Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 April p. 2
  • New Way to Take Start to Dey Preach

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • New Way to Take Start to Dey Preach
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • HOW YOU GO TAKE USE THIS NEW WAY:
  • Example Wey You Fit Use
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2018
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 April p. 2

MEK WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

New Way to Take Start to Dey Preach

Flower on top grave

Na since January 2016 the back of The Watchtower wey we dey use preach don get one new way wey we fit follow. The topic na “What Does the Bible Say?” Dem arrange am to help us know how we go start if we want follow person talk about Bible matter. The way wey dem arrange am just be like the way wey dem arrange our tract. E get one question wey go make the person talk wetin dey im mind. After the question, dem write where the answer dey for inside Bible, and other things still dey there wey we go fit talk about.

Many times, if you dey follow people talk Bible matter, e fit make dem want start to dey study Bible. Use this new way to help many many people learn about God. ​—⁠Mt 5:⁠6.

HOW YOU GO TAKE USE THIS NEW WAY:

  1. Ask the person wetin e think about one of the question

  2. Hear wetin e go talk and tell am sey e do well

  3. Read the Bible wey dem write under the topic wey be “What the Bible Says,” and ask am wetin e think about the place wey e read for Bible. If e still get time, talk about one of the things wey dem write under “What Else Can We Learn From the Bible?”

  4. Give am the magazine

  5. Arrange with am sey you go come back mek una fit talk about the second question

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share