SONG 32
Dey Jehovah Side!
(Exodus 32:26)
1. One time we no know wetin we go do.
People dey talk wetin no dey Bible.
But when we learn the truth, we come get hope.
This hope come give us strong faith.
(CHORUS)
Tell people about God, Sey freedom dey come.
Do wetin God tell you, No ever leave am.
E sey e go help you, If you dey im side.
Use all your heart serve am, E no go leave you.
2. We go dey preach sey God Kingdom dey come.
We no go tire, na God dey our back.
If you know sey you dey Jehovah side,
Time don reach make you prove am.
(CHORUS)
Tell people about God, Sey freedom dey come.
Do wetin God tell you, No ever leave am.
E sey e go help you, If you dey im side.
Use all your heart serve am, E no go leave you.
3. Satan fit shake us, e fit suffer us.
People dey fight us, dem plenty pass us.
God dey support us, our mind no go shake.
We no dey fear anything.
(CHORUS)
Tell people about God, Sey freedom dey come.
Do wetin God tell you, No ever leave am.
E sey e go help you, If you dey im side.
Use all your heart serve am, E no go leave you.
(Still check Ps. 94:14; Prov. 3:5, 6; Heb. 13:5.)