Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 November p. 3
  • Bible Talk About Woman Wey Be Better Wife

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Bible Talk About Woman Wey Be Better Wife
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • Similar Material
  • ‘Dem Know Im Husband Well Well for All the Gate Wey Dey the City’
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • You Fit Make Your Family Happy
    Wetin Bible Dey Teach Us?
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 November p. 3

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PROVERBS 27-31

Bible Talk About Woman Wey Be Better Wife

Proverbs chapter 31 get strong message wey King Lemuel mama tell am. The better advice from im mama help am know how e go take sabi better wife.

Better wife na person wey you fit trust

One woman for Bible time dey give im family food

31:10-12

  • When dem want choose wetin their family go do, e dey bring better idea and e dey support wetin im husband choose

  • Im husband dey trust anything wey e choose to do, e no dey talk sey im wife must tell am everything before e do am

Better wife dey work hard

One woman for Bible time dey grind something

31:13-27

  • E sabi manage things and e dey live simple life so that im family go fit wear better cloth, and see food chop

  • E dey work hard and e dey take care of im family everytime

Better wife like to dey serve God well

One woman dey pray

31:30

  • E dey serve God well and e get better friendship with God

YOU KNOW?

For Bible time, people really value red coral. E fine well well, dem no dey quick see am, and you go really work to fit get am. Na for inside Red sea and Mediterranean sea dem dey see am, people wey dey do business dey use am make money well well.

Red coral

For inside Bible, dem put coral, gold, silver and sapphire for the same class, this one show the kind value wey coral get.

Bible talk sey the value wey better wife get ‘better pass coral.’​—Pr 31:10.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share