Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb18 February p. 4
  • “Honor Your Papa and Your Mama”

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • “Honor Your Papa and Your Mama”
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2018
  • Similar Material
  • Who We Go Respect and Praise?
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2018
mwb18 February p. 4

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

“Honor Your Papa and Your Mama”

When Jesus dey this earth, e talk about this command wey sey: “Honor your papa and mama.” (Ex 20:12; Mt 15:4) Jesus fit give this advice because when e dey young, “e no stop to dey respect” im papa and mama. (Lu 2:51, ftn.) Even before e die, e arrange make one of im disciple take care of im mama.​—Joh 19:26, 27.

Today, young people wey dey serve Jehovah dey show sey dem honor their papa and mama, when dem dey obey dem and talk to dem with respect. This command no get time wey e go expire. Even when our papa and mama don old, make we still dey listen to dem. This one go show sey we dey honor dem, and na we go gain. (Pr 23:22) We go still show sey we dey honor our papa and mama, if we dey spend time with dem, and dey give dem wetin dem need to take care of theirself. (1Ti 5:8) Whether we still small or we don grow, we go show sey we dey honor our papa and our mama when we dey talk to dem well.

WATCH THIS WHITEBOARD CARTOON: HOW I FIT TALK TO MY PAPA AND MAMA? AFTER, MAKE UNA ANSWER THIS QUESTION:

  • Wetin fit make am hard you to talk to your papa and mama?

  • How you fit show sey you dey honor your papa and mama when you dey talk to dem?

    One boy dey write letter to im papa and mama, dey tell im papa and mama something, and dey play ball with im papa
  • Why e good make you dey talk to your papa and mama? (Pr 15:22)

    Papa and mama dey help their pikin so that e go fit handle wahala wey fit come for front

    You go fit live better life if you dey talk to your papa and mama

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share