Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w18 March pp. 23-27
  • Na Love Dey Make God Correct Us

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Na Love Dey Make God Correct Us
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • GOD DEY USE LOVE CORRECT US
  • JEHOVAH CORRECTION DEY HELP US
  • COPY JEHOVAH AND JESUS WHEN YOU DEY CORRECT PERSON
  • CORRECTION DEY PREPARE OUR MIND FOR PARADISE
  • “Listen to Correction Make You Get Sense”
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
  • Person Wey No Dey Use Im Power Well Go Lost Am
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
w18 March pp. 23-27
Flowerpot wey break; one woman dey correct im pikin

Na Love Dey Make God Correct Us

“Na person wey Jehovah love e dey correct.”​—HEB. 12:6.

SONG: 123, 86

HOW YOU GO TAKE ANSWER?

  • Wetin Shebna story teach you about how God take dey correct person?

  • How we fit copy Jehovah and Jesus when we dey correct person?

  • Wetin correction dey prepare us for?

1. Wetin Bible talk about correction?

FOR Bible, the word wey dem use for “correction” no only mean punishment. Correction na good thing. Sometimes, when Bible talk about correction, e talk other better things follow am like, better sense, love, and life. (Prov. 1:2-7; 4:11-13) So, when God dey correct person, e mean sey e love am and e want make e get life wey no go end. (Heb. 12:6) Sometimes, God fit use punishment take correct person. But e no dey use wicked mind do am, and e no dey overdo am. The truth be sey, the main thing wey correction mean na to teach person, the way papa and mama dey teach pikin wey dem love.

2, 3. Wetin show sey to teach person and to punish am na part of correction? (Check the first picture.)

2 Make we see one example: Imagine sey e get one small boy wey dey play ball inside house. Im mama come tell am sey: “You no know sey you no suppose play ball inside house? You fit break something.” But the pikin no hear word. E come still dey play the ball. By mistake, the ball come nack one flowerpot break. How you think sey im mama go correct am? E fit teach am sey wetin e do no good, and e fit add punishment join. E fit tell the pikin why e good make e dey hear word. E go explain to am sey na good thing e dey tell am, and sey e no go hard am to do. To make the pikin understand this one, e fit seize the ball for some time. Wetin the mama do go teach the pikin sey if person no obey, e fit get punishment.

3 All of us wey dey serve Jehovah, na part of im family. (1 Tim. 3:15) So Jehovah get the right to tell us wetin we go do. And e still dey use love correct us even when we no follow wetin e talk. But if bad thing come out of wetin we do, the way Jehovah go correct us go make us remember sey e good make we dey obey am. (Gal. 6:7) God love us well well, and e no want make we do wetin we go later regret.​—1 Pet. 5:6, 7.

4. (a) Which kind training Jehovah dey bless? (b) Which question we go answer for this topic?

4 When we dey use Bible take correct our pikin or Bible student, e fit help am become Jesus disciple. Na Bible be the main thing wey we dey use take teach people. We dey use Bible take “show person how e go take live the kind life wey God want.” And we fit use Bible take help our pikin or Bible student to ‘do everything wey Jesus command us.’ (2 Tim. 3:16; Matt. 28:19, 20) Jehovah dey bless this kind training. And this training go fit help dem train other people to become Jesus disciple. (Read Titus 2:11-14.) For this topic, we go answer this three important question: (1) How we take know sey na love dey make God correct us? (2) Wetin we fit learn from the people wey God correct? (3) How we go take copy Jehovah and Jesus example when we dey correct people?

GOD DEY USE LOVE CORRECT US

5. When Jehovah correct us, how this one take dey show sey e love us?

5 Na love dey make Jehovah correct us, teach us, and train us. Jehovah dey do this things because e want make we be im friend, and make we get life we no go end. (1 John 4:16) Jehovah no dey curse us or make us feel sey we dey useless. (Prov. 12:18) Instead, e dey put eye for the better character wey we get. And e still dey allow us choose wetin we want do, e no dey force us. E dey use Bible, our book dem, our papa and mama, and elders take correct us. You dey see this correction as something wey show sey Jehovah love you? Elders dey sofri use love correct us even before we know sey we don do wetin no good. This one dey show us sey the elders dey copy the kind love wey Jehovah get for us.​—Gal. 6:1.

6. If dem no allow person do some kind work for congregation again, how this one take show sey God love am?

6 Sometimes, correction fit pass to only advice person. If person do wetin bad well well, dem no go allow am do some kind work for congregation. This kind correction dey show sey Jehovah love the person. For example, the person fit come see sey e need to dey use more time study Bible, dey think about wetin e learn, and dey pray. All this things go make the person friendship with Jehovah strong. (Ps. 19:7) As time dey go, dem fit allow am to do the work wey e dey do before for congregation. When dem disfellowship person, this one still dey show us sey Jehovah love the congregation, because e no want make the bad person spoil other people. (1 Cor. 5:6, 7, 11) God dey correct us well, e no dey overdo am. So this one fit help the person wey dem disfellowship see sey wetin e do bad well well. And that one fit make am repent.​—Acts 3:19.

