BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | JOB 16-20
Talk Wetin Go Make People Strong for Mind, Mek Dem Fit Do More
E good mek person wey dey give people advice use word wey go make dem strong
16:4, 5
Job dey suffer, e no happy and e dey feel strong pain. Wetin e need na mek people come support am and tell am wetin go make im mind strong
The three friend wey Job get blame am for many many things. The things wey dem talk add join im problem. Dem no talk anything wey go help Job mek im mind strong
When Job dey for wahala, wetin Bildad tell am spoil im mind well well, and e even make am cry
19:2, 25
Job beg God for different things to help am comot from the plenty wahala wey e dey face. E even beg God sey e want die
Job get am for mind sey even if e die, e go fit come life again. This one make am mek e fit bear the wahala and mek e no stop to dey serve God