BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | ISAIAH 17-23
Person Wey No Dey Use Im Power Well Go Lost Am
Shebna na the main person wey dey ‘in charge of the house,’ e be like sey na King Hezekiah house. Im level high well well because na im be the next person after the king. That one mean sey plenty work dey im hand.
22:15, 16
Shebna suppose take care of wetin Jehovah people need
But e just dey do wetin go make people dey praise am
22:20-22
Jehovah comot Shebna for that position come put Eliakim for there
Dem come give Eliakim ‘the key for David house,’ and that one mean sey power don dey im hand
Think am: That time wey power still dey Shebna hand, how e for use am help other people?