball, e dey pray and read Bible

6. If we want dey study Bible well, wetin go help us? (Go check the first picture.)

6 If we dey pray, dey study Bible and dey settle down think about wetin we don learn, e go still help us learn how to control ourself. But what if e dey hard you to study Bible? Or you no just like to dey study? Get am for mind sey Jehovah ready to help you if you allow am. Jehovah fit make im Word dey “hungry” you. (1 Pet. 2:2) The first thing wey you need to do na to pray make Jehovah help you fit study Bible. As time dey go, e go dey easy for you, and you go dey enjoy am! You go come dey value the time wey you take dey study Bible and dey sofri think about wetin God talk.​—1 Tim. 4:15.

7. If we dey control ourself, how e go take help us do wetin we plan to do for Jehovah?

7 If we dey control ourself, e go help us fit do wetin we plan to do for Jehovah. E get one brother wey get wife and children. This brother see sey e no come dey like preaching as before. So e come plan to become regular pioneer. E come dey read topic for our magazine wey talk about regular pioneer work, and e pray about the matter. This one make am near Jehovah well well. And to pioneer come dey hungry am pass before. E still do auxiliary pioneer when e get chance. Even though sey things no easy for am, e continue to put mind for wetin e plan to do. Later, e come become regular pioneer.

TRAIN YOUR CHILDREN FOR JEHOVAH WAY

One man dey teach im pikin how to ride bicycle

Dem no born pikin to know wetin good and wetin bad; dem dey train am to know am (check paragraph 8)

8-10. Wetin go help papa and mama fit train their pikin well? Give example.

8 Na papa and mama Jehovah give the work to train their children. And e want make dem use im way take teach and correct dem. (Eph. 6:4) E no easy for papa and mama to do this one for this world wey we dey. (2 Tim. 3:1-5) When dem born pikin, e no dey know wetin good and wetin bad. But e get conscience. So papa and mama need to dey correct am so that im conscience go dey work well. (Rom. 2:14, 15) One book talk sey the Greek word wey dem translate as “correction” fit mean “to train pikin.”

9 If papa and mama dey sofri correct their children, the children go feel sey their papa and mama love dem. Dem go know sey person get where e suppose do reach. And dem go still know sey good thing or bad thing dey come out of anything wey person do. E really good make papa and mama follow wetin Bible talk when dem dey train their children. People for different place get how dem think sey e good to train pikin. And as time dey go, wetin dem think about the matter fit change. But if papa and mama dey listen to Jehovah, dem no go try wetin dem think sey go work, and dem no go think sey dem go fit do am by theirself.

10 Noah example fit help us. When Jehovah tell Noah make e build ark, Noah no know how to build am because e never build ark before. So Noah do everything wey Jehovah tell am. (Gen. 6:22) Wetin e gain? The ark save Noah and im family! Noah na better papa wey help im family because e follow wetin God talk. E teach im children well, and e show dem good example. E no easy for am to do this one because the world bad well well that time.​—Gen. 6:5.

11. How papa and mama fit show their children better example?

11 How papa and mama go take do everything wey God talk like Noah? Na if dem dey listen to Jehovah and allow am to help dem train their pikin. Make dem dey follow wetin Bible and Jehovah organization talk. If dem do this things, their pikin fit thank dem later for how dem train am. One brother talk sey: “I like the way my papa and mama take train me. Dem do everything wey dem fit do to make wetin dem dey talk reach my heart. The main thing wey make me fit stand well for Jehovah side na how my papa and mama take train me.” Na true sey some children dey leave Jehovah even after their papa and mama don do everything wey dem fit do to help dem. But if the papa and mama don already try their best to help their pikin, their conscience no go worry dem. Instead, dem fit hope sey one day their pikin go come back to Jehovah.

12, 13. (a) Wetin papa and mama go do to show sey dem dey obey Jehovah if dem disfellowship their pikin? (b) Wetin one sister and im husband gain as dem follow wetin Jehovah talk?

12 E dey hard well well for some papa and mama to follow wetin Bible talk when dem disfellowship their pikin. E get one sister wey im pikin comot for house after dem disfellowship am. The sister sey: “I come dey look for excuse for our book dem so that I go fit spend time with my daughter and im pikin. But my husband sofri help me. E make me see sey the matter no dey our hand again, and we no suppose put hand inside.”

13 After some years, the pikin come back to Jehovah. The sister talk sey: “Now my daughter dey always call or send me message. And e dey respect me and im papa well well because we follow wetin Jehovah talk. We really near each other now.” If you get pikin wey dem disfellowship, you dey use “all your mind trust Jehovah”? You dey show am sey you “no put mind for wetin you think sey you sabi”? (Prov. 3:5, 6) Remember sey when God correct person, e show sey e love the person, and e dey show the kind sense wey God get. No forget sey Jehovah send im Son to die for everybody, and your pikin dey among dem. God want make everybody get life wey no go end. (Read 2 Peter 3:9.) So e good make you believe sey Jehovah dey correct person well. And make you ready to do wetin e talk even when e pain you. Make you dey use all your mind support Jehovah correction. No do wetin go show sey you no support am.

