Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb17 June p. 7
  • No Take Jehovah Law Play at All!

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • No Take Jehovah Law Play at All!
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
  • Similar Material
  • Praise Jehovah With the Way You Dey Dress
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • You Dey Let Jehovah Direct You?
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
  • Why We Dey Wear Better Cloth Go Our Meeting?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
mwb17 June p. 7

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

No Take Jehovah Law Play at All!

Jehovah give us law wey go help us live clean life. For example, e give law about marriage. E sey marriage na wetin go join husband and wife together for all their life. (Mt 19:4-6, 9) Jehovah no want make we put hand for any sex matter wey no clean for im eye. (1Co 6:9, 10) God give im people many advice wey go make dem different from other people with the way dem dey dress.​—De 22:5; 1Ti 2:9, 10.

Many people today no dey do things the way Jehovah want am. (Ro 1:18-32) Dem dey allow wetin dey reign affect the way wey dem take dey dress and how dem dey do things. Many people dey use the bad things wey dem dey do take dey make mouth, and dem dey use people wey no dey live that kind life take dey do yeye.​—1Pe 4:3, 4.

As people wey dey serve Jehovah, we must use all our mind stand for wetin Jehovah like. (Ro 12:9) How? We go dey tell people wetin God want with respect, and we go dey do wetin we dey tell people. For example, when we want buy cloth or do hair, make we ask ourself sey: ‘This one wey I want choose go show sey I dey support God or this world? The way I take dey dress or do my hair dey show sey I be Jehovah servant?’ Or when we want choose the kind film, music or book wey we go read or watch, make we ask ourself sey: ‘This kind film or book go make Jehovah happy? Which person side e dey show sey I dey? The one wey I choose go make me dey like wetin Jehovah hate?’ (Ps 101:3) How e go take affect my family member or other people?​—1Co 10:31-33.

Why e good make we dey live our life the way God want? Na because Jesus go soon destroy all the people wey no gree do wetin Jehovah want. (Eze 9:4-7) Na only the people wey dey do wetin Jehovah want go save. (1Jo 2:15-17) So make we dey use all our mind do wetin Jehovah want so that people wey dey look us go fit praise Jehovah.​—1Pe 2:11, 12.

One woman dey select cloth wey e want buy

Wetin the kind cloth wey I dey wear and my hair style dey show about me?

WATCH THIS VIDEO: MAKE YOU BE JEHOVAH FRIEND​—⁠ONE MAN, ONE WOMAN. AFTER, MAKE UNA ANSWER ALL THIS QUESTION:

  • Why e good make we dey follow how Jehovah want make we dey live our life?

  • Why e good make papa and mama teach their children wetin Jehovah want from small pikin?

  • Wetin young and old people fit do to help other people gain from the better better things wey God dey do?

WETIN YOU GO TALK . . .

  • If person ask you sey: “Na better thing for man to sleep with man or for woman to sleep with woman?”

  • If person tell you sey: “Wetin Bible talk about this matter too harsh.”

  • If person tell you sey: “Man wey dey like sleep with man or woman wey dey like to sleep with woman no go fit change, because na blood e dey.”

(yp1 chap. 23; yp2 chap. 28)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share