JEHOVAH CORRECTION DEY HELP US

7. Who be Shebna, and which bad character e later get?

7 We go talk about two people wey Jehovah correct. This one go help us see sey correction dey important. One of dem na Shebna wey live for King Hezekiah time. The other person na one brother wey im name na Graham. Shebna dey take care of somebody house. E be like sey na King Hezekiah house e dey take care of. So Shebna get better position. (Isa. 22:15) But e come start to dey carry shoulder, and e want make other people dey think sey e better pass dem. E come make one rich man grave for imself. And e come dey use chariot wey fine well well.​—Isa. 22:16-18.

One brother dey talk with two elders, e settle down dey think about wetin e read for Bible, and e go preaching

Jehovah go bless us if we carry body down and change our character (Check paragraph 8-10)

8. Wetin Jehovah do to correct Shebna, and wetin Shebna come do?

8 Jehovah remove Shebna from im position, because of im bad character. E come give im position to Eliakim. (Isa. 22:19-21) This thing happen around the time wey Sennacherib, wey be Assyria king, dey plan to attack Jerusalem. Sennacherib later send plenty soldier and some men wey get high position go Jerusalem. E do this one because e want make people for Jerusalem fear and make Hezekiah surrender. (2 Ki. 18:17-25) Hezekiah come send Eliakim to go talk with the people wey Assyria king send come. Shebna and another person still follow Eliakim go meet dem. That time, na secretary work Shebna come dey do. This one show sey Shebna go don carry body down. E no vex or carry wetin happen for mind. Instead, e sofri start to dey do the work wey dem give am, even though im position no come high as before. Make we see the three things wey we fit learn from Shebna example.

9-11. (a) Wetin be the better things wey we fit learn from Shebna story? (b) Wetin you like about how Jehovah treat Shebna?

9 The first thing wey we learn be sey “to carry shoulder up dey wound person, and na person wey dey carry body dey fall.” (Prov. 16:18) And na wetin happen to Shebna be that as dem comot am from im position. You fit get some kind work for congregation, and this one fit make other people dey respect you. But you go continue to dey carry body down? If people praise you for anything wey you sabi do, or for any good thing wey you do, you dey show sey na Jehovah help you fit do am? (1 Cor. 4:7) Apostle Paul talk sey make we no dey think about ourself pass as we suppose think, but make we dey use better mind think.​—Rom. 12:3.

10 The correction wey Jehovah give Shebna strong. E fit be sey Jehovah see Shebna as person wey go fit change, na im make am correct am like that. This na the second thing wey we learn. (Prov. 3:11, 12) This na better example for people wey dem remove work from their hand for congregation. Instead of the person to dey vex or carry the matter for mind, make e continue to use all im mind do things wey e fit do for Jehovah. Make e see the correction as something wey show sey Jehovah love am. Get am for mind sey, if we carry body down, Jehovah go see us as person wey fit change. (Read 1 Peter 5:6, 7.) Jehovah dey use love correct us. If we dey carry body down, and be like soft clay for Jehovah hand, im correction go help us.

11 The third thing wey we fit learn from Shebna story na how Jehovah take treat am. This na better example for people like, elders, and papa and mama wey Jehovah don give the right to correct people. Wetin dem fit learn from Jehovah example? Na true sey Jehovah hate sin, but im correction still dey show sey e love the person wey sin. Elders fit no like the bad thing wey person do, and papa or mama fit no like the bad thing wey their pikin do. But e good make dem copy Jehovah example when dem want correct am. Make dem still put eye for the better character wey the person get.​—Jude 22, 23.

12-14. (a) Wetin some people dey do when Jehovah correct dem? (b) How Bible take help one brother change im character, and wetin come happen?

12 When dem correct some people, e dey pain dem sotey dem go leave Jehovah and im people. When this kind thing happen, belle no dey sweet us. (Heb. 3:12, 13) But this one mean sey hope no dey for this kind people? No! Make we talk about one brother wey dem disfellowship. Im name na Graham, and dem later bring am come back. But after some time, e come stop to dey go meeting and preaching. E get one elder wey try to draw body near Graham. Later, Graham tell this brother make e dey study with am.

