Pioneers dey preach for Tzotzil language for Chiapas, Mexico
Example Wey You Fit Follow
THE WATCHTOWER
Question wey you go ask: If person ask you sey how heaven be, wetin you go talk?
Bible wey you go read: Joh 8:23
How you go give am: This Watchtower talk about wetin Jesus and im Father don tell us about heaven.
TEACH THE TRUTH
Question wey you go ask: You gree sey wetin Bible talk for here don dey happen now?
Bible wey you go read: 2Ti 3:1-5
Truth: As e be sey wetin Bible talk tey tey don dey happen now, we fit still trust am sey wetin e talk about better tomorrow go happen.
WHY E GOOD MAKE WE LEARN BIBLE? (Video)
Wetin you go first talk: We dey show people one short video wey talk about where we fit get answer to many question wey dey worry us for mind. [Play the video.]
How you go give am: This book show us wetin Bible talk about how God go comot all the problem wey dey this world. [Give am Bible Teach or Teach Us book.]
WRITE AS YOU GO DO YOUR OWN
Use the way dem write the example for here take write as you go do your own when go preach