FOR CONGREGATION

14. How we take dey gain from the slave wey Jehovah dey use teach us?

14 Jehovah promise sey e go protect im people, take care of dem, and teach dem. And na different way e take dey do am. For example, e don put the congregation for im Son hand. And Jesus don choose the slave wey dem fit trust to dey teach us. (Luke 12:42) This slave get many way wey e take dey direct us, and correct us. You don ever hear something for talk, or see something for our book, wey make you change how you dey think and behave? Na better thing sey you follow wetin you learn! E show sey you dey allow Jehovah correct you.​—Prov. 2:1-5.

15, 16. (a) Wetin we go do to gain from the work wey elders dey do? (b) How we go take make elders enjoy their work?

15 Jesus still dey use elders to take care of Jehovah people. (Eph. 4:8, 11-13) Wetin we go do to gain from the work wey elders dey do? One way na to copy their faith and their better example. Another way na to follow the advice wey dem dey give us from Bible. (Read Hebrews 13:7, 17.) Remember sey elders love us and dem want make we near Jehovah. For example, dem dey quick help us when dem see sey we no dey come meeting like before. And if our mind no dey Jehovah work like before, dem go quick help us. Dem dey listen to us and dey tell us better word wey go help us. Dem still dey use Bible advice us. You dey see the work wey elders dey do as something wey dey show sey Jehovah love you?

16 Remember sey e fit no easy for elders to advice us. Just think about how e go don hard prophet Nathan to correct King David, wey try to cover the bad thing wey e do. (2 Sam. 12:1-14) When Peter wey be one of Jesus disciple dey favor brothers wey be Jew pass brothers wey no be Jew, apostle Paul correct am. Paul go don need strong mind to fit correct Peter. (Gal. 2:11-14) Wetin we fit do to make elders work easy? Dey carry body down, no dey make am hard for dem to talk to you, and dey show sey you value any advice wey dem give you. See the things wey dem dey do as something wey dey show sey Jehovah love you. If you do this one you go gain am, and e go make the elders happy as dem dey do their work.

17. How elders take help one sister?

17 E get one sister wey think sey Jehovah no love am, and e come dey hard am to love Jehovah. Na wetin don happen to am make am dey think like this. The sister sey: “My mind no settle because of wetin don happen to me and other wahala. I know sey I suppose go meet elders. So I come go meet dem, and when I dey talk to dem, dem no talk to me anyhow and dem no judge me. Dem tell me better word wey make me strong. And no matter how the elders dey busy reach, some of dem must ask me how I dey after meeting. Because of wetin don happen for my life, I dey feel sey God no go fit love person like me. But Jehovah don use elders and people for congregation to help me see sey e love me. E don do this one many times. I pray make I continue to hold Jehovah tight.”

WETIN PAIN PASS ANY CORRECTION?

18, 19. Wetin fit pain pass any correction wey dem give person? Give example.

18 Na true sey if dem correct person, e dey pain. But if person no take the correction wey dem give am, wetin fit happen to am na im dey pain pass. (Heb. 12:11) Make we talk about the example of Cain and King Zedekiah. When Cain want kill Abel because e hate am, God warn am sey: “Why you dey vex like that and why you no happy? If you start to do good thing, I no go show you favor? But if you no start to do good thing, sin dey door dey wait for you. The sin want control you, but you go fit control am?” (Gen. 4:6, 7) Cain no hear word. E allow sin control am. And e suffer from the bad thing wey e do. But if to sey e hear word, this kind thing for no happen to am. (Gen. 4:11, 12) If Cain take the correction wey Jehovah give am, e for no pain am reach the suffer wey e suffer because of wetin e do.

19 Zedekiah dey weak and na wicked king. Things no easy for Jerusalem when e dey rule. Prophet Jeremiah warn Zedekiah many times make e comot hand from bad thing, but e no take correction. And the things wey happen because of wetin e do, bad well well. (Jer. 52:8-11) Jehovah no want make we suffer like that.​—Read Isaiah 48:17, 18.

20. Wetin go happen to people wey take God correction and people wey no gree take am?

20 For this world, many people no like the correction wey God dey give. Dem no dey even like to control theirself, or correct theirself. But small time, anybody wey no take the correction wey God dey give am, go suffer put. (Prov. 1:24-31) So make we “listen to correction” so that we go “get sense.” Proverbs 4:13 talk sey: “Hold correction well, and no let am go. Keep am well because na your life.”

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share