13 The elder remember wetin happen. E sey: “Graham dey carry shoulder. Na im problem be that. E dey talk bad about the elders wey handle im matter, wey make dem come disfellowship am. So we come dey look wetin Bible talk about why e no good to carry shoulder, and wetin e dey cause. We do this one for some time when I dey study am. Bible come dey help Graham see the kind person wey e be, and e no like wetin e see! Wetin e learn really touch am! E come see sey e dey carry shoulder. And e come know sey im problem na how e dey see the matter. E start to change, e no waste time. E come dey go meeting everytime, dey settle down study Bible, and dey pray everyday. E come dey help im family near Jehovah as papa suppose do. This one really make im wife and children happy.”​—Luke 6:41, 42; Jas. 1:23-25.

14 The elder wey help Graham still talk sey: “E get one day wey Graham talk wetin touch my heart. E sey, ‘E don tey wey I dey serve Jehovah. I don even pioneer before. But na now I fit really talk sey I love Jehovah.’ E no tey, dem come allow Graham dey handle microphone for meeting. E like this work no be small. Graham story make me see sey, if person carry body down, and allow Jehovah correct am, Jehovah go just dey bless am!”

COPY JEHOVAH AND JESUS WHEN YOU DEY CORRECT PERSON

15. If we want correct people and we want make e reach their heart, wetin we go do?

15 Person need to first learn well before e go fit teach well. (1 Tim. 4:15, 16) Na so e still be if you dey among people wey Jehovah dey use give correction. You must ready to carry yourself down and allow Jehovah direct you. If you dey carry body down, e go make people dey respect you. And e go help you get free mind when you dey correct people or train dem. Make we talk about wetin we fit learn from Jesus example.

16. Wetin we fit learn from the way Jesus correct people and teach dem?

16 Jesus obey im Father, even when e hard am well well. (Matt. 26:39) Jesus make people know sey na im Father tell am the things wey e dey teach people, and na im still give am the sense wey e get. (John 5:19, 30) E carry body down and e follow wetin God talk. Na this one make am dey pity people and teach dem well. Na this character make people wey get better mind dey near am. (Read Luke 4:22.) The things wey Jesus talk help people wey no happy and people wey need help. (Matt. 12:20) Even when people do wetin for make Jesus vex, e still get better mind for dem and e love dem. For example, when im disciples dey argue about who big pass among dem, Jesus sofri correct dem.​—Mark 9:33-37; Luke 22:24-27.

17. Which better character go help elders take care of Jehovah sheep well?

17 E good make elders dey follow Jesus example when dem dey use Bible correct person. This one go show sey dem ready to allow God and Jesus direct dem. Apostle Peter talk sey make elders take care of ‘God sheep wey dey their hand.’ Make dem no dey do their work like sey person dey force dem, or because of wetin dem want gain. But make dem dey use free mind do the work, and make e dey hungry dem to do am. Peter still talk sey make dem ‘no dey carry theirself as oga for the people wey be God property, but make dem be example for all the sheep.’ (1 Pet. 5:2-4) When elders dey use all their mind follow wetin God and Jesus talk, both dem and the people wey dem dey take care of go get better gain.​—Isa. 32:1, 2, 17, 18.

18. (a) Wetin Jehovah want make papa and mama do? (b) How Jehovah take dey help papa and mama do their work well?

18 Wetin e good make papa and mama dey do when dem dey train their pikin and correct dem? Bible sey: “Make una no dey make una pikin vex, but make una dey use Jehovah way correct dem and dey teach dem.” (Eph. 6:4) How this matter serious reach? Proverbs 19:18 tell us the answer. E sey: “Correct your pikin when hope still dey, make e no come be sey na you kill am.” This one mean sey Jehovah go hold papa and mama, if dem no correct their pikin well! (1 Sam. 3:12-14) Jehovah ready to give papa and mama the sense and power wey dem need to help their pikin. But dem need to dey pray to am, dey follow wetin Bible talk, and allow im spirit direct dem.​—Read James 1:5.

CORRECTION DEY PREPARE OUR MIND FOR PARADISE

19, 20. (a) Wetin we go gain if we dey allow Jehovah correct us? (b) Wetin we go learn for the next topic?

19 We go gain well well if we allow Jehovah correct us, and if we follow im and Jesus example when we dey correct other people. Mouth no go fit talk all the blessing wey we go get. E go make peace dey our family and congregation. E go make people know sey we love dem, we value dem, and their mind go come down. This one na just small part of the blessing wey we go get for front. (Ps. 72:7) So we fit talk sey Jehovah correction dey prepare our mind for the kind peace and one mind wey we go enjoy for paradise. (Read Isaiah 11:9.) If we get this one for mind, we go see correction as better way wey Jehovah take dey show us sey e love us well well.

20 For the next topic, we go learn more about the correction wey dem dey give person for family and congregation. We go still talk about how we go take dey correct ourself. And we go see wetin we fit do to run from wetin dey pain person pass any correction